Blog masonry

Background

obodo oyinbo

Hezbollah Fire Rockets, Drones Enter Israel To Revenge Iran Attack

Hezbollah for Lebanon say dem don fire rocket and send drone to military base for south of Haifa for Israel. Dem say na revenge for Iranian oga Ali Khamenei wey kpai afta U.S. and Israel attack for Tehran. However, Israel tuk say dem don fire back Hezbollah for Lebanon and no go do wahala with dem. Lebanon PM Nawaf Salam say, im ready to protect im pipo to di fullest.

todayMarch 2, 2026 11

obodo oyinbo

Iran Attack Ship For Strait of Hormuz

Global oil price don jump up afta jaguda pipo go attack at least three ship for Strait of Hormuz. UK Maritime Trade Operations Centre (UKMTO) report, na im dey report dis one say, di jaguda boys attack Two ship for Kena. Say dis one sef na based on say Iran dey strike back Middle East aftA  US and Israel bomb Iran. Iran don warn say dem nor go allow any ship pass dia water. Experts like Saul Kavonic talk say […]

todayMarch 2, 2026 14

Sports

Remo Stars Break Seven-Game Curse, Hammer Katsina United 2-0

Remo Stars don finally break dia seven-game winless run, beating Katsina United 2-0 for Ikenne on Sunday. Haruna Hadi na di main guy, wey score di  two goals afta di first half end 0-0. Coach Usman Abdallah, wey just take over last Thursday, enjoy im first big win with di team. Before now, Remo Stars never win since dem knack Ikorodu City 1-0 for January 14.

todayMarch 2, 2026 10

Sports

Arsenal Beat Chelsea 2-1 For London Derby

Arsenal don extend dia lead for di English premier league table, beating  Chelsea 2-1 for Emirates Stadium. William Saliba score di first goal,  and na im first goal since December 2024 put Arsenal first. Chelsea come equal with Piero Hincapie own goal afta Reece James  fine corner. Before, Jurrien Timber con score di winning goal for Arsenal.

todayMarch 2, 2026 19

Lagos

Lagos To Host 3rd Edition Of City Art Day

Lagos Gallery Weekend (LGW) don announce say dem go hold di 3rd edition of dia city-wide art show from March 5 reach 8, 2026, for Lagos, wey go spotlight di creative energy of di city. Director of LGW, Sunshine Alaibe, clear dis mata inside tuk tuk sitting for Ikoyi, say di theme dis year na “Art for All,” to make art accessible to everybody. Say pipo fit see beautiful art work  inside 20 galleries across Yaba, Ikoyi, Victoria Island, and […]

todayMarch 2, 2026 12

Lagos

Lagos Gorment To Shut Ogunnusi Road For Rebuilding

Lagos State Gornment, say dem wan begin Phase I of di reconstruction of Ogunnusi Road from Ojodu Berger to Mobil Filling Station Junction for Ikeja and don arrange plans to manage traffic. Say di Phase I na 4.5 kilometre stretch, and dat di work go last from March 6, 2026 reach February 6, 2027, and no vehicle go fit enter di work zone. Motorists wey dey go Ijaye or Agege go now follow contraflow for Ojodu Berger bound carriageway. Another […]

todayMarch 2, 2026 12

Lagos

Police Commissioner Explain How Join bodi Go Hellep Stop Insecurity

Key joinbodi pipo don do meeting call for stronger way to prevent fight fight and bring beta security to Lagos state. Di meeting wey di Lagos State Police Commissioner,  CP Olohundare Moshood dey  present for register, explain policing, na so big names of di security mata put body for di meeting for Alausa Ikeja. Afta di meeting, oga police Commissioner tuk im mind oh wetin nor good, say na corperation dey make rice dey full pot and na so security […]

todayMarch 2, 2026 14

obodo oyinbo

Plenti Flight Cancel Afta US-Iran Fire Each other

Flights don scatter everywhere, as thousands of passengers dey stranded as US and Israel attack on Iran make global air travel choke. Countries like Iran, Israel, Qatar, Iraq and UAE lock dia space for air as missile and strike action burst for Gulf region. Airlines from Europe, Asia and America cancel plenti flights as tension for Middle East still dey hot like fire. Iran sharpaly lock dia airspace until further notice as di gbege start, according to dia Civil Aviation […]

todayMarch 1, 2026 15

obodo oyinbo

Iran Strike Israel and US Base Afta Khamenei Kpai

Iran launch fresh wave of missile and drone attack on Sunday, target 27 US military base for di region and Israel military headquarters for Tel Aviv, say na payback afta big US-Israel strike kill Supreme Leader Ayatollah Ali Khamenei. Iran army for statement wey dem show for state TV talk say dia air force bomb US base for Gulf countries and Kurdistan region of Iraq for different phases of operation. Iran state television konfamate say Khamenei, wey rule since 1989, […]

todayMarch 1, 2026 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds