China Foreign Minister, Wang Yi, say Beijing ready to hellep protect Iran rights as e meet Iran Foreign Minister, Abbas Araghchi, on Wednesday for China.
Wang say China ready to tok and work with Iran and make sure say Iran legitimate right dey protected.
Di meeting come as China dey try help find way to settle di war between Iran and America.
Di talks happen one week before China Presido, Xi Jinping, dey expected to travel go Washington to meet US Presido, Donald Trump, and di Iran war go dey among di major issues wey dem go discuss, alongside trade and competition on top artificial intelligence.