Blog masonry

Background

Sports

Cristiano Ronaldo Vow Say E Go Win More Trophies, Chase 1,000 Goals

By: Rilwan Agbomeji Football superstar Cristiano Ronaldo don vow for ground, say e wan win more trophies and reach 1,000 career goals before im retire finally. Ronaldo yarn dis one for Globe Soccer Awards wey hold for Dubai on Sunday, say e still get passion to play no matter where e dey,Europe or Middle East. E add say e go reach the 1,000 goals target if wunjury no worry am.

todayDecember 29, 2025 13

foreign

Trump To Meet Netanyahu For Florida To Align Gaza Ceasefire Talks

By: Rilwan Agbomeji US Presido Donald Trump wan enter meeting with Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu for Mar-a-Lago, Florida, today, to popori one or two on how dem go take address di Gaza ceasefire. Dis meeting come as US dey push Trump 20-point peace plan, even as Israel dey break di peace agreement almost every day. Meanwhile, Israel don increase attacks for West Bank, Lebanon and Syria, and some officials dey talk say anoda war with Iran fit start.

todayDecember 29, 2025 10

Lagos

Lagos APC Go Start E-Registration For 20 Local Government Areas

By: Rilwan Agbomeji Lagos State APC don announce say dem go start electronic registration and revalidation for party members across di state. Di e-registration exercise go run from January 5 reach January 28, 2026 for all 20 local govment areas of Lagos. APC Lagos Chairman, Pastor Cornelius Ojelabi, talk dis one for end-of-year briefing with journalists for Lagos. E talk say di move dey meant to strengthen di party structure and build correct, verifiable database ahead of future elections.  

todayDecember 29, 2025 10

National

Atiku Pray For Anthony Joshua Afta Road Accident

By: Rilwan Agbomeji Former PDP presidential candidate, Atiku Abubakar, don send message of sympathy to British-Nigerian boxer Anthony Joshua afta road accident happen for Makun, Ogun State, on Monday. Atiku talk dis one through im official X handle, say e pain am well well and e dey pray make Joshua recover sharp sharp. According to am, Anthony Joshua still be symbol of strength and resilience, and e sure say e go overcome di situation. Atiku also condoled with families of […]

todayDecember 29, 2025 11

National

Defence Minister Musa Explain Experience Say God Save Im Face

By: Esther Ayoola Defence Minister, Gen. Christopher Musa (rtd), don comout explain wetin im experience as military head, say people conspire against am and think say dem don win, but na God intervene and lift am up. E tuk dis one during church service for Conquerors Global Assembly for Abuja, where e go with im wife on Sunday. Musa explain say e decide share di testimony to thank God and encourage people to trust God even when things hard. According […]

todayDecember 29, 2025 4

National

Resident Doctors Tell FG The Truth, Promise Fresh Strike

By: Esther Ayoola Naija resident doctors (NARD) don send SMS give wi federal gorment say dem go stop work if  FG never respect agreement wey dem sign. NARD secretary-general, Dr. Shuaibu Ibrahim, post urgent message for X on Sunday, beg senior doctors make dem hold first giving wi federal gorment 29 days from today. NARD tuk say na FG and ministry of health be di wahala, and if dem no wake, strike go hapun, indefinite, and nationwide strike.

todayDecember 29, 2025 6

National

Peter Obi Ready Kaya To Join ADC

By: Esther Ayoola Presidential hopeful Peter Obi, according to report go soon officially join African Democratic Congress (ADC). According to one principal official of Labour Party for Abuja, ahead of 2027 general election, Obi go formally declare im move on December 31 for Enugu, wey be South-East political capital, after im supporters don start arrangement for di rally. According to di source, ADC ask Obi about three weeks ago make e finally decide, and na why e go meet party […]

todayDecember 29, 2025 7

obodo oyinbo

Russian Attack Wunjor Three For Kharkiv, Ukraine

By: Esther Ayoola Nor be small tin, say Russian send bomb to Sloviansk for eastern Ukraine kill at least one person dead and five others wunjor. According to Donetsk region military oga, di attack happen for area wey ukraine government still dey control for di war-torn region. Dis one dey come for wia, US president Donald Trump and Ukraine leader Volodymyr Zelenskyy tuk say peace deal don dey make sense small after dem meet for Florida, forgetting say land matter […]

todayDecember 29, 2025 3

Sports

Lagos Boxing Hall Of Fame Train Boxing Talent

By: Esther Ayoola Lagos boxing hall of fame don show workings again, say dem go use monthly tournament, take build young fighters for world stage. For di 2025 edition, Faruk Ajibuwon, African youth games gold medalist, grab best boxer of di year and pocket ₦1 million, tie governor belt for wast, after im beat Osun’ state Malik Onifade for men’s 50kg. U sabi say, LBHF don produce big names like Taiwo “esepo” Agbaje, WBF intercontinental champ wey start from the […]

todayDecember 29, 2025 4

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app