Blog masonry

Background

National

Wike Branch Of Di PDP Tell Members To Ignore Wetin Parti BOT Tuk

By: Esther Ayoola Di Federal Capital Territory (FCT) Minister, Nyesom Wike-backed National Caretaker Working Committee (NCWC) of di Peoples Democratic Party (PDP), don ask party members make dem no mind any wahala or misleading tori wey dey about di party leadership. Di NCWC National Publicity Secretary, Jungudo Mohammed, tuk dis one for Abuja on Sunday as dem dey yarn about wetin dey hapun for di party leadership and di coming national convention. Mohammed say Federal High Court and Appeal Court […]

todayMarch 23, 2026 7

National

Peter Obi Call Nasir El-Rufai Arrest Political Bad Belle

By: Esther Ayoola Di 2023 Labour Party (LP) presidential candidate, Peter Obi, don drop other bombshell say di arrest and detention of former-Kaduna State Govo Nasir El-Rufai say e no make brain and dat na political persecution. Obi tuk dis one for Sunday when e dey meet African Democratic Congress (ADC) stakeholders for Kaduna. E say, di way ICPC dey hold El-Rufai dey worrisome, and na concern to democracy and rule of law for Naija.

todayMarch 23, 2026 6

National

First Lady Oluremi Address Di Ozoro Festival Isuues

By: Esther Ayoola Wife of Oga Presido, Senator Oluremi Tinubu, don condemn di way Jaguda boys take abuse some women and girls during di Alue-Do cultural festival for Ozoro, Isoko North LGA, Delta State on Sunday. She put for statement, say di viral video show di girls suffer barbaric and degrading treatment for wetin suppose be normal community celebration. Senator Oluremi hail di police wey don make some arrests and urge di authorities to make sure say, all di perpetrators […]

todayMarch 23, 2026 6

National

Makinde, Bala, Obi, Kwankwaso Hold Secret Meeting For 2027 Election

By: Esther Ayoola Opposition Govos, Seyi Makinde and Bala Mohammed on Sunday don buy waka meet with Seriake Dickson for Bauchi as tuks on PDP leader jam rock. Afta di meeting, Makinde and Dickson waka go see former kano state govo, Rabiu Kwankwaso and Peter Obi, wia dem do small political waka One source wey dey close to Kwankwaso, wey no wan make dem call im name, tuk say di real reason na to discuss possible alliance and strategy for […]

todayMarch 23, 2026 5

National

Ondo Police Gbab Jaguda Rape Suspect

By: Esther Ayoola Ondo State Police Command dem waka one ogbonge waka arrest one 21-year-old man, Alabi Anthony, for allegedly raping and kpaing a woman, Olaseni Veronica, for Iboropa community, Akoko North-East Local Government Area. Command’s tuk, tuk, DSP Abayomi Jimoh, say di suspect dem go catch am following intelligence, and dat na di victim wey dem track her missing phone na dem take succeed gbab di suspect. Oga Jimoh say di suspect even confess say im commit crime by […]

todayMarch 23, 2026 4

Lagos

Army Chief Explain Why Troop Must Eat Belle Full To Tackle Insecurity

By: Esther Ayoola Di Chief of Army Staff, Lieutenant General Waidi Shaibu, like dis don yan say welfare of soldiers and officers na im be im main priority to fit fight insecurity. E tuk dis one on Saturday, during Eid-el-Fitr lunch wey dem hold for Forward Operating Base, Epe, Lagos. Shaibu explain say dem go improve living conditions, give professional training, support family, and treat all soldiers well to boost morale and confidence. He sti yarn say dis 2026 Eid […]

todayMarch 23, 2026 5

Lagos

Lagos CP Olohundare Promise To Remove Taskforce Wey Abuse Go Office

By: Esther Ayoola Lagos State Police Commissioner, Olohundare Jimoh, don tuk now say, e no go hesitate to dissolve any task force wey personnel dey violate human rights. Jimoh tuk dis one on Saturday as e dey brief journalists for Ikeja headquarters. Dis come afta one video wey dey online show how traffic officer abuse traffic offender. But di police oga say nothing show say dem abuse or shame di person say, if dem see any wrong doings dem go […]

todayMarch 23, 2026 5

Lagos

Governors Forum Tell Oga Presido Dia Plans On State Police

By: Esther Ayoola Naija Governors Forum like dis now say, dem don give dia own idea for di proposed state police to National Security Adviser, Mallam Nuhu Ribadu, wey go carry am go National Assembly. NGF Chairmo wey be Kwara State Governor, Abdulrahman AbdulRazaq, tuk dis one when e meet President Bola Tinubu for im house for Ikoyi, Lagos. AbdulRazaq say tuks on state police sti dey go on with different security organisations, and NGF don put dia own contribution. […]

todayMarch 23, 2026 4

Lagos

President Tinubu Link Up With Macron, France To Fight Terrorists

By: Esther Ayoola Wi oga Presido Bola Tinubu like dis now dey say Naija get agreement with France Presido, Emmanuel Macron, to support our military with ogbonge equipment and training. Oga Presido yarn dis one when he dey tuk with governors for him Ikoyi house for Lagos afta him come back from UK trip. Baba Seyi say Naija ready to use di good relationship and gbese wey we get to buy beta equipment for security forces. Say Na to make […]

todayMarch 23, 2026 2

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app