Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

Ogun kidnap, Chinese workers Magbon, 35 Artillery Brigade, Mowe site attack

By : Jolayemi Olajide Di Nigerian Army don konfam say one soldier, one local hunter and four kidnapped victims kpai during a kidnap attack wey hapun for the Capo sand-digging site in Magbon, Mowe, Ogun State, early Monday morning. Army spokesperson, Lieutenant Colonel Appolonia Anele, naim dey clear dis mata on Tuesday say suspected kidnappers storm the site to gbab Chinese workers and engage di security operatives like say na war film. According to her, one soldier kpai and another […]

todayJune 9, 2026 33

obodo oyinbo

Iran Drag US Over World Cup Ticket Wahala

By : Jolayemi Olajide Iran Football Federation don accuse United States say dem withdraw di World Cup tickets wey belong to Iranian fans just few days before di 2026 tournament start. Di federation say FIFA rules give every participating country 8 percent of match tickets, but dem suddenly collect Iran own allocation back after fans don already buy tickets and make travel plans. Dem also complain say visa wahala don stop about 15 officials from entering America, adding to di […]

todayJune 9, 2026 19

Lagos

How Domingo Adeleke Go Kpai For Switzerland

By : Jolayemi Olajide Nor be small cry Naija delegation dey cry for Geneva, Switzerland , say Lagos State Join bodi tuk, tuk, Council Chairmo, Domingo Michael Adeleke, kpai on Tuesday. Adeleke travel go Switz to represent Naija workers for the 114th Session of the International Labour Conference before brief sickness wire am down. Na One top official of the Nigeria Labour Congress (NLC) konfam di sad update, hailing Adeleke as one solid fighter wey die for workers matter. However […]

todayJune 9, 2026 20

Lagos

Lagos Apc Choose State Deputy Woman Leader Damilola James As Hamzat Running Mate

By : Jolayemi Olajide Lagos State APC don formally announce di party state Deputy Woman Leader, Princess Damilola James, as di running mate to dem gofnorship candidate, Dr. Obafemi Hamzat, ahead of di 2027 election. Oga Lagos APC Chairmo, Cornelius Ojelabi, naim break di news inside statement on Monday, revealing say di choice of di Badagry-born princess, na based on agreement wey di house agree. Ojelabi hail madam Damilola, say she get solid doins, leadership power, and strong grassroots background […]

todayJune 9, 2026 32

National

Kebbi Govo Extend Retirement Age For Doctors, Medical Workers

By: Esther Ayoola Kebbi State Governor Nasir Idris don approve new retirement age for medical and veterinary doctors, as dem now go retire for age 65, instead of di nromal 60. Di decision hapun during Kebbi State Executive Council meeting wey dem hold on Monday for Government House, Birnin Kebbi. Commissioner for Establishment, Pension and Training, Auwal Dogondaji, naim make dis announcement while e dey brief journalists afta di meeting. According to gornment, di new policy go affect doctors and […]

todayJune 9, 2026 25 1

obodo oyinbo

JOHESU Threaten Fresh Strike, Say Federal Govment Nor Pay Health Workers Better Salary

By: Esther Ayoola Gbege dey oh, our number one bodi mata pipo, Joint Health Sector Unions don dey warn say dem go strike oh, as Federal Gornment nor gree do wetin dem to increase dia salary. Na dia National Chairmo, Kabiru Minjibir, dey sorosoke dis tori to journalists on Tuesday for dia 114th International Labour Conference for Geneva, Switzerland. According to am, health workers don dey fight for di salary adjustment for more than 10 years, despite plenty meetings and […]

todayJune 9, 2026 13

General

How Kidnappers Dey Target Victims Through Social Media

For old days, if kidnappers wan pick person, dem go need informant, follow person physically, or get insider wey know di victim well well. But nowadays, things don change. Na so-called “harmless” social media post don turn their biggest tool. Plenty criminals no even need stress again, na victims dey give dem full informate like gift. Security experts don warn say kidnappers and other criminals now dey use Facebook, Instagram, TikTok, Snapchat, WhatsApp Status and other platforms take monitor pipo, […]

todayJune 9, 2026 37

Sports

Chelsea, Man City Drag Over Maresca Deal For Guardiola Job

By: Esther Ayoola Chelsea and Manchester City negotiations for Enzo Maresca to replace Pep Guardiola don enter go slow because of compensation mata. Guardiola don already announce say im go leave City afta many successful years, and City want Maresca take over. But Chelsea dey insist say dem suppose pay money because Maresca sti get contract with dem before he comot Stamford Bridge. As things stand, both clubs sti dey drag as legal and financial issues dey slow di deal.

todayJune 9, 2026 25 4

Sports

Edo Queens Hammer FC Robo 4-1 For Super Six Clash

By: Esther Ayoola Edo Queens of Benin don beat FC Robo 4-1 for dia second match of di 2026 NWFL Premiership Super Six wey happen for Port Harcourt. Dem bin lose dia first game 1-0 to Nasarawa Amazons, so, dem need dis win to stay inside competition. Esther Moses open scoring for 15th minute, while Chioma Moses add second goal before halftime to put Edo Queens ahead. For second half, Precious Oscar and Mary Mamudu complete di 4-1 victory with […]

todayJune 9, 2026 23

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds