Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

Benjamin Kalu Office Deny N1bn Church Instrument Budget Tori

By: Esther Daniel Nor be small tin, na everyday money dey vanish, like dis Office of Deputy Speaker of House of Representatives, Benjamin Kalu, don deny report, which be say dem N1 billion for 2026 budget for music instrument, say na fat lie. For statement wey Chief Press Secreto Levinus Nwabughiogu release on Wednesday, di office tok say di report na anyhow, yamayam tuk. According to di statement, di actual allocation na N780 million after VAT and oda tax deductions, […]

todayJuly 22, 2026 24

obodo oyinbo

Fresh US attack make Tehran air defence spring into action

By : Jolayemi Olajide Fresh US strikes don trigger air defence for Tehran on Wednesday after President Donald Trump warn say e never finish with di war against Iran. US forces attack military logistics targets across Iran after fighting around Strait of Hormuz scatter earlier peace agreement and make di Middle East conflict worse. US top diplomat Marco Rubio, wey speak for ministers meeting for Manila, say America still ready for diplomacy but accuse Iran of not taking negotiations seriously. […]

todayJuly 22, 2026 18

obodo oyinbo

Traore warn say nobody fit challenge im power for Burkina Faso

By : Jolayemi Olajide Burkina Faso military leader Ibrahim Traore don warn say nobody fit lead di country apart from am, as e dismiss rumour of power struggle inside di junta on Thursday for Ouahigouya. Traore tok dis for news statement say "two capons nor fit dey for di same boat. According to Traore, any person wey im go catch do nonsense go face di music. Rumours of infighting start after two top junta officials, Oumarou Yabre and Farouk Azaria […]

todayJuly 22, 2026 20

Entertainment

Mo Bimpe threaten legal action over fake paternity rumour

By : Jolayemi Olajide Nollywood actress Mo Bimpe don threaten legal action after one X user post fake claim on Tuesday say her husband, Lateef Adedimeji, file for divorce over alleged paternity issue. Di X user allege say hospital reject Lateef blood donation for one of dia triplets before DNA test supposedly show say e no be di biological father. Mo Bimpe react for her Instagram Story, describe di report as fake and warn online trolls against spreading false information. […]

todayJuly 22, 2026 22

Entertainment

Falz clear air say e never support any politician 

By : Jolayemi Olajide Nigerian rapper Falz don clear di air on Tuesday say e never openly support Peter Obi or any politician, as e yarn for siddun tuk. Falz say people get am wrong because all along na to encourage Nigerians, especially youths, make dem come out vote naim e dey do. Di singer explain say e believe for free and fair elections and no wan tie himself to any political party or candidate. Falz still urge Nigerians to […]

todayJuly 22, 2026 11

OBODO NAIJA

IGP Disu Warn Police Bosses Against Illegal Detention

By: Esther Daniel Inspector-General of Police, Olatunji Disu, don warn Commissioners of Police across Nigeria make dem stop illegal detention of suspects, abuse of office and any form of misconduct. Di IGP give di warning during meeting wit Police Strategic Managers for Goodluck Ebele Jonathan Peacekeeping Hall for Abuja, where e remind police commanders say discipline and professionalism must remain top priority. Disu tuk say Commissioners of Police get responsibility to respect human rights, follow confirm process and build public […]

todayJuly 22, 2026 19

OBODO NAIJA

Court Say FCCPC No Get Power To Issue Telecom Licence

By: Esther Daniel Federal High Court for Lagos don rule say Federal Competition and Consumer Protection Commission (FCCPC) no get legal power to issue telecommunications licences to companies wey dey provide airtime and data-credit services. Justice Ambrose Lewis-Allagoa give di judgment on Monday for Suit No. FHC/L/CS/760/2026, after court hear challenge on FCCPC approval for five firms under di DEON Regulations. According to di court, Di DEON Regulations remain valid because dem dey backed by di  Federal Competition and Consumer […]

todayJuly 22, 2026 17

OBODO NAIJA

Man Carry Customer Motor Run, Police Grab Am For Kano

By : Jolayemi Olajide Adamawa Police don arrest 26-year-old Mohammed Dan-Azumi for Kano State after e allegedly carry customer 2016 Toyota Corolla Sport wey worth about ₦18 million run instead of wash am. Di motor owner report say e hand over di motor give di suspect to wash, but di man disappear with am go where e nor know. Police intelligence officers for Yola quickly launch operation, trace di suspect reach Kano and arrest am. Police also recover di stolen […]

todayJuly 21, 2026 15

Lagos

NSCDC Burst Fake School, Rescue 106 Youths For Badagry

By : Jolayemi Olajide NSCDC don burst one alleged fake university wey dey run from one three-bedroom flat for Ilado, Badagry, and rescue 106 youths wey dem allegedly use fake foreign school admission package carry enter trap. Di operation happen early Monday after security people monitor di place for days, as dem arrest di man wey dem say na im own di fake school. According to NSCDC, di suspects dey lure young people from different parts of Nigeria and some […]

todayJuly 21, 2026 26

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds