Blog masonry

Background

National

Jaguda Bandits Say Enter Area For National Park Office For Oyo, Kill Five

By: Esther Ayoola Gunmen wey people dey suspect say na bandits attack National Park Service office for Oloka, inside Oriire Local Government Area of Oyo State, around 9 p.m. on Tuesday. Konfam gather dat, di jaguda boys enter late for night and attack di office, though reason for di attack never clear. Oyo State Police tuk tuk, Olayinka Ayanlade, confirm di attack, but say police still dey

todayJanuary 7, 2026 10

National

FG Clear Scholarship Marras For Morocco student

By: Esther Ayoola Federal Gornment don scarra tuk say dem abandon Nigerian students wey Morocco on scholarship, say dem nor abandon anybody, di information na false and misleading. Dis one come from statement wey Director of yanings for Federal Ministry of Education, Boriowo Folasade, release. According to Minister of Education, Dr Tunji Alausa, all Nigerian students wey dey on valid Federal Gornment scholarship under di Bilateral Education Scholarship Programme before 2024 don receive dia payment reach di 2024 budget year. […]

todayJanuary 7, 2026 4

National

Regina Daniels Do Drug Test

By: Rilwan Agbomeji Nollywood actress Regina Daniels don break silence on recent controversies wey dey surround her life by undergoing drug test. She reveal dis one on her Instagram page on Wednesday, talk say e follow months of personal struggles and public scrutiny. According to Daniels, di past few months don heavy, nearly overwhelm her, and e make her rethink plenty things for her life. She explain say di decision to do di drug test na part of her effort […]

todayJanuary 7, 2026 15

National

FG: NARD Dispute Na Structural Issue

By: Esther Ayoola Federal Government don explain say di ongoing wahala between dem and di National Association of Resident Doctors (NARD) no be because dem no care, but na structural and policy issues dey cause am. Honourable Minister of State for Health and Social Welfare, Dr Iziaq Adekunle Salako, tuk dis on Wednesday for statement wey Statehouse release. Im explain say Tinubu gornment still dey committed to good relation with health workers, but dem dey operate within civil service rules […]

todayJanuary 7, 2026 5

Sports

Gary O’Neil Be New Strasbourg Coach

By: Esther Ayoola French club Strasbourg don announce on Wednesday say Gary O’Neil go replace Liam Rosenior as dia new coach. Rosenior leave di Ligue 1 team on Tuesday to join Premier League side Chelsea. O’Neil, wey 42 years old, don play for clubs like Portsmouth and Middlesbrough and even represent England under-21s. For official statement, O’Neil tuk say e dey excited and proud to join Strasbourg, and e dey ready to start work for di club.

todayJanuary 7, 2026 4 3

National

Palace Aide Stop Woman Shake Olu of Warri Hand

By: Rilwan Agbomeji One viral video don show how an aide to di Olu of Warri, Ogiame Atuwatse III, gently stop one woman wey wan shake di monarch hand for palace lounge. Di 47-second clip wey start trend on Tuesday show di Olu dey waka with im entourage wey dey wear traditional red and white Itsekiri attire. According to palace custom, any subject wey wan greet di Olu no fit touch am, handshake fit only happen if di monarch allow […]

todayJanuary 7, 2026 4

National

NASENI Launch Youth Tech Innovation Program

By: Esther Ayoola Federal Gonment don share ogbonge update say dem wan turn Nigeria to global tech house and like dis, dem don officially launch di movement wey dem dey call Di National Agency for Science and Engineering Infrastructure (NASENI) Future makers initiative across obodo Naija. Executive Vice Chairmo and CEO of National Agency for Science and Engineering Infrastructure, Khalil Suleiman Halilu, unveil di programme during event wey hold for Nigeria. Im tuk say di initiative dey designed to find […]

todayJanuary 7, 2026 7

obodo oyinbo

US Sets $15,000 Visa Bond for Nigerians

By: Esther Ayoola United States gonment don announce new travel rules dis week, wey fit make Nigerians wey dey apply for B1/B2 visa pay bond of up to $15,000. According to US Department of State website, Travel State.Gov, even if applicant pay di bond, e no guarantee say dem go issue visa. Dem also warn say any fee wey person pay without direction, say consular officer no go fit return di money. Di updated list show say 24 of 38 […]

todayJanuary 7, 2026 2

Sports

Super Eagles Buy Waka Marrakesh For AFCON Quarterfinal

By: Esther Ayoola Nigeria Football Federation don confamate say Super Eagles go comot Fez go Marrakesh on Thursday as dem dey prepare for Africa Cup of Nations quarterfinal. Dem go face Algeria for match on Saturday by 5pm. According NFF post on X, say All 26 available players join training on Tuesday evening for Sardienne Complex. Defender Ryan Alebiosu still dey sidelined as e dey recover from injury.

todayJanuary 7, 2026 4 2

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app