Blog masonry

Background

obodo oyinbo

US- Israel Continue attack in Iran, kpaiing Many Pipo

Say US and Israel don increase attack for Iran, dem target old medical research centre for Tehran, one bridge near di capital, plus steel plants. Dis one sef dey come after U.S Presido, Donald Trump promise Iran say im go take Iran  back “Stone Ages.” For Iran military, say di war go continue until dia enemies shame and surrender.

todayApril 3, 2026 4

obodo oyinbo

President Trump Fire AG Pam Bondi, Put Lawyer Todd Blanche As Acting Boss

US Presido Donald Trump don fire Attorney General Pam Bondi on Thursday for Washington, DC. Trump tuk for Truth Social say Bondi na “Great American Patriot” wey do beta work, but she gat move enter private sector. Trump con put im former personal lawyer, Todd Blanche, as acting boss for Justice Department to replace her. According to aproko from America, some supporters  dey vex because of how Bondi handle the Jeffrey Epstein files, wey concern sex trafficking case and na […]

todayApril 3, 2026 5

OBODO NAIJA

EFCC Seek Court Order To Take 57 Malami Properties

Di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don tell Federal High Court for Abuja say dem wan court to take over di 57  properties wey get connection with former Attorney General, Abubakar Malami. EFCC, through dia lawyers Jibrin Okutepa (SAN) and Ekele Iheanacho (SAN), tuk say, pipo wey dey defend Malami never show good reason to cancel di earlier interim forfeiture order. Di mata involve Malami, Hajia Bashir Asabe, Abiru’ Rahman Abubakar Malami, plus some companies wey get link to […]

todayApril 3, 2026 3

OBODO NAIJA

INEC Reject ADC Call Make Chairman Amupitan Resign

In response, INEC say dem nor go accept any jaguda doings to force Chairmo, Prof. Joash Amupitan, to resign. INEC Chief Press Secretary, Adedayo Oketola,  put for statement on Thursday, say demand for Amupitan resignation na attack on di Commission wey dey independent. Di statement follow ADC call wey dey accuse INEC of favouring some political party and asking Amupitan to comot office. INEC explain say di claim of bias nor get foundation, especially as dem just follow Court of […]

todayApril 3, 2026 5

OBODO NAIJA

ADC Put Call For INEC Chairmo Sack

African Democratic Congress (ADC) chairmo, David Mark, don call make dem sack INEC chairmo, Prof Joash Amupitan say, im nor know im work. E run dis one for one join body press conference wey dem run for Abuja yesterday, say INEC dey bias. According to David Mark, moral dey very, very, low, say Nigerians nor get confidence for Amupitan and all di national election, commissioners.

todayApril 3, 2026 4

OBODO NAIJA

First lady, Remi Tinubu Launch Food Bank Programme To Fight Hunger

Nigeria First Lady, Senator Oluremi Tinubu, don launch National Community Food Bank Programme to fight hunger and malnutrition, and dat e go reach 500,000 households for first year. She explain  for di meeting wey sup for Abuja say di programme, don already get over N65 billion support from gornment, and senior mehns from di country According to senator Oluremi, dem go run am through beta collabo with donors, development partners and gornment agencies as sustainable way to reduce food insecurity […]

todayApril 3, 2026 3

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Talk Tough For Jos Attack, Say Peace Must Reign

Wi oga Presido Bola Tinubu on Thursday don finally visit di palm Sunday attack victims for Jos, Plateau State. E say dis one na to calm tension and make justice hapun. For there, senior man Tinubu tell di Nigeria police and soldiers to go after di killers con sti order di plateau gorment to  install CCTV cameras for betament security doings for di state.

todayApril 3, 2026 2

OBODO NAIJA

Ogun Gorment Close Ijebu Ode School After Gas Leak

Ogun State gornment don order say Our Lady of Apostles Secondary School for Ijebu Ode make dem close am after suspected gas leak wey hospitalize about 30 students and staff. Di gbege hapun on Wednesday just after school assembly, when some kind gas spread across di school compound. Commissioner for Environment, Ola Oresanya, tuk on Thursday say Governor Dapo Abiodun don direct security agencies make dem investigate how di incident hapun, why e happen, and who responsible. Say  di investigation […]

todayApril 3, 2026 2

Lagos

Lagos Gorment Catch Task force Members Wey Dey Harass Drivers

Lagos gorment don gbab three taskforce boys wey dem dey call “Omotaku” say dem dey harass drivers for Lagos highway Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab,  yarn dis for im verified X page on Thursday. According to Wahab, di Omotaku dey always dey disturb drivers once dia car spoil for Lagos highways, dey force dem to give money or things. Di gornment catch dem make dem stop dis kind wahala and restore peace for road.

todayApril 3, 2026 5

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app