Blog masonry

Background

obodo oyinbo

Japan To Arrange Station Missile For Island Near Taiwan Based On China Tension

By: Esther Ayoola Report don land say, Japan wan position surface-to-air missile for one small island wey near Taiwan by March 2031. Japan defence minister, Sanae Takaichi, explain, say Na di first time Japan dey share where dem go put missile for Yonaguni island since 2022. While China dey claim Taiwan as dia own and report say, dem wan use force to “reunify” am. Tension don dey rise like two days old soaked garri between Tokyo and Beijing since Japanese […]

todayFebruary 25, 2026 13

Sports

Mbappe To Miss Benfica Game Due To Knee Problem

By: Esther Ayoola Real Madrid striker Kylian Mbappe nor go play against Benfica for today Champions League match say im get knee wunjury. According to report im don dey manage di pain since but for tonight waka for Santiago Bernabeu against Benfica, say im go rest. Madrid get 1-0 advantage from di first leg for Lisbon wey Vinicius Junior suffer racial abuse. Even with im knee problem, Mbappe still dey lead UCL scoring chat with 13 goals dis season.

todayFebruary 25, 2026 8

Sports

UCL: Sorloth Hat-Trick, Lookman Assist, Atletico Hammer Brugge 4-1

By: Esther Ayoola Super eagles striker Ademola Lookman shine wetin nor good as e come from bench hellep Atletico Madrid win Club Brugge 4-1. Alexander Sorloth ni lead di attack, score three correct goals wey make Atletico qualify for di UCL Round of 16. Di match start shakily as Brugge player, Hugo Vetlesen, nearly score, but David Hancko block am. As Atletico settle down, Na so, Jan Oblak pass long ball, Sorloth run to di ball, shoot, and Simon Mignolet […]

todayFebruary 25, 2026 12

Sports

Naija Sport Senior Man, Egbe Cry For Help Say NPFL Dey Crumble

By: Esther Ayoola Oga CEO of Sports Facilities Construction Limited, Ebi Egbe, don raise alarm say NPFL need emergency help. Say di league dey go ground every day following recent ranking by IFFHS say, di Naija league don fall enter 91st for world ranking. Reacting to di post for X, Egbe say na because say, football ground don kpafuka finish, no good pitch, ni make we nor dey see good football. Egbe use di opportunate take charge gornment to declare […]

todayFebruary 25, 2026 15

National

President Tinubu Sack Igp Egbetokun, Tunji Disu Go Take Over

By: Esther Ayoola President Bola Tinubu don remove Kayode Egbetokun as Inspector General of Police. Human rights activist Omoyele Sowore ni dey share di update as im dey come out from court on  Tuesday for Abuja. According to Sowore, Tunji Disu, wey be Assistant Inspector General in charge of Force Criminal Investigation Department, FCID Annex for Alagbon, Lagos, ni  go take over di position. As at di time wey konfam package dis report authorities never tuk on di mata.

todayFebruary 24, 2026 25

National

NASS Shift Plenary Resumption To March 5 Over Budget Defence Mata

By: Esther Ayoola National Assembly don shift dia plenary resumption from Tuesday, February 24, 2026, go Thursday, March 5, 2026. Clerk of di National Assembly, Kamoru Ogunlana, announce di postponement for statement wey dem release on Monday for Abuja. Di statement say di shift go give committees more time to finish ongoing budget defence meetings with ministries, departments and agencies as dem dey check di 2026 Appropriation Bill well-well. Senate and House of Representatives go now resume plenary by 11:00 […]

todayFebruary 24, 2026 17

obodo oyinbo

Four Die as Iranian Army Helicopter Crash For Market inside Isfahan

By: Esther Ayoola Four people don kpai afta one Iranian Army helicopter crash for fruit market on Tuesday morning for Khomeynishahr, Isfahan province. According to state news agency IRNA, di pilot, co-pilot and two fruit sellers wey dey ground lose their life for di askident. Dem say na technical problem cause di helicopter to fall enter di busy market area. Dis crash na one of several air askidents wey don happen for Iran in recent years as officials tuk, say […]

todayFebruary 24, 2026 35

Sports

Enyimba News Coachie Deutsch Share Hope Say Enyimba Go Return To Glory Days

By: Esther Ayoola Enyimba new head coach, Emmanuel Deutsch, don promise say di People’s Elephant go soon come back to dia glory days. E tuk dis one afta dia 1-1 draw with Rivers United for NPFL Matchday 27 match wey dem play for Port Harcourt on Sunday. Enyimba ni score first through Abiodun Joseph header before Okon Aniekeme equalise before half-time. Deutsch say, e dey proud of di players’ fighting spirit and with more training, dem go make fans proud […]

todayFebruary 24, 2026 14

Lagos

Govo Sanwo Olu Make President Tinubu Get Happy Ending

By: Esther Ayoola Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, don yarn update, say oga presido, Bola Tinubu dey happy, as Lagos dey plan to set up Lagos International Financial Centre (LIFC). Sanwo-Olu yarn dis one for statement wey govo media tuk tuk, Gboyega Akosile sign on Monday. Say di di training na Lagos International Financial Centre organize am, TheCityUK run am, and UK government fund am. Sanwo-Olu say LIFC no be for one person or region, e dey for Nigerians to […]

todayFebruary 24, 2026 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds