Blog masonry

Background

Sports

Micheal Olise Help France Beat Belgium 4-1

By: Ajayi Mariam Michael Olise agba ball yesterday, from bench oh naim hin take  help France turn di game around beat Belgium 4-1 for UEFA Nations League on Monday. Dodi Lukebakio put Belgium ahead for first half as dem dey look for dia first competitive win against France for 45 years. But Desire Doue level di score for 77th minute before Olise set up Rayan Cherki four minutes later to put France ahead. France then add two more goals for […]

todayOctober 6, 2026 10

obodo oyinbo

Two Men kpai, Two Women Wunjure As Boat Enter Askident

By: Mariam Ajayi God abeg oh, I dey japa, like dis Two men don kpeme for French coast as dem try cross enter Britain inside boat on Monday sake of say dem dey japa. French authorities naim konfamate dis report,  say two women inside di boat wey get di askident collobi wunjure. Unto di badness na Police don open investigation to find out wetin actually cause the tragedy, advicing young mehns and womens to avoid all dis kind of unnecessary […]

todayOctober 6, 2026 8

OBODO NAIJA

INEC Go Start To Dey Share PVCs In Three Days Time

By: Mariam Ajayi INEC Chairman, Professor Joash Amupitan, don announce say dem go start to share Permanent Voter Cards (PVCs) for registered voters inside three days time. Hin yan  dis one for Abuja during meeting with journalists, con explain say di exercise na for pipo wey newly register, shift dia voting place, or replace bad card. Di commission yarn say dis distribution na part of prep for di upcoming 2027 general elections make everybody fit vote.

todayOctober 6, 2026 8

Lagos

Baba Presido,Tinubu React To Military Aircraft Askident

By: Mariam Ajayi Wi oga Presido, Bola Tinubu don declare three days national mourning and order say make mehn mehn touch dis mata of how military aircraft take go get askident for Ondo State wey nor be winch cause am. According by di Ondo state govo, Lucky Ayedatiwa all 32  passengers kpeme for dis askident. As a mark of respect for di 25 passengers and seven crew members wey kpai na, baba Seyi say make dem fly national flags half-mast […]

todayOctober 6, 2026 9

OBODO NAIJA

Jigawa NYSC Warn Corps Members Against Cultism

By: Mariam Ajayi Jigawa State NYSC Coordinator, Muhammad Baba, don warn corps members say make dem no involve demself for cultism and other bad behaviour wey fit cause wahala and disturb peace for orientation camp. Baba give di warning on Friday during di swearing-in ceremony of 2026 Batch C Stream 1 corps members for NYSC Permanent Orientation Camp, Fanisau, Dutse, di state capital. Before di warning, Justice Amina Dahiru, wey represent Jigawa State Attorney-General and Commissioner for Justice, don swear […]

todayOctober 2, 2026 15

OBODO NAIJA

Chelle Make Two Changes To Super Eagles Squad

By: Mariam Ajayi Midfielder John Otomewo and defender Vince Osuji don join di team to replace captain Wilfred Ndidi and Akpe Victory, wey no go play di match. Otomewo recently move from Israeli club Hapoel Jerusalem join French Ligue 2 side Stade de Reims. Osuji dey play for Norwegian club Tromsø after e leave Belgian club Club Brugge. Di two players go dey hope say dem go make dia first appearance for Super Eagles when Naija face Russia for Nizhny […]

todayOctober 2, 2026 9

Lagos

Lagos Uni Workers Enter Indefinite Strike Over Unpaid Arrears

By: Mariam Ajayi Workers for Lagos State gornment owned universities don enter indefinite strike over wetin dem describe as gornment failure to fulfil agreements with di unions. Di workers, under Joint Action Committee, JAC, include ASUU, SSANU, NAAT and NASU, and di strike affect LASU, LASUED, LASUSTECH and LASUCOM. JAC Chairman, Prof. Ibraheem Bakare, say di unions don try dialogue but dem don exhaust all channels to resolve di matter, including demands for nine months accumulated arrears and 15 per […]

todayOctober 2, 2026 13

Entertainment

Olu Jacobs Funeral Service Hold For Lagos

By: Mariam Ajayi Funeral mass for late Nollywood veteran, Olu Jacobs, dey hold today, Friday, for dis Present House, Freedom Way, Lekki Phase One, Lagos, as family members and friends gather to honour di veteran actor. Jacobs wife, actress Joke Silva, and dia sons, Olusoji and Olugbenga Jacobs, dey di service wearing blue, while di late actor coffin dey in front of di church decorated with flowers. Among di dignitaries wey dem announce for di service na Lagos State First […]

todayOctober 2, 2026 13

Lagos

Hamzat Tuk Say E Go Stop Agbero Money Collection For Lagos

By: Mariam Ajayi APC Lagos gorfnorship candidate, Obafemi Hamzat, don promise to stop unauthorised money collection from agbero and roadside transport operators if elected governor. Hamzat make di promise during governorship candidates town hall meeting for Lagos, where im say transport operators suppose know exactly wetin dem dey pay. Im also propose State Economic Council wey go bring state and local governments together to streamline levies, so people wey don pay official charges no go face another roadside collection

todayOctober 2, 2026 16

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds