Blog masonry

Background

Sports

D’Tigress To Jam Indiana Fever For Big USA Preseason Game May 2

By: Esther Ayoola Naija women basketball team, D’Tigress, don add one big game for dia USA tour as dem go play against Indiana Fever for preseason. Di game go hapun for May 2, 2026, for Gainbridge Fieldhouse, Indianapolis, as dem dey prepare for 2026 FIBA Women’s Basketball World Cup. Team Naija announce di new fixture for X, say dem don already get game for San Diego and Kansas City before dis one.

todayMarch 27, 2026 16

Sports

Senegal To Parade AFCON Trophy For Paris

By: Esther Ayoola Say like dis, Senegal dey plan show dia Africa Cup of Nations trophy before dia game wey dem go play against Peru for Paris on Saturday. Dis na according to head of Senegal Football Federation, Papa Amadou Diop. Nor be amebo say, Di Teranga lions win dia second Afcon trophy on 18 January afta dem beat Morocco 1-0 for Morocco, but di win, issue full am based on say Senegal players waka comot when Morocco get stoppage-time […]

todayMarch 27, 2026 10

obodo oyinbo

Trump Hold Back Iran Attack Say Peace Tuk Dey Go Well

By: Esther Ayoola US Presido, Donald Trump say like dis now, e go delay attack for Iran energy plant, by 10 days, reach April 6, and dat, di peace tuk dey go well. However, ogas for Iran dey yan newspipo say, US peace plan, dey one-sideded and e nor fair. Pakistan Foreign Minister Ishaq Dar say dem tanda for centre dey tuk to U.S. and Iran, to try stop di war, and Turkiye plus Egypt dey help too. According to […]

todayMarch 27, 2026 17

obodo oyinbo

Iran Allow 10 Oil Tankers Pass Strait Of Hormuz

By: Esther Ayoola US Presido Donald Trump tuk on Thursday for Washington say Iran don allow 10 oil tankers pass Strait of Hormuz. Trump tuk for im truth social say dis na “gift” from Iran to show dia seriousness about negotiations to stop di war, wey don dey go on for nearly four weeks now. Di tankers, wey Trump say fit be Pakistani-flagged, travel di strait of Hormuz wey don close since Iran, Isreal and U.S gbege start for di […]

todayMarch 27, 2026 11

obodo oyinbo

UN Vote Say Slave Trade Na Biggest Crime In History

By: Esther Ayoola Yesterday for UN headquarters for New York, UN General Assembly vote say, transatlantic African slave trade na “di biggest crime against humanity.” Ghana propose di motion, and 123 countries gree to am. USA, Israel, and Argentina oppose di vote, while UK and all 27 EU countries watch hand comot. Untop yarnings with tori pipo afta di meeting,  Ghana Presido, John Mahama tell reporters say e dey support di vote and push for slavery reparations (dat is making […]

todayMarch 27, 2026 18

Sports

Wunjury Drop Bassey Out Of Super Eagles Friendly Matches

Calvin Bassey don drop out of Super Eagles friendly matches against Iran and Jordan after injury stop am ahead of games wey go start dis weekend. According to report, di Fulham defender get back injury after im strong performance for AFCON 2025 for Morocco in January. Team officials confirm say all 22 invited players don arrive camp, as dem start first training on Wednesday evening. Meanwhile, captain Wilfred Ndidi arrival complete di squad, as coach dey prepare team for di […]

todayMarch 26, 2026 13

obodo oyinbo

Iran Dey Fear To Admit Say Dem Want Peace Deal- Trump Yarn

Donald Trump talk on Wednesday for Republican lawmakers dinner for Washington DC say Iran dey secretly negotiate peace deal with di United States. Trump claim say even though Abbas Araghchi don earlier deny talks, Iranian officials still dey find way to make agreement. According to am, dem no dey admit am publicly because dem fear say their own people or even US fit harm dem. Di statement come as tension still dey between both countries, with talks aimed at reducing […]

todayMarch 26, 2026 19

OBODO NAIJA

Troops Gbab 98 Illegal Miners For FCT

Troops of 176 Guards Battalion arrest 98 people wey dey do illegal mining for Gwagwalada Area Council, FCT on March 23. Zagazola Makama post for X say di raid happen around 5:55 p.m. after intelligence show illegal mining dey go on for di area. Troops storm di site, catch di suspects without wahala, and recover vehicle, motorcycles, pumping machines, shovels, sledgehammers, and other mining tools. Di arrested miners don hand over to Guards Brigade Provost Group for further investigation and […]

todayMarch 26, 2026 18

OBODO NAIJA

How Women Form Vigilante Team For Plateau State

Some group of women based on gbege for area for Jos don form vigilante group as jaguda boys no allow dem drink water keep cup dey patrol streets for night. Di group oga, Blessing Ngozi Emmanuel, ni yan pipo dis update on Wednesday, on how e take dey do dem for di Jos. She press tuks on how both Christian and Muslim women take dey do collabo, sacrifice dia comfort to protect dia children and communities. According to her, di […]

todayMarch 26, 2026 19

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds