Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

Tinubu Hail Buhari, Say Im Legacy No Go Die

By: Yusuf Abuh Wi oga Presido Bola Tinubu don konfam again say di life and legacy of former Presido, Muhammadu Buhari still dey inspire Nigerians because of im service, integrity and love for di country. Vice-Presido Kashim Shettima naim use im mouth tok dis one on Monday during prayer session for Abuja to mark one year since Buhari kpai. Tinubu describe Bubu as true patriot wey leave strong mark for Nigeria through im dedication and commitment to serve di nation.

todayJuly 14, 2026 10

OBODO NAIJA

Makinde Call Mehn to Touch Light Oriire Kidnap

By: Yusuf Abuh Oyo State Govo, Seyi Makinde, don call for independent investigation into di abduction of children and teachers wey hapun for Ahoro-Esinle and Yawota communities for Oriire Local Gornment on May. Di govo tok dis one for statewide broadcast on Monday for Ibadan after dem hand over 46 children and teachers wey security operatives rescue from bandits. Makinde say international human rights and accountability bodies, including agencies under di United Nations, suppose help investigate di matter. According to […]

todayJuly 14, 2026 7

Lagos

Lagos Under Flood Attack As Rainfall Ground Businesses, Movement

By: Yusuf Abuh Heavy rain wey fall for Lagos on Monday scatter business activities as flood cover many areas, make vehicles sink and leave plenty motorists and commuters stranded. According to report, Places like Ikoyi, Lekki, Victoria Island and Oworonshoki suffer serious flooding as water take over major roads and cause heavy traffic. Videos from residents show long line of vehicles wey water swallow for hours, while some pipo waka through knee-deep water to reach where dem dey go. Many […]

todayJuly 14, 2026 13

OBODO NAIJA

Army Burst Gun Runners, Seize Seven Guns for Kaduna

Edited by: Esther Troops of Sector 7, Operation ENDURING PEACE, don intercept one suspected arms trafficking gang for Kaduna State and recover three locally made AK-47 rifles plus four submachine guns wey dem hide inside one vehicle, according to Nigerian Army. Army make dis known for statement wey dem post for dia official social media pages on Tuesday. Dem say di intelligence-led operation happen early Monday morning for Samaru Checkpoint, Zangon Kataf Local Government Area. According to di statement, di […]

todayJuly 13, 2026 15

OBODO NAIJA

NUT Cry Out, Say Make Dem Rescue Oyo Headmaster Sharp Sharp

Nigeria Union of Teachers (NUT), Oyo State chapter, don raise alarm over di kidnap of one primary school headmaster for Itesiwaju Local Government Area, as di union dey call for im quick rescue. Di union drop dis one for statement wey State Chairman, Hassan Fatai, and State Secretary, Salami Olukayode, sign and give tori pipo for Ibadan. According to di statement, gunmen kidnap M.K. Owoade, wey be headmaster of Nomadic Basic School, Ogodu, Igbojaye, as he dey farm on Saturday, […]

todayJuly 13, 2026 14

OBODO NAIJA

Soludo Wife Yarn Nigerians To Always Choose Healthy Food

Anambra First Lady, Dr Nonye Soludo, don tell Nigerians make dem dey choose healthy food by eating more local fruits, vegetables, beans, grains and tubers wey get plenty nutrients wey body need, she talk say natural food na one of di biggest gifts God give human beings. Soludo, wey also found di NGO Healthy Living with Nonye Soludo, say when people choose natural food instead of plenty processed food, e dey reduce di risk of lifestyle diseases, strengthen body immunity […]

todayJuly 13, 2026 9

OBODO NAIJA

Aisha Buhari Show for Late Husband One-Year Remembrance

Former First Lady Aisha Buhari don attend di one-year remembrance of her husband, former President Muhammadu Buhari, wey hold for Abuja on Monday. Muhammadu Buhari, wey rule Nigeria as President from 2015 reach 2023, die on July 13, 2025, for London at di age of 82 after long illness. Dem later bury am for im hometown, Daura, Katsina State, according to Islamic rites.

todayJuly 13, 2026 14

obodo oyinbo

Heatwave Kpai 2,700 People for England, Wales

By : Jolayemi Olajide Person wey dey naija, and other part nor knw wetin God do for am, say like dis, at least 2,700 pipo kpai for England and Wales because of serious heatwaves wey hapun for May and June. According to research wey dem package for Imperial College London, heat wave don make pipo get igbeke, na so dia body dey red, u knw oyinbo na, e be like person wey dem beat with 2 by 2. Experts say […]

todayJuly 13, 2026 9

obodo oyinbo

Federal Gorment Match break say no to WAEC AND NECO Increase Reg Fees

By : Jolayemi Olajide Finally, small air don enter di room as di Federal Ministry of Education announce on Monday say dem go wait, dat dem nor dey increase WAEC and NECO registration fee to 50k. Everywia first blur when mehnmehn wak up on Monday hear say dem don increase WAEC and NECO fee, na so dragging start across di obodo Nigeria. Officials inside Abuja code dis suspension because dem wan carry carry everybody along and do proper checking before […]

todayJuly 13, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds