Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

Tinubu Reforms Don Put Nigeria Economy For Growth Path

By: Mariam Ajayi Nigerian billionaire businessman, Femi Otedola, say Presido Bola Tinubu economic reforms don put Naija on road to sustainable growth. Otedola make di statement on Tuesday after private dinner with Tinubu for Paris, France, as e praise di President reforms and say di results dey become more visible. E point to Nigeria return to FTSE Russell Frontier Market classification, gains for di Nigerian Exchange, increase for foreign investment and better stability for di foreign exchange market. Otedola also […]

todaySeptember 29, 2026 11

Sports

La Liga Boss Say Man City Suppose Face Strong Punishment

By: Mariam Ajayi La Liga president, Javier Tebas, say Manchester City suppose face di most severe sanction available if dem breach financial regulations. Reports on Friday claim say one independent panel find City guilty of almost all of di 115 charges wey dem face for breaking Premier League rules. But Premier League never officially announce di finding or any punishment, and e never clear wetin sanction City fit face. City, wey Abu Dhabi back, don always deny di charges, while […]

todaySeptember 29, 2026 12

OBODO NAIJA

Edo Court Sentence Four People To Death Over Kidnap

By: Mariam Ajayi Special Criminal Court for Edo State don sentence four pipo to death over dia role for di kidnapping of one woman for Vegetable Market, around Airport Road for Benin City. Justice Aigbona Momodu give di judgment on Tuesday after dem face 11 charges wey include kidnapping, planning crime together, armed robbery, cultism and illegal possession of guns. Di court wey Gofnor Monday Okpebholo set up na to handle kidnapping and cultism cases for Edo State. Di four […]

todaySeptember 29, 2026 11

OBODO NAIJA

Senate Push FG Make Dem Rescue Kidnap Victims

By: Mariam Ajayi Senate don resume Tuesday, as Akpabio call for stronger action to rescue kidnapped Nigerians and protect communities. Akpabio make di call as senators return after dem go on recess since July 23, 2026. E say Senate go bring laws, money through budget and stronger monitoring to fight insecurity, flooding and di high cost of living wey Nigerians dey battle. Di Senate President also tell security agencies make dem increase dia operations to free kidnapped Nigerians and protect […]

todaySeptember 29, 2026 8

OBODO NAIJA

US, Nigeria Move To Strengthen Security With 12 New Helicopters

By: Mariam Ajayi America and Naija don dey push dia security cooperation forward, as Naija plan to buy 12 AH-1Z Viper helicopters to boost di country defence power. US Mission for Naija reveal dis one for dia official X account on Tuesday, as e describe di planned purchase as part of di efforts wey both countries dey make to tackle current and new security threats. Di mission say America value im security partnership with Nigeria, as both countries dey work […]

todaySeptember 29, 2026 10

OBODO NAIJA

Tinubu Meet Otedola For Private Dinner For Paris

By: Mariam Ajayi Presido Bola Tinubu on Monday meet billionaire businessman, Femi Otedola, for one private dinner for Paris, France, as di Presido continue im extended stay for Europe. Otedola reveal di meeting for im X account on Tuesday, as e share picture of imself and Tinubu dey smile together. Otedola show support for Tinubu economic policies, as e point to wetin e describe as gains from di government reforms. E mention Nigerian companies wey enter FTSE Russell Frontier 50 […]

todaySeptember 29, 2026 9

OBODO NAIJA

Tinubu Leave France, Dey Go Lagos For Political Meetings

  By: Mariam Ajayi Presido Bola Tinubu don round off im vacation for France, as e don comot Paris dey head Lagos, where e dey expected to meet political big men and im loyalists ahead of 2027 election. According to statement wey im Special Adviser on Information and Strategy, Bayo Onanuga, release on Tuesday, Tinubu plane go land for Murtala Muhammed Airport, Lagos, later today. Tinubu comot Abuja on August 30, spend one week for London before e move go […]

todaySeptember 29, 2026 8

obodo oyinbo

Former Snooker Champ Graeme Dott Jailed Seven Years

By: Mariam Ajayi Former world snooker champion Graeme Dott don collect seven years prison sentence after court find am guilty of sexually abusing two primary school-age children. Di 49-year-old Scottish man repeatedly abuse one girl between 1993 and 1996, while di offences against one boy happen between 2006 and 2010. Dott appear before Lord Harrower for High Court in Edinburgh on Tuesday, where di judge say his actions take away important part of di children childhood.

todaySeptember 29, 2026 10

National

Anambra To Prosecute Pipu Wey Deny Women Inheritance

By: Kofoworola Olayinka Anambra State Gornment don tell police make dem investigate cases where pipu dey stop women and girls from inheriting dia parents property because of gender. State Attorney-General, Tobechukwu Nweke, SAN, make dis known for letter wey e send to Naija Police Force on Tuesday. Nweke say di practice dey against court decisions and na crime under Anambra Violence Against Persons Law, wey fit carry up to four years imprisonment. He say police suppose send investigation files to […]

todaySeptember 29, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds