Blog masonry

Background

Lagos

LASTMA Give Report Say Na 69 Kpai, 246 Wunjure For Lagos Road Crash Q1 2026

By: Esther Ayoola Lagos State Traffic Management Authority tuk say na about 69 pipo don kpai like dis for road askident across Lagos between January and March 2026, while 246 others get wunjuries. LASTMA General Manager, Olalekan Bakare-Oki naim yarn dis one for interview with News tatafo on Sunday. Say drivers just dey drive wawa and naim dey cause all these askidents. E sti tuk say dem clear over 600 accident scenes and handle more than 900 truck-related offences, plus […]

todayApril 27, 2026 26

National

FG To Ban Unrated Textbooks For Schools From September 2026

By: Esther Ayoola Federal Government of Naija don announce say dem go introduce National Textbook Ranking System for primary, junior and senior secondary schools to improve education standard for Naija. Director of Press for Ministry of Education, Folasade Boriowo, naim dey tuk dis one for statement on Sunday, say, di plan na to stop bad textbooks from entering classrooms. She explain say Nigerian Educational Research and Development Council go dey in charge of approving textbooks, while dem go rank all […]

todayApril 27, 2026 21

National

Kano Gorment Advice Dia Youths Over Shameful Behaviour Before First Lady

By: Esther Ayoola Kano State Govo, Abba Yusuf don condemn di action of some youths wey reportedly show dirty character of giving underwear to women, during an official visit of Oluremi Tinubu for Kano State Naija. For statement wey Govo Chief Press Secretary, Mustapha Muhammad release on Sunday, Yusuf tuk say di behaviour nor represent Kano culture at all. E yarn dis one during Third Special Prayer for lasting peace for Gornment House, where 4,444 Qur’anic reciters gada pray for […]

todayApril 27, 2026 28

Lagos

How Lagos Gorment Enter 60MW Power Deal With 3 Electricity Company

By: Esther Ayoola Lagos State gorment, don do small megege movement sign Power Purchase Agreements with three companies, Fenchurch Power, Mainland Power and Viathan Group to generate about 60MW electricity for di state. Senior man govo, Babajide Sanwo-Olu naim lead di way, put dis one for statement on Sunday, say di agreement as part actions to improve power supply under Lagos Electricity Law 2024 and Nigerian Electricity Act. Di signing hapun for Lagos House, Marina, where state representative Abiodun Ogunleye […]

todayApril 27, 2026 21

obodo oyinbo

Suspected Shooter For Trump Dinner Arrange Bodi For Court Today

By: Esther Ayoola Di ogbonge senior gunman wey dem accuse say go scatta U.S Presido Donald Trump gala dinner for Washington D.C. USA on Saturday night, say like dis now go make first appearance for court today. According to U.S officials, say di suspect allegedly bin wan kpai Trump and other top officials during di press dinner before. Trump himself post video and pictures of how security agents rush am comot from ballroom, while surveillance video show gunman wey dey […]

todayApril 27, 2026 20

National

Army Explain How NYSC Member Take Kpai Robbery Operation for Abuja

By: Esther Ayoola Nigerian Army, through im Acting Assistant Director, Army Public Relations for Guards Brigade, Lt. Olawuyi Odunola, don konfamate say NYSC member Abdulsamad Jamiu sadly kpai during security operation against armed robbery for Abuja. Di incident hapun for early hours of April 25, 2026 for Shagari Estate, Dei-Dei inside Federal Capital Territory. According to wetin Army tuk, Guards Brigade Quick Response Group wey dey do routine night patrol hear distress call say armed robbers dey operate for di […]

todayApril 27, 2026 30

National

FG Start Move To Calm Aviation Wahala As Fuel Price Scata Airline Operations

By: Esther Ayoola Minister of Finance, Taiwo Oyedele, and Aviation Minister, Festus Keyamo, don finally meet demsevles for Abuja to tuk how dem go take solve di rising cost of aviation fuel wey dey affect airline operations. According to Oyedele,  say dem get constructive discussion on how di sharp increase in Jet A1 fuel dey push airlines under pressure and dey cause higher ticket prices. Say dis meeting  na to find ways gornment go fit take reduce di pressure on […]

todayApril 27, 2026 18

Education

Viral 394 UTME Result Na Fake – JAMB

Di Joint Admissions and Matriculation Board don come out reject one UTME result wey dey trend for social media, say na fake oh. Dem say di result show one girl from Cross River, Okon Winniefred Sampson, scoring 394 out of 400, Jamb now dey tuk say dat kind result nor dey dia system. According to JAMB spokesman, Fabian Benjamin, di result slip na fake result. Fabian still beg Nigerians make dem dey careful of fake information online.

todayApril 27, 2026 29

Politics

Opposition Parties Reject Ibadan Summit

Branches inside Peoples Democratic Party, African Democratic Congress, Accord Party and Labour Party don reject di Ibadan opposition summit, say e dey one sided. Dem tuk say dem go still bring separate candidates to challenge Bola Tinubu for 2027 election. PDP National Working Committee, with support from Nyesom Wike, accuse dia members say dem be  “imposters” wey dey deceive leaders like Atiku Abubakar and Peter Obi. Meanwhile, ADC groups, Accord Party and Labour Party leaders don also deny involvement, warn […]

todayApril 27, 2026 24

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds