Blog masonry

Background

foreign

Flash Flood Sweep Dozens Comot For Moroccan Town

By: Rilwan Agbomeji Flash flood don kill at least 37 people for Moroccan coastal town, local officials confirm Monday as search and rescue operations dey continue. Di flood hit Safi, a town about 300 kilometres south of Rabat, turning streets into muddy river wey carry cars and bins comot. Morocco, wey dey suffer drought, dey face severe weather from time to time, but Sunday’s flood na di deadliest in over ten years. Authorities dey continue rescue and assess damage, as […]

todayDecember 15, 2025 8

Sports

Alcohol, Animals, Other Items No Dey Allowed Inside AFCON 2025 Stadiums

By: Rilwan Agbomeji As AFCON 2025 dey near, wey go start December 21 for Morocco, CAF don release list of items wey no go allow for all stadiums. Dem put di rules for dia website on Monday, talk say na to keep fans safe throughout di tournament. Everybody wey wan attend AFCON matches for Morocco go need pass security screening before dem fit enter stadium. Di guideline dey make sure fun no spoil, fans dey safe, and di Africa Cup […]

todayDecember 15, 2025 24

Business

Dangote Say Im Go Sell Petro At ₦739 Per Litre Starting Tomorrow

By: Rilwan Agbomeji Dangote don announce say petrol go sell for ₦739 per litre from Tuesday, as e talk for press briefing at Lekki Refinery on Sunday. E explain say refinery don reduce gantry price from ₦828 to ₦699 per litre two days before, and now di new price go benefit consumers. Dangote assure Nigerians say di ₦739 price go dey enforced, and e go fight any form of price manipulation. E add say anybody wey get truck fit waka come […]

todayDecember 15, 2025 11

foreign

Australia Tighten Gun Laws Afta Deadly Bondi Shootings

By: Rilwan Agbomeji Australia don declare say dem go tighten gun laws afta one of di worst mass shootings in almost 30 years hit di country. Father and son burst Hanukkah festival for Bondi Beach on Sunday, open fire wey kill 15 people including small pikin. Crowd scatter scatter for Sydney beach, people dey run for dia life as bullets dey fly. Among di dead na 10-year-old girl, one Holocaust survivor, and local rabbi, while 42 others dey hospital with […]

todayDecember 15, 2025 10

Business

“Trump Dey Happy With Dangote Refinery” — Aliko Dangote

By: Rilwan Agbomeji President of Dangote Refinery, Alhaji Aliko Dangote, don calm di internet, talk say US President Donald Trump no get any wahala at allwith di $20 billion Dangote Refinery. E yarn dis while e dey react to social media gist wey scatter everywhere, wey some people begin talk say Trump no happy say Africa biggest refinery dey Nigeria. Di talk burst afta Trump threaten say im go hit terrorists wey dey attack Christians for some parts of Nigeria, […]

todayDecember 15, 2025 11

Entertainment

“Abeg Make Una Leave My Marriage Palava, Make We Face Real National Wahala” – 2Baba

By: Rilwan Agbomeji Nigerian music icon Innocent Idibia, wey people sabi as 2Baba, don call Nigerians make dem stop to dey focus on im personal life and turn eye to di serious problems wey dey worry di nation, for one live performance on December 12, 2025. As e yarn di crowd directly, di singer talk say discussion about im marriage to Edo State lawmaker Natasha Osawaru don too long, and e don tire for di matter.

todayDecember 15, 2025 15

Sports

Lookman, Ajayi, Osayi-Samuel Reach Super Eagles Cairo Camp

By: Rilwan Agbomeji Atalanta winger Ademola Lookman,  defenders Semi Ajayi plus Bright Osayi-Samuel don touch Super Eagles camp, Cairo, to jim jim di bodi ahead of AFCON 2025. Fresh faces like goalkeeper Amas Obasogie, Tochukwu Nnadi, and Igoh Ogbu also don report for duty, ready to join di squad. Dem join forces with Francis Uzoho, Stanley Nwabali, Ebenezer Akinsanmiro, and Fisayo Dele-Bashiru, wey don already dey camp. With everybody now together, Super Eagles camp don full ground, as preparation for […]

todayDecember 15, 2025 12

Lagos

Police Hunt Driver Wey Kill House Agent For Lekki

By: Esther Ayoola Lagos state police command don carry fork, wrake and all dia equipment  enter Lagos dey find one driver wey dem accuse of killing a house agent, Yinka Agboola, because of fight over parking space for, orchid road, Lekki. U sabi say,  Konfam bin report last week how di wahala take start,  dem tell di driver make e move im motor from middle of road and even show am another place to park, but man wey get cocoanut […]

todayDecember 15, 2025 10 1

Lagos

FRSC Share Report Card Say 91 Kpai For Lagos Road Crash

By: Esther Ayoola Federal Road Safety Corps, Lagos state branch, don mark present, share report card say, not to make anibodi fear, say from dia record say wawawa driving don kpai at least 91 people across di state between January and November 2025. Lagos FRSC Sector Commander, Kehinde Hamzat, yarn dis one for tuk tuk meeting wey im do with tori pipo wey dem hold for Ojodu-Berger on Friday. Di briefing na normal tin wey im dey do sama dia […]

todayDecember 15, 2025 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app