Blog masonry

Background

Sports

Tottenham Hotspur Sack Igor Tudor Afta 7 Games

By: Esther Ayoola Tottenham Hotspur don comot dia coachie Igor Tudor afta di both of dem agree to terminate im contract Asap. Tudor manage dem only for seven matches, lose five, wey make Spurs dey struggle and just one point above relegation zone for Premier League. Dem also don drop out from Champions League race as results no dey favor dem at all. Club tuk say na mutual agreement, but e hapun afta dem lose 3-0 to Nottingham Forest and […]

todayMarch 30, 2026 13

Sports

CAF Increase Africa Cup Of Nations To 28 Teams

By: Esther Ayoola CAF Presido, Patrice Motsepe, say like dis now, say dem wan increase di Africa Cup of Nations teams from 24 to 28 wey go dey play di AFCON. E tuk dis one for press conference on Sunday afta CAF executive committee meeting for Africa, say di change na to turn Africa football to  world-class football. Motsepe nor explain how di tournament go fit take di extra four teams or when di new format go start. Before now, […]

todayMarch 30, 2026 14

Sports

NPFL Match Day 32, Niger, Ikorodu, Bayelsa, Rivers Collobi Big Wins

By: Esther Ayoola Na correct football action happen for NPFL Match Day 32 on Sunday. Niger Tornadoes knack Wikki Tourists 2-0, while Ikorodu City shock Warri Wolves 4-3. Bayelsa United crush Kano Pillars 4-1, and Rivers United waka pass Kun Khalifat 4-2. Some games end draw, like El-Kanemi Warriors 1-1 Remo Stars, Barau FC 0-0 Katsina United, and Bendel Insurance 2-2 Plateau United.

todayMarch 30, 2026 13

Sports

Ikorodu City FC Survive Late Comback, Beat Warri Wolves 4–3

By: Esther Ayoola Ikorodu City FC collobi beta 4–3 winners against Warri Wolves FC for NPFL Match Day 32 putting pressure for di title race. Abayomi Ayodeji nah im open di scoring for 8th minute, Joseph Arumala add another, but Warri Wolves begin chase di game very early. Ikorodu City sti score own goal and Tosin Oyedokun make am 4–2 before Wolves finish with late goal for 94th minute. Coach Bright Ozadegbe sha praise im players, say dem show Korrect […]

todayMarch 30, 2026 13

obodo oyinbo

Former Venezuela Presido Maduro Thank Fans, Do First Post From Prison

By: Esther Ayoola Former Venezuela presido, Nicolas Maduro and im wife Cilia Flores don tuk for di first time for U.S prison say dem dey strong, calm, and dey pray inside Brooklyn prison. For a message wey dem share for Maduro’s X account, dem thank supporters for prayers and dia support. News source close to Venezuelan gornment say, Maduro dey read Bible every day, and im fellow prisoners sti dey call am “presido,”. Maduro sha explain dat im na “prisoner […]

todayMarch 30, 2026 11

obodo oyinbo

Pope Leo XIV Explain Why God No Go Hear Di Prayers Of Those Wey Dey Cause War

By: Esther Ayoola Pope Leo XIV don cut chain oh, say, God nor go hear di prayers of pipo wey dey cause war, problem left, right and centre. Di Pop yarn dis one after di Angelus prayer, E pray for Christians for Middle East wey dey suffer because of the fight and no fit celebrate dia holy days. Earlier this week, im ask make all sides stop di war and begin tuk, as more than one million pipo dey homeless […]

todayMarch 30, 2026 13

obodo oyinbo

Trump Say Im Go Grab Iran Oil As Gulf Leaders Dey Try Cool Tension

By: Esther Ayoola Donald Trump don change am for Iran say, e wan “take di oil for Iran,” as Iran dey accuse US say, dem dey plan ground attack, while peace tuk dey go on. Say Iran attack one power and water plant, kpai one Indian worker, and say, Gulf countries dey intercept drones and missiles every day. US and Israel hit one petrochemical plant for Tabriz, cut power for parts of Tehran, and Iran fire back for one industrial […]

todayMarch 30, 2026 16

National

SSANU Blow Hot, Give FG One-Month Ultimatum To Settle University Wahala

By: Esther Ayoola Senior Staff Association of Nigerian Universities (SSANU) don warn Federal Gornment say dem no go gree again if dem continue to delay agreement on labour mata. Dis dey sup for meeting wey dem hold for Ekiti State University from March 26 to 27, 2026, dem say, di slow tuk, tuk between gornment and non-teaching staff dey very bad. SSANU presido, Muhammad Ibrahim, in fact say, plenty tuks without result don tire dem and e no suppose continue […]

todayMarch 30, 2026 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds