Blog masonry

Background

National

Police Arrest Suspect Afta Two Nollywood Actors Kpai For Set

By: Esther Ayoola World pipo say, problem nor dey finish, Dat like dis, police don arrest food delivery guy over di death of Two Nollywood crew members, Ekemini “GeeTee” Imeh and Ayodeji Walter Odediran. Say dem kpai for location wey dem bin dey shoot film for Lekki area Lagos. Lagos State Police tuk, tuk, CSP Abimbola Adebisi, ni dey konfamate dis report, say police don arrest di suspect. According to di police, di two crew pipo enter one parked Nissan […]

todayFebruary 17, 2026 13

Lagos

Lagos Gorment Set To Release Flying Cameras To Boost Security

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment say now, dem wan to dey use surveillance drones to boost security work across di state. Executive Secretary of Lagos State Security Trust Fund, Ayodele Ogunsan, ni dey tuk dis one during press conference to mark him first 100 days for office. According to am, dem dey plan sign agreement with Nigerian Air Force and Naija Police Airwing to support beta aerial monitoring and faster response to threats. Ogunsan press tuks say, as Lagos […]

todayFebruary 17, 2026 27

Lagos

Lagos Assembly Approve Deal For Ogbonge Waste Management

By: Esther Ayoola Lagos State House of Assembly don approve report wey four-man committee prepare on di deal to hellpe di state gorment proper waste management. Untop sitting on Monday for state house Alausa, di committee tuk say, gornment  go share 4,250 tonnes from di 13,000 tonnes waste wey di state dey generate every day, so other investors fit join di waste management mata. Committee wey Speaker Rt Hon Mudashiru Obasa lead, check di partnership wey suppose improve how di […]

todayFebruary 17, 2026 18

Lagos

Lagos Fire Service Launch Marshal Club, Do Safety Training

By: Esther Ayoola Lagos State Fire and Rescue Service don launch Fire Marshal Club and carry out Safety Walk to waka town make pipo sabi how to prevent fire and respond in emergency. Say, di awareness waka start from dia headquarters for Alausa, Ikeja, pass Ikeja Fire Station, then return headquarters on Sunday. According to di Controller General, Margaret Adeseye, di way  fire  dey worry Lagos, too much, however cases don reduce small from 2024 reach 2025. She sha jinger […]

todayFebruary 16, 2026 12

National

Senate Explain E- Transmission Of Election Results clearly

By: Esther Ayoola Di Senate don explain dat, na wetin dem see for book, ni make dem take decide say electronic transmission of election results go dey optional instead of compulsory for di new Electoral Bill 2026. Dem say di decision no be by emotion, but afta dem consult people for communication and power sectors about di real situation for di country. Inside statement on Sunday, ni Senate Leader, Senator Opeyemi Bamidele, dey explain di whole mata, say lawmaking get […]

todayFebruary 16, 2026 10

Sports

Saka Turn Center Mid Helping Arsenal Smash Wigan 4-0

By: Esther Ayoola Arsenal coachie, Mikel Arteta tok say Bukayo Saka fit play for center mid role afta dem win Wigan 4-0. Saka no suppose start, but he enter last minute because Riccardo Calafiori wunjor for warm-up. Myles Lewis-Skelly come shift back from midfield go left-back, Saka dey center behind Gabriel Jesus, with Gabriel Martinelli and Noni Madueke for each side. Say dis last-minute change   confuse Wigan, helping arsenal revenge dia 2014 FA Cup semi-final lose.

todayFebruary 16, 2026 11

Sports

Ikorodu City Wunjor Pipos Elephant For Aba As Rangers Close Gap

By: Esther Ayoola League leaders Ikorodu City do small show Micheals win important away match for Enyimba ground for Aba, to continue dia doings for top of Nigeria Premier Football League. Joseph Arumala ni score for di 29th minute, settling di match as Ikorodu City hold strong to di end. Dis win put Ikorodu City for 44 points from 26 games, dem dey pass Rivers United wey don drop go third. Enugu Rangers beat Wikki Tourists 2-0 with goals from […]

todayFebruary 16, 2026 13

obodo oyinbo

Ukraine Former Energy Minister Galushchenko Land Police Net For Corruption

By: Esther Ayoola Former Ukraine energy minister German Galushchenko don land police net as im dey try japa from di country. U sabi say, e leave gornment last year afta e name show for corruption list. E dey among people wey dem tuk say, dem collect $100m for November embezzlement scandal. Say di mata sef shake President Volodymyr Zelensky gornment wey promise to fight corruption before Russia attack, so like dis im dey answer questions for Ukraine police station.

todayFebruary 16, 2026 17

obodo oyinbo

Israeli Soldiers Kpai 11 Palestinians For Gaza, Including Pij Commander

By: Esther Ayoola Israeli soldiers don kpai kpai at least 11 Palestinians for different parts of Gaza, According to hospital authorities, For Jabalia camp, dem hit tents wey displaced people dey, kill five. For Khan Younis, another five people Kpai. Say Dem also kill PIJ commander Sami al-Dahdouh for Tal al-Hawa, east Gaza City, say, di mata, na every day e dey worwor for Gaza.

todayFebruary 16, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds