Blog masonry

Background

obodo oyinbo

US Accuse China Group Of Trying To Steal American AI Tech

White House science and tech boss, Michael Kratsios don accuse China-linked groups, say dem dey try steal American AI technology. Dem accuse dem say na through “distillation” and other hacking-style methods dem take dey copy powerful AI systems wey companies like OpenAI and Anthropic build, to catch up with US innovation. Dis accusation dey come as tension sti dey rise between US and China ahead of planned leaders’ meeting for Beijing, where both sides fit discuss tech and security issues.

todayApril 24, 2026 29

Sports

FIFA Hold Ground Say Iran Go Sti Play Di World Cup, Cancel Italy Replacement Tuk

By: Esther Ayoola FIFA don clear matas, say dem nor get plan to replace Iran with Italy for di upcoming World Cup dis summer. According to football experts, di idea first come from US special envoy Paolo Zampolli wey suggest say Italy suppose take Iran spot for di tournament. Dis mata don cause plenty argument online because of di war between US, Israel and Iran. But FIFA president Gianni Infantino still konfamate yesterday, say Iran team go sti enter di […]

todayApril 24, 2026 27 2

Lagos

Lagos AG Tuk Why Dem Free Di Suspects Of Owode Killings, Say Evidence

By: Esther Ayoola Lagos State Attorney-General, Lawal Pedro, don explain why Lagos gorment free di suspects wey bin dey dia net for di killing of six traders for Owode Onirin, dat gornment no dey hide anybody wey dey  involve. E say decision not to charge di suspects na because akelebe investigation no show clear evidence wey  link them to di crime. According to am, di black uniform men, wey we sabi as police send di case file give Ministry of […]

todayApril 24, 2026 30

National

Atiku Knack Alarm As Tinubu Seek $516m Loan For Sokoto–Badagry Road

By: Esther Ayoola Former Vice Presido, Atiku Abubakar don raise concern say why Presido, Bola Tinubu go send request give Senate for Abuja make dem approve $516 million external loan. Di senior man put dis for news statement on Friday wey him aide Phrank Shaibu release, U sabi say, Senate Presido Godswill Akpabio read di president loan request letter for plenary yesterday. Tinubu say im need di loan to fund Sections 1, 1A and 1B of Sokoto–Badagry Super Highway wey […]

todayApril 24, 2026 21

Sports

Coventry Boss Dismiss Report Wey Link Frank Lampard To Chelsea, Say No Shakement

By: Esther Ayoola Coventry City oga Doug King don scatta mouth say e nor dey shake about gist wey dey link coach Frank Lampard to return to Chelsea FC. E beg fans make dem no allow rumor distract dem, say di club sti dey focus on dia long-term plan afta dia promotion to di  Premier League. Say Lampard dey run clean job for Coventry, as e carry dem win EFL Championship title and bring dem back to top flight afta […]

todayApril 24, 2026 25

National

FG Raise Allowances, Ginger Civil Servants Welfare

By: Esther Ayoola Say like dis Naija Federal Gornment don approve increase allowances and oda welfare packages for civil servants, to boost dia living Head of Civil Service of the Federation, Didi Walson-Jack, naim yarn dis one on Friday for Abuja during press briefing, say Federal Executive Council don approve di reforms. She explain say di new arrangement go affect workers under CONPSS and CONRAISS salary structures, so e go cover many categories of civil servants. According to her, di […]

todayApril 24, 2026 16

National

FG Add Fresh Charges for El-Rufai Case, Say Im Tamper with National Infrastructure

By: Esther Ayoola Federal Gornment, through Department of State Services and dia lawyer Oluwole Aladedoye, on Thursday for Federal High Court Abuja,  don add new charges against former Kaduna governor Nasir El-Rufai. Say im interfere with critical national infrastructure and access classified information without approval. Dem file di korectted version of five-count charge on April 13, 2026, to replace di earlier three-count charge wey dem first bring come on February 16, 2026, to take strengthen dia case against di man. […]

todayApril 24, 2026 25

National

Governor Bala Mohammed Declare Imself “Freelance Politician”

By: Esther Ayoola Bauchi State Governor Bala Mohammed don sake table   say im na “freelance politician” based on di PDP leadership katakata. Im yarn dis one afta im meet former presidential candidate Peter Obi for Bauchi, as dem discuss 2027 election plans. Im agree say both PDP and ADC dey shake oh, , and dat dem dey look to di  judiciary, while dem still be opposition party for di 2027 election.

todayApril 24, 2026 23

National

APC Shift 2027 Presidential Primary Go May 23

By: Esther Ayoola Deputy National Publicity Secretary of APC, Duro Meseko, tuk on Thursday for Abuja say di party National Working Committee don shift dia 2027 presidential primaries from May 15 go May 23. Untop yarnings with newsmen, E explain say dem take di decision afta dia 186th NWC meeting wey hapun for di capital. According to am, di party sti open Expression of Interest and Nomination forms for all aspirants wey wan contest any position. Meseko say di change […]

todayApril 24, 2026 15

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds