Blog masonry

Background

Sports

FIFA Maintain Composure For NFF Petition Against DR Congo

By: Esther Ayoola Say, FIFA never still tuk anytin about di petition wey Naija Football Federation (NFF) put, dat, DR Congo play ineligible players for last November 2026 World Cup African play-offs, According to report, Nigerians waiting on Monday na another level, because di intercontinental play-offs go happen from March 26 to 31 for Mexico. But unto update, NFF Presido Ibrahim Gusau tuk for social media, say dem never hear from FIFA. For NFF say dem don do dia part, […]

todayFebruary 17, 2026 25

obodo oyinbo

President Trump Insist Say Im Go Put Eye For Iran-US Nuclear Tuks

By: Esther Ayoola U.S. Presido, Donald Trump say im go dey “indirectly” involve for di second round nuclear tuks wey go happen for Geneva between US and Iran. Iran Foreign Minister Abbas Araghchi don already land Geneva for meeting before di tuks proper. Tension for Gulf, still dey high, as US don send another aircraft carrier, and Iran for dia part through dia Supreme Leader Khamenei, say, any attack, go start regional war. Trump dey insist say di tuks important, […]

todayFebruary 17, 2026 19

obodo oyinbo

Prime Minister Albanese Insist Say, Australia No Go Rescue ISIS Woman An Pikin From Syria

By: Esther Ayoola Australia Prime Minister Anthony Albanese don clear mata say im govament no go support any jaguda doings and dat  Australian  go send  woman an pikin wey get tie  with ISIS fighters. Untop tuk tuk with tori pipo on Monday, Oga prime minister say e dey “unfortunate” say pikin dem dey involved, but Australia no go look back on dia decision. Albanese say any person wey use im two eyes join ISIS, terrorist group, make dem face di […]

todayFebruary 17, 2026 14

National

Medipool And FG Join Body To Boost Local Medicine Production For Naija

By: Esther Ayoola Federal Gornment don sign Memorandum of Understanding (MoU) with ogbonge Medipool to make local drug manufacturing for Naija grow. Oga coordinating minister of Health, Professor, Ali Pate don describe dis partnership correct access to ogbonge medicine, reducing importation of medicine. Pate say e go also support beta healthcare and boost production of important local drugs.

todayFebruary 17, 2026 12

National

WAEC Release Second CB Result

By: Esther Ayoola WAEC don release di 2025 Second Series CB-WASSCE results for private candidates, According to a statement by Acting Head of Public Affairs, Moyosola Adesina,  on Monday for Lagos, say  Candidates fit check dia results online for www.waecdirect.org before dem fit collect digital certificate for www.waec.org. To get hard copy certificate, candidates suppose apply online through WAEC e-Certman portal at https://certrequest.waec.ng/, as WAEC advise make dem act quick. Say na Total of 65,752 candidates sit for di exam […]

todayFebruary 17, 2026 22

National

Gbajabiamila Press Yans Dat Education Na Mission For Renewed Hope Agenda

By: Esther Ayoola Chief of Staff to oga Presido, Femi Gbajabiamila, don repeat tuks, say education na key part of President Bola Tinubu Renewed Hope Agenda. Im yarn dis one for Abuja during 2026 International Day for Education Conference wey Speaker Tajudeen Abbas organise. Gbajabiamila say if Naija wan compete well for global knowledge economy, e must invest serious for education and carry young people along.

todayFebruary 17, 2026 9

National

FG, APC Govos Dash Kano Fire Victims ₦8bn To Start Life Again

By: Esther Ayoola Federal Gornment don approve ₦5 billion to support pipo wey lose property for di Kano Singer Market fire disaster. Vice Presido, Kashim Shettima tuk am during him sympathy visit to di market. Shettima say di money sef eh,  go hellep victims rebuild dia businesses and bring back normal trading activities. Also marking present, Di All Progressives Governors Forum, led by Imo State Governor Hope Uzodimma, also add ₦3 billion to support di affected traders.

todayFebruary 17, 2026 18

National

President Tinubu Express Shock As Governor Fintiri Show Workings For Adamawa

By: Esther Ayoola Oga Presido, Bola Tinubu don enter area for Adamawa state cut cap for govo Ahmadu Fintiri  say na real “renewed hope” development  im dey do for di state. President Tinubu enter Yola for first state visit yesterday and say im eyes first blur as im see  di kind of big infrastructure and fine governor office. Baba Seyi use di opportunate take beg Nigerians oh, say as country be so, every bodi must join body to make am […]

todayFebruary 17, 2026 12

Lagos

Lagos Truck Drivers Protest To Stop Tax Extortion

By: Esther Ayoola Say nor small go slow for Lagos, dat Truck drivers, members of di Nigerian Union of Haulage Truck and Trailer Drivers, on Monday protest say dem nor go gree, task collectors wan kpai dem with tax. Dem say Lagos State Taskforce, Vehicle Inspection Office, and LASTMA dey harass, beat, and extort dem under guise of enforcement. Dis protest sef sup afta one driver, Comrade Prince Ogunkanmi Adekunle, nearly Kpai during night operation for Ikeja on Saturday. National […]

todayFebruary 17, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds