Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

Kwankwaso Dump NNPP, Join ADC for Kano State

Di 2023 NNPP presidential candidate and ex-Kano governor, Senator Rabiu Kwankwaso, don officially join African Democratic Congress (ADC) on Monday, March 30, 2026, for Gidan Kwankwasiyya, Miller Road, Bompai, Kano. Kwankwaso register with di party and collect im membership card in front of top politicians like ADC chairman David Mark, Aminu Tambuwal, Rotimi Amaechi, Peter Obi, Dino Melaye and John Odigie-Oyegun. Although Kwankwaso no fully explain why, but say im dey align with other opposition leaders to strengthen ADC ahead […]

todayMarch 30, 2026 8

OBODO NAIJA

Tuggar Dump Foreign Affairs Job, Set Eye for Bauchi Governor Seat

Oga Minister of Foreign Affairs, Ambassador Yusuf Tuggar don resign from im position to follow im political plan to run for Bauchi State governor. Di ministry tuk tuk, Kimiebi Ebienfa, na im dey konfamate di resignation on Monday. Before now, report bin don show say Tuggar dey among four ministers for President Bola Tinubu cabinet wey go resign to pursue political ambition. Even di minister media aide, Alkasim Abdulkadir, don earlier tuk say Tuggar dey prepare to contest for Bauchi […]

todayMarch 30, 2026 6

National

WAEC Release 2026 WASSCE Timetable, Exam Go Start April 21

By: Esther Ayoola WAEC don release di official timetable for 2026 West African Senior School Certificate Examination (WASSCE) for school candidates, di council yan on im official X page on Monday. According to a post on WAEC website, di exam go start on Tuesday, April 21, 2026, and go finish on Friday, June 19, 2026. Di first tin wey dem go write na Foods and Nutrition 3 (Practical) Planning Session and Home Management 3 (Practical) Planning Session.

todayMarch 30, 2026 7

obodo oyinbo

Trump Promise To Hit Iran Oil Sites, Asking Dem To Agree Peace Deal

By: Esther Ayoola U.S president, Donald Trump, say e fit "destroy" Iran power plants and oil wells if dem no agree peace deal. During him latest statement from Washington, oga Trump say US dey do "serious" tuks with di "new and more reasonable" Iran gornment, but warn say if ceasefire no happen, dem go strike sites wey dem never touch before. Trump also threaten Kharg Island, di major fuel hub for Persian Gulf, like dis e dey tell Iran to […]

todayMarch 30, 2026 3

obodo oyinbo

Canada To Package New Rules For Nigerians

By: Esther Ayoola Canada don bring new law wey go change how people dey enter and seek asylum for di country. Di law, wey dem call Bill C-12, dem pass am on March 26, 2026, and e get stricter rules for asylum seekers as dem take post am for dia immigration website. Say If person try claim asylum afta one year wey e first enter Canada from June 24, 2020, di Immigration and Refugee Board nor go accept Di law […]

todayMarch 30, 2026 5

National

Ondo Gorment Campaign Against Political Jaguda Boys

By: Esther Ayoola Ondo State Gornment don raise alarm, condemn as some pipo dey tear political campaign materials across di state. Senior Special Assistant to di Governor on Signage & Advertisement, Yomi Oyekan, tuk dis on Monday say some political actors dey destroy rival candidates materials on purpose. Di Ondo Gornment dey say na serious crime wey dey threaten democracy and fair competition, and dem get intelligence on those wey do dis badness. Like dis say, dem don alert security […]

todayMarch 30, 2026 3

National

Court Stop Turaki PDP Faction, Order Protection For Wike People

By: Esther Ayoola Di Federal High Court (FHC) for Abuja, on Monday, don ban di Kabiru Turaki-led PDP leaders from enter di party national secretariat. Justice Joyce Abdulmalik, wey deliver di judgment, tuk say like dis now di Wike-led faction of di party go get protection from police, DSS, and other security agents while dem dey access di secretariat. She also say di convention wey Turaki faction hold for Ibadan on Nov 15-16, 2025, and di election wey dem conduct […]

todayMarch 30, 2026 4

Sports

Premier League Fans Vote Against VAR Say E Dey Spoil Football

By: Esther Ayoola Say like dis now, Plenty fans wey dey support Premier League clubs dey complain say VAR don spoil dia matchday enjoyment. Dis na according to one survey wey Football Supporters’ Association (FSA) do on Monday across England. Di survey, wey collect response from almost 8,000 fans from all 20 Premier League clubs, show say over 90% of dem believe VAR don make stadium experience worse. Say about 91% of fans tuk say VAR don kill di joy […]

todayMarch 30, 2026 6

National

INEC Recognise Wike Camp, Publish New PDP Leaders For Website

By: Esther Ayoola Say like dis INEC don recognise di faction of PDP National Working Committee wey Nyesom Wike dey support, and dem show am for dia website on Monday for Abuja. According to di electoral body, dis move na to update Nigerians on di korrect leadership of Pipos Democratic Parti afta di party convention. Dem list Abdulrahman Mohammed as National Chairman and Samuel Anyanwu as National Secretary, plus oda members of di NWC. Dis leaders emerge on Sunday night […]

todayMarch 30, 2026 5 2

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app