Blog masonry

Background

Sports

Messi Finally Talk After Spain Beat Argentina for World Cup Final

By: Esther Daniel Argentina captain Lionel Messi don finally tuk after Argentina lose 1-0 to Spain for diĀ 2026 FIFA World Cup final wey happen for United States on Sunday. Messi post im reaction online on Monday, after e no talk to journalists immediately after di match. Di Inter Miami star admit say di defeat pain well-well and e go hard to forget, but e still praise im teammates for di journey wey dem make reach di final. Spain carry dia […]

todayJuly 21, 2026 29

obodo oyinbo

North Korea Stand Gidigba With Russia Over Ukraine War

  By : Jolayemi Olajide North Korea don konfam say e still dey support Russia for di Ukraine war after di foreign ministers of both countries meet for Moscow, according to state media on Tuesday. Since Russia begin full-scale invasion of Ukraine for early 2022, North Korea and Russia don strengthen dia relationship despite international pressure. Reports say Pyongyang don send soldiers and weapons go help Russia, while Moscow dey provide financial support, food, energy supply and military technology in […]

todayJuly 21, 2026 15

Sport Yarns

Ā Super Falcons Camp Don Swell As Three More Stars Land

By : Jolayemi Olajide Esther Okoronkwo, Michelle Alozie and Uchenna Kanu don join Super Falcons camp for Casablanca as di team dey step up preparation for dia next competition. Di arrival of di three players don make di number of footballers for camp reach 22, while Gift Monday, Deborah Abiodun and Folashade Ijamilusi dey expected to join later today. Di Super Falcons begin dia final preparation since last Monday, and coach Justine Madugu go lead di team travel go Rabat […]

todayJuly 21, 2026 16

OBODO NAIJA

Tinubu Don Approve New Army Battalion for Kwara

By: Esther Daniel Oga Bola Tinubu don gree make Nigerian Army open new battalion for Omu Aran, Irepodun Local Government Area of Kwara State to help fight bandits, kidnappers, terrorists and oda criminals. Kwara State Govnor, AbdulRahman AbdulRazaq, make di announcement on Tuesday through im Deputy Chief Press Secretary, Mashood Agboola. According to di govnor, di new battalion go bring more soldiers and military equipment come di area to improve security, especially for communities wey kidnappers and bandits don dey […]

todayJuly 21, 2026 13

Sport Yarns

Ā Zidane Don Agree To Coach France Till 2030

By : Jolayemi Olajide French football legend Zinedine Zidane don reportedly sign deal to become di new head coach of France national team until June 2030, according to transfer expert Fabrizio Romano. Romano announce di development on Tuesday, saying Zidane go officially appear as France coach within di next few days. If di appointment go through as reported, di former Real Madrid manager go lead France for di 2027 UEFA Nations League, Euro 2028 and di 2030 FIFA World Cup. […]

todayJuly 21, 2026 13

Politics

Ā Kwankwaso Say Obi Sign One-Term Agreement

By : Jolayemi Olajide Vice-presidential candidate of National Democratic Congress, Rabiu Kwankwaso, don confirm say im and presidential candidate Peter Obi sign written agreement wey say Obi go serve only one four-year term if dem win di 2027 presidential election. Kwankwaso tok dis one on Monday during one siddon-tuk, saying e believe Obi no go break di promise because di agreement no be ordinary mouth talk. According to am, dem put di agreement for paper, with one document for di […]

todayJuly 21, 2026 36

Lagos

Ā Lagos PDP Deny Tinubu 2027 Endorsement

By : Jolayemi Olajide Lagos State chapter of Peoples Democratic Party, PDP, don deny report wey claim say di party don endorse Presido Bola Tinubu and im administration ahead of di 2027 general election. Di party tok dis one for statement wey im Publicity Secretary, Christopher Odianarewo, release on Tuesday, saying di report na false and Nigerians make dem ignore am. According to PDP, Presido Tinubu no be member of di party, and dem never support am, im government or […]

todayJuly 21, 2026 17

obodo oyinbo

Trump Slam 50% Tariff on Canada Goods, Trade Wahala Deepen

By: Esther Daniel US Presido Donald Trump don announce 50 percent tariff on plenty goods wey dey come from Canada, say na because Canada no dey treat American cars, dairy products and alcohol fairly. Di new tariff go affect items like wine, hockey sticks and cement, but energy, critical minerals, potash and fish no go join. Di announcement come on Tuesday, and di White House say di new import duty go start in 30 days. Canada Prime Minister Mark Carney […]

todayJuly 21, 2026 23

OBODO NAIJA

FCT Police Boss Warn: No Gree Make Police Search Your Phone

By: Esther Daniel Di Commissioner of Police for Federal Capital Territory (FCT), CP Ahmed Sanusi, don tell residents, especially young people, make dem no allow any police officer search dia phone during stop-and-search operations. E give di warning on Tuesday during one press conference. According to am, di Inspector-General of Police don already ban random phone searches because some officers dey abuse di practice to extort people. Sanusi say no police officer or any security agency get right to search […]

todayJuly 21, 2026 24

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

Ā 

listen with your app

This will close in 0 seconds