Blog masonry

Background

National

President Tinubu Give APC Govos Order to Make Primary elections Free and Fair

By: Esther Ayoola President Bola Tinubu don direct all APC governors for di 31 states say make dem ensure say party primaries dey free, fair and  as dem follow Electoral Act. Him tuk  dis one afta a close door meeting with APC govos for State house, Abuja, say di aim na to keep di unity and togetherness. Explaining wetin dem discuss for di meeting, Kwara State Governor AbdulRahman AbdulRazaq and Niger State Governor Mohammed Bago touch light every say baba […]

todayApril 24, 2026 29

National

Baba Presido, Tinubu Backs Gulf Nations, Pray for Peace Over US/Israel–Iran Crisis

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Ahmed Tinubu, say  like dis Naija stand solid with Gulf countries wey dey face tension because of US and Israel wahala with Iran. Di Naija number one states man tuk dis one for State House, Abuja, when e  receive Letters of Credence from new ambassadors and high commissioners from different parts of di world, including Qatar and Saudi Arabia. Baba seyi praise di  countries wetin nor good say dem try wella,  as dem […]

todayApril 24, 2026 16

National

Police Arrest 29-Year-Old Ondo Man, Say Im Hide Human Bones For House

By: Esther Ayoola Police for Ondo State police command don do Rambo arrest one 29-year-old man, Awomehinde Tope, for Ile-Oluji area after allegation say im go thief im papa property. Police tuk, tuk person, Abayomi Jimoh, naim dey convasate dis mata  say di reason for di arrest be say, di suspect allegedly carry away tins like motorcycles, goats, palm oil, phones, gas cylinders, gold items and rugs from im father. Jimoh sti explain say as police dey investigate, dem discover […]

todayApril 24, 2026 26

National

Oyo Police Gbab 3 Jaguda Boys Say Dem Be Suspected Kidnappers

By: Esther Ayoola Oyo State Police command do small James Burn arrest three suspected kidnappers wey dem link to di kidnapping of one woman, Marian Remi, for Ido Local Government Area. According to statement by police tuk, tuk, Olayinka Ayanlade, Di suspects, Musa Ajibola, Hassan Mohammadu, and Umaru Hassan, dem catch dem on April 21 for Latayo Farm Settlement, Ile-Idu, after pipo give police correct intelligence informate. Police tuk say, di men get hand for di kidnapping and later release  […]

todayApril 24, 2026 22

Lagos

Lagos Train DSNOS To Step Up Disease Watch, Turn Data To Quick Action

By: Esther Ayoola Lagos State Ministry of Health don train Disease Surveillance and Notification Officers (DSNOs) to improve early detection, reporting and response to health wahala. Oga  Permanent Secretary, Dr Dayo Lajide, naim dey explain dis for news tuk, say dem really need to train persons even with plenty logistics challenges. Di training wey get di theme “From Data to Action: Hands-on Surveillance Evaluation Using Case-Based Approaches” bring together health workers, lab scientists and development partners. E also press yarns […]

todayApril 24, 2026 20

Lagos

Obasa Back Hamzat For Governor, Beg Party Members To Support Am

By: Esther Ayoola Lagos State House of Assembly Speaker, Mudashiru Obasa, don declare say im dey support  Deputy Governor, Dr Obafemi Hamzat, for governorship  2027. Obasa tuk dis one when Hamzat visit am for im official residence for Ikeja on Thursday as part of im consultations with APC leaders. Di Speaker praise Hamzat commitment to infrastructure development and im loyalty to APC party. E sti call on party members and stakeholders make dem support Hamzat for di governorship race.

todayApril 24, 2026 30

Sports

NFF Wan Make Osula Play For Super Eagles

Nigerian Football Federation (NFF) don enter William Osula matter, dey try convince am make e switch play for Nigeria national football team. Osula, wey dey play for Newcastle United for Premier League, fit play for Nigeria through im papa side. Di 22-year-old get Danish mama and French-Nigerian papa. Even though e don play for Denmark youth level before, e still dey show say im get strong link to Nigeria.

todayApril 23, 2026 32

obodo oyinbo

Iran Tankers Still Dey Pass US Blockade For Hormuz

According to Financial Times report on Wednesday, at least 34 tanker ships wey get link to Iran still dey waka pass Strait of Hormuz for recent days, even though US dey block di Strait. But US Presido, Donald Trump sti talk say America “fully control” di Strait of Hormuz, and claim say di blockade strategy dey work well well. On April 13, US put blockade wey dem talk say go “totally jam” all sea trade wey dey enter and comot […]

todayApril 23, 2026 34

OBODO NAIJA

Senator Oluremi Tinubu Launch Federal Government Industrialisation Programme for Kano

Senator Oluremi Tinubu don launch “Energise Commercialisation Now” programme, wey go help turn research ideas to real money and industry for Nigeria on Thursday for Kano State. Di initiative na Federal Government plan to push innovation, attract investors, and boost production for all six geo-political zones. Di event wey carry theme “From Innovation to Industry” dey try close gap between ideas for school and research centres and how dem go enter real market and industry. Mrs Tinubu talk say Nigeria […]

todayApril 23, 2026 15

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds