Blog masonry

Background

obodo oyinbo

Iran Revolutionary Guards Threaten Apple, Google, Tesla If More Leaders Kpai

Iran Revolutionary Guards like dis, don cut chain say if more of dia top Iranian leaders kpai sake of dis war, dem go target big US tech companies like Apple, Google, Meta, Microsoft, Tesla and others. Say dem drop microsoft word for di workers for these companies make dem avoid office starting Wednesday 8:00 pm Tehran time to save dia life. Di Iran guards dey claim say, these companies dey help US track and plan assassination of Iranian officials, so […]

todayApril 1, 2026 3

OBODO NAIJA

House of Rep Pass N68.3 Trillion 2026 Budget

House of Representatives for Abuja don pass di 2026 Appropriation Bill wey go spend N68.3 trillion. According to House Leader Prof. Julius Ihonvbere, say dis budget go favour  development more dan consumption and make capital spending pass recurrent spending for di first time. U sabi say, di approved budget, wey Presido Bola Tinubu propose last year, include over N26 trillion for roads, power, and other projects, N5.4 trillion for security, and N15.9 trillion to pay debt. Speaker of di House, […]

todayApril 1, 2026 3

OBODO NAIJA

Senate Approve Tinubu $6bn Loan To Fix Ports, Cover Budget Gap

Senate don approve oga Presido Bola Tinubu request to borrow $6 billion from outside. Chairmo of di Senate Committee on Local and Foreign Debts, Senator Aliyu Wamakko, clear dis mata say, Tinubu write two separate letters to Senate Presido, Godswill Akpabio, asking $5 billion from Abu Dhabi Bank for budget deficit and old debts, and $1 billion from UK Export Finance through Citibank London to fix Lagos and Tin Can Island ports. Di mata nor too waste time for  di […]

todayApril 1, 2026 2

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Meet Ganduje, Badaru As Kano, Jigawa Politics Dey Shake Up Ahead 2027

Wi oga presido Bola Ahmed Tinubu don meet former Kano govo, Abdullahi Ganduje and ex-Defence Minister Badaru Abubakar for Aso Rock as politics dey shakeup for Kano and Jigawa. Though wetin dem discuss never come outside, pipo believe say na plan to make All Progressives Congress strong again for di states. For Kano, mata  hot, as Rabiu Musa Kwankwaso and im supporters dump New Nigeria Peoples Party go join All Democratic Congress. Some APC big men too dey consider to […]

todayApril 1, 2026 3

Lagos

LIRS Extend Tax Return Deadline To 14 April

Lagos State Internal Revenue Service (LIRS) don extend di deadline for individual annual tax returns from 1 April go 14 April 2026. Di Head of Corporate Communications, Monsurat Amasa-Oyelude, na im tuk dis one for statement, say dem do dis to give pipo more time to complete di tax returns process. You sabi say, di federal gornment don already say every Nigerian gatz file tax returns by 31 March under di new tax law. Taiwo Oyedele, wey be former chairmo […]

todayApril 1, 2026 8

National

Court Adjourn El-Rufai Corruption Case Again

Say nor be small gbege for court as Former Kaduna State Governor Nasir El-Rufai show face for Federal High Court for Kaduna on Tuesday over alleged corruption case wey ICPC carry come. During di sitting, na so Rufai lawyer, Ukpon Akpan, cut chain follow Justice Rilwan Aikawa say make im step aside for di case dat di judge dey bias but later withdraw di request. Based on di jogolo, di Court no fit continue with bail hearing because say di […]

todayMarch 31, 2026 11

Entertainment

Iyabo Ojo Comot Body For Funke Akindele And Toyin Abraham Fight

Nollywood actress Iyabo Ojo like dis na say, she don to find settlement for Funke Akindele and Toyin Abraham. She yan dis one for her Instagram on Tuesday, say pipo don dey insult her because of di mara. Iyabo say she and Funke na friendship for years now, on dis mata say she don try settle dem but no answer. She add say she try settle things between Funke and Toyin, but now she no go dey involve again.

todayMarch 31, 2026 8

National

Tinubu Message National Assembly To Increase 2026 Budget To ₦67.4 Trillion

Wi oga Presido, Bola Tinubu don write National Assembly make dem increase di 2026 budget by ₦9 trillion, from ₦58.4 trillion go ₦67.4 trillion. Oga Senate Presido, Godswill Akpabio, read di letter for Senate floor on Tuesday. Tinubu tuk say di increase go hellep manage gorment mata wella . E also say e go cover past legal commitments, manage gornment debt, and fund few important projects without stress for domestic market.

todayMarch 31, 2026 5

obodo oyinbo

How Iran Fires Missiles Across Middle East

Say like dis Iran don fire missile across Middle East afta fresh explosion hapun for Tehran on Tuesday According to local media, say di thing cause power cut for parts of di city. Nor be amebo say US Presido, Donald Trump tuk say e fit attack Iran oil hub, power stations, and water plants to stop dia threat, as dia peace tuk nor dey get head. Israel Prime Minister Benjamin Netanyahu say more than half of dia military target don […]

todayMarch 31, 2026 4

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app