Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Order Make Dem Do Benin-Agbor-Asaba Road

By: Mariam Ajayi Presido Bola Tinubu don order total reconstruction of di Benin-Agbor-Asaba road and other major federal highways for Edo State and nearby areas. Minister of Works, David Umahi, give di order on Tuesday when e inspect di bad Benin-Agbor-Asaba road and apologise to motorists over di hardship wey dem dey face. Umahi also condemn di contractor wey dey  handle di road after hin accuse rain say naim dey spoil di road.

todayAugust 26, 2026 7

Lagos

Suspected Cultists Kpai Security Man Inside Lagos Estate

By: Mariam Ajayi One security man wey dem identify as Stanley don kpai after two suspected cult members shoot am for Royale Estate, Sangotedo area of Lagos, on Friday night. Witness say di attackers storm di estate around 10pm to 11pm, shoot Stanley several times including for di head, before dem fire shots into di air and run comot. Lagos State Police Command tok tok pesin, Abimbola Adebisi, confirm di incident on Monday, say two unknown persons riding motorcycle carry […]

todayAugust 26, 2026 6

Sports

Ethiopa Wan Bid To Host Di 2028 African Cup of Nations

Ethiopia don officially submit bid to host di 2028 Africa Cup of Nations, (AFCON), wey go be di first time di country go host di tournament in more than 50 years. Ethiopian Football Federation confirm di bid for post wey dem make for X late Monday, and di last time wey Ethiopia host di continental tournament na 1976. Ethiopia get about 130 million pipo, make am di second country with di highest population for Africa. But di bid get plenty […]

todayAugust 25, 2026 9 4

obodo oyinbo

Chase Illegal Migrants Comot – Abelardo de la Espriella Yarn

Colombia right-wing Presido, Abelardo de la Espriella, don order immigration crackdown, as e tell authorities make dem start to dey arrest foreign pipo wey enter di country without proper papers, and wey don commit crime, so dem fit deport dem. Abelardo wey enter office on August 7, after e campaign say e go deal with crime and drug-trafficking gangs. Immigration no be major part of im campaign, but for security meeting wey e hold for Barranquilla on Sunday, e talk […]

todayAugust 25, 2026 10

OBODO NAIJA

Comot If You No Go Support APC – Samuel Danjuma Shekwolo Yarn

As 2027 general election dey come near, Kuje Area Council chairman for FCT, Samuel Danjuma Shekwolo, don threaten say e go resist residents wey wan vote against di ruling All Progressives Congress (APC). For one video wey dey circulate for social media, Shekwolo say e no go allow anybody for di council work against APC or oppose Presido Bola Tinubu second-term ambition. Di chairman point to development projects wey Presido Tinubu and FCT Minister, Nyesom Wike, don carry out for […]

todayAugust 25, 2026 11

Lagos

IGP Olatunji Disu Draw Ear Say Jungle Justice Na Crime

Di Inspector-General of Police, Tunji Disu, don drag ear say anybody wey kpai person through jungle justice fit face murder charge and death penalty, as e give di warning for video wey Nigeria Police Force share on Tuesday, August 25, 2026. Disu say e issue di warning because innocent Nigerians dey lose dia lives through rumours, suspicion and mistaken identity, press mouth say nobody no get right to try, sentence or kpai anoda pesin. Di IGP don tell Commissioners of […]

todayAugust 25, 2026 10

Lagos

Sanwo Olu Tok Say APC Dey Ready To Win Lagos For Di 2027 Election

Lagos Govo, Babajide Sanwo-Olu, don talk say APC don ready well-well for di 2027 general election, as e dey confident say di party go carry victory for Lagos. Sanwo-Olu talk dis one on Monday after e waka go inspect APC presidential and gornorship campaign offices to see how preparation for di election dey go. Di Govo say di party campaign structure don dey set, as dem don start to dey plan and mobilise pipo ahead of di election. E say […]

todayAugust 25, 2026 11 6

Sports

Hearn Konfamate Say Joshua And Fury Go Fight

Boxing promoter Eddie Hearn don talk say announcement for di long-awaited Anthony Joshua versus Tyson Fury fight fit happen soon as negotiations enter “crunch week.” Both fighters don sign contracts to fight each other but Joshua deal reportedly say di fight suppose happen for United Kingdom. Organisers including Netflix and Saudi financier Turki Alalshikh dey push for di fight to hold for America, especially Madison Square Garden for New York, while Hearn accuse dem of trying to go against Joshua […]

todayAugust 25, 2026 10 3

obodo oyinbo

Iran Knack Chest Say Dem Ready To Face Fresh US Sanctions

Iran don talk say e ready to withstand di wider sanctions wey United States announce to isolate di country from di global economy. Iranian Economy Minister Ali Madanizadeh say Tehran fully prepared for di measures and believe say dem go lead to another defeat for America. US Treasury Secretary Scott Bessent say any country, bank or business wey continue financial dealings with Iran go face isolation if dem refuse to cut ties. Bessent describe di new measures as di biggest […]

todayAugust 25, 2026 8 3

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds