Blog masonry

Background

obodo oyinbo

Netanyahu Swear Say Iran No Go Control Any Palestinian State

By:  Mariam Ajayi Israeli Prime Minister, Benjamin Netanyahu don swear say as long as e remain Prime Minister, e no go allow any Palestinian state wey Iran dey control to happun. Netanyahu make di statement for weekend, August 23, 2026, for message wey e post on X, as argument over Palestinian statehood continue to dey hot. E say Gaza and Judea and Samaria, wey Israel dey use refer to di West Bank, no go become Palestinian state under Iran control, […]

todayAugust 24, 2026 7

OBODO NAIJA

Tinubu Renew Tenure of NTA DG Dembos and NAN MD Ali for Three Years

By: Mariam Ajayi Presido Bola Tinubu don renew di tenure of di Director-General of Nigerian Television Authority (NTA), Abdulhamid Salihu Dembos, and di Managing Director of News Agency of Nigeria (NAN), Ali Mohammed Ali, for another three years. Tinubu’s decision come out for statement wey him Special Adviser on Information and Strategy, Bayo Onanuga, release on Sunday. According to di statement, Tinubu first appoint Dembos and Ali on October 20, 2023, and dia second term go begin on October 20, […]

todayAugust 24, 2026 6

OBODO NAIJA

Fire Burn Five Shop For Ilorin.

By: Mariam Ajayi Fire don destroy five shop and damage part of one storey building for Ita-Amodu, Niger Junction, Ilorin, Kwara State. Di incident happen on Sunday around 1:36pm, according to Kwara State Fire Service. Di fire affect one storey building wey get three-bedroom flats and 10 shops. Five of di shops and di building parapet suffer damage. Kwara State Fire Service Public Relations Officer, Hassan Adekunle, explain say materials wey dem dey use produce mattresses and sofas dey among […]

todayAugust 24, 2026 8

OBODO NAIJA

NAF Step Up Air Attacks Against Terrorists, Bandits For North-West

By: Mariam Ajayi Nigerian Air Force don increase air operation against terrorist, bandits, kidnapper and oda criminal across di North-West, especially Sokoto State. NAF tuktuk pesin, Air Commodore Ehimen Ejodame, talk dis on Monday for Abuja, say di stronger air presence na to support joint security operation. Ejodame say di operation go helep security forces use air surveillance to find criminal group wey dey hide for difficult area and stop dem from moving freely. Chief of Air Staff, Air Marshal […]

todayAugust 24, 2026 7

Politics

Ogun APC Say Yayi Still Be Dia 2027 Governorship Candidate

By: Mariam Ajayi Ogun APC don konfam Senator Solomon Adeola, wey dem dey call Yayi, as di party candidate for di 2027 governorship election. Party chairman, Yemi Sanusi, talk dis on Sunday for Ogun, say Abayomi Hunye claim say he be di candidate na lie and make people nor mind am. Former APC lawmaker, Kayode Oladele, also criticise Hunye for still dey fight for di ticket and recently unveil im running mate. Oladele say APC don finish di nomination process […]

todayAugust 24, 2026 9

Sports

Maresca Confess Say  Man City Na  Still  Work In Progress

By: Mariam Ajayi Manchester City coach Enzo Maresca don talk down di team chances of winning di Premier League title dis season, despite dia dramatic 2-1 comeback win against Bournemouth. City struggle for most of di match before late goal from Marc Guéhi and Joško Gvardiol turn di game around and give dem all three point. Maresca say di team still be work in progress, as e dey test different tactic, including playing Guéhi for midfield. E explain say some […]

todayAugust 24, 2026 9

obodo oyinbo

Pope Leo XIV Beg International World Pipo To  Congo Fight Ebola

By: Mariam Ajayi Pope Leo XIV don call on di international community make dem join hands help Democratic Republic of Congo fight Ebola disease. Di Pope make dis call on Sunday after im Angelus prayer for St Peter’s Square, as e urge local communities to also join di effort to save lives. He say di suffering wey Ebola don cause for Congo serious, and e don worry am say instead of blessings to spread, na disease dey spread. Pope Leo […]

todayAugust 24, 2026 7

OBODO NAIJA

Atiku Camp Knock FG Say  Petrol Subsidy Dey Do Nigerians Sufferly Dey Dey

By: Mariam Ajayi Wahala still dey, as ADC presidential candidate Atiku Abubakar pikin, Kenneth Okonkwo, don drag Federal Government over di removal of petrol subsidy. Di former Nollywood actor say di policy don make economic hardship worse for Nigerians and increase di suffering wey people dey face. Okonkwo talk dis one during one television interview on Sunday, saying di value of naira don fall badly since di subsidy removal. According to am, people wey dey get money before now dey […]

todayAugust 24, 2026 4

Local

Lagos Gornment Install New Onise, Charge Am To Unite Ise Kingdom

By: Mariam Ajayi Lagos State Government don officially install Ibrahim Saliu as di new Onise of Ise Kingdom for Ibeju-Lekki. Government present di Staff of Office and Instrument of Appointment to am last Friday, after di death of former monarch, Ganiu Adegbesan. Special Adviser to di Governor on Rural Development, Nurudeen Agbaje, charge di new monarch to unite all di royal families and promote peace for di kingdom. He also urge am to work with oda traditional rulers and community […]

todayAugust 24, 2026 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds