Blog masonry

Background

foreign

UK PM Starmer – China Na Big Security Wahala, But Trade Still Dey

By: Rilwan Agbomeji UK PM Keir Starmer don yarn say China na gbege wahala for UK security, but im still talk say dem no fit chop Beijing belle, because money and business no dey play. Na for Monday night meeting im yarn am sharp, drag di old Conservative government say dem sidon sleep make UK–China mata turn complete yawa, with espionage gist dey scatter everywhere. Starmer remind everybody say since 2018, France and Germany leaders dey waka China dey go, […]

todayDecember 2, 2025 6

National

Tinubu, Otti Dey Push For Kanu Release!

By: Alice Iduh Presdo Bola Tinubu don receive Abia Govo Dr. Alex Otti for presdo Villa, Abuja on Tuesday, but di agenda no clear for public yet. Sources yarn say di meeting fit get connection with effort to release IPOB leader Mazi Nnamdi Kanu, wey dem jail for Sokoto prison dey serve life sentence. Dia visit follow Governor Otti own recent waka go Sokoto meet Kanu, wey di matter dey involve legal and political stakeholders wey dey try settle di […]

todayDecember 2, 2025 9

Sports

Salah Go Bounce Enter Egypt Camp Dec 15 – Slot

By Rilwan Agbomeji Liverpool oga Arne Slot don burst confirm say Mo Salah go waka comot Anfield go link up wit Egypt for AFCON on December 15. Slot drop di tori before Liverpool face Sunderland, yarn say na FIFA order say December 15 na di final day wey club must release players. Egypt sef no dey dull dia AFCON camp don open and dem get friendly match wit Nigeria on December 10 to ginger body. Slot hail Salah say di […]

todayDecember 2, 2025 8

National

Army Rescue 12 Kidnap Victims As Boko Haram Scatter For Borno!

By:Alice Iduh Troops of Operation HADIN KAI don rescue 12 kidnapped people 7 women and 5 pikin  wey Boko Haram carry when dem dey travel for Gwoza–Limankara Road on November 14. Army yarn say na for Mandara Mountains, Borno State, dem rescue dem on Sunday after dem run coordinated attack under Operation Desert Sanity IV and Diligent Search. Di soldiers, 26 Task Force Brigade with hunters, vigilantes, and Hybrid Forces, carry out pre-dawn raid, make Boko Haram scatter and leave […]

todayDecember 2, 2025 13

Sports

Maresca Talk Say Palmer Ready To Jam Leeds

By: Rilwan Agbomeji Chelsea Oga, Enzo Maresca don open mouth say Cole Palmer dey fit and ready to jam Leeds United for Elland Road dis Wednesday wey dey come. Maresca yarn say Palmer dey try gain im full fitness back, but di plan na to push am small-small until e fit run full 90 minutes like before. Di coach add say everybody dey okay, but Romeo still dey recover and Dario wey just start training don slow down again, so […]

todayDecember 2, 2025 5

National

Tinubu Pick Ex-Cds Musa As New Defence Minister After Badaru Quit

By: Alice Iduh Presdo Bola Tinubu don drop fresh nomination as e pick former Chief of Defence Staff, General Christopher Musa, to take over Defence Ministry after Mohammed Badaru step down on Monday. Na through letter wey presdo send give Senate Presdo Godswill Akpabio for Abuja, dem take announce di new pick and confirm say Musa na di man to run Defence waka next. General Musa,wey be 58 years old, serve as CDS from 2023 reach October 2025, and di […]

todayDecember 2, 2025 21 1

National

Bandits Don Waka Adamawa Community For Sokoto, Burn Houses and Shops

Bandits don bring dia werey come anoda attack for Adamawa community for Kalgo Ward, Sabon Birni LGA, Sokoto State, dem even burn three houses and one shop, dey waka waka dey put fear for pipo mind up and down. Di gbege burst yesterday night, but We thank God say dem no carry and kill anybody as dem dey do dia yeye operation. Among di house wey dem burn na dat of one Malam Ila, di oga of di village, and […]

todayDecember 2, 2025 12

Entertainment

PORTABLE VEX – DRAG JUMA JUX FOR SECRET NAIJA COLLABO!

By: Alice Iduh Portable don fire shot for social media as e call out Tanzanian singer Juma Jux for enter Naija coded and drop song with Ekunrawo without even hail am. Na for him Instagram page, the controversial street singer para troway, demand say dem must create space for am on the new track “Halima.” Portable talk say Juma Jux sneak enter the country and e no dey okay say dem run collabo behind am. As the tori land online, […]

todayDecember 2, 2025 10

Business

Minister Keyamo: Aviation Tax Removal No Be My Decision Alone

By: Esther Ayoola Minister of Aviation and Aerospace Development, Festus Keyamo, talk say to remove tax for aviation sector no be wetin one person fit decide. E yarn say any policy like that need government collective approval and go through legislative review. Keyamo yarn this one for Abuja on Monday as dem dey celebrate 100 years of aviation for Nigeria. E clear say, even though industry dey complain say too many taxes dey, na no be only Aviation Ministry matter […]

todayDecember 2, 2025 6

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app