Blog masonry

Background

Lagos

Tinubu, Sanwo-Olu, Other Big Men Celebrate 73rd Eyo Festival For Lagos

By: Esther Ayoola Over di weekend, nor be small flex for wi oga Presido, Bola Tinubu, Imo State Governor Senator Hope Uzodimma and other big people joinbodi with Lagos State Governor Babajide Sanwo-Olu  flex, say dem dey celebrate di 73rd Eyo Festival for Lagos on Saturday. Di festival wey people dey call Adamu Orisa play, shelle  for Tafawa Balewa Square, if you see di agbada wey wi oga presido dek, you go clap. On behalf of di presido, governor Sanwo […]

todayDecember 29, 2025 6

National

FG Confirm Say New Tax Reform Laws Go Start January 1, 2026

By: Rilwan Agbomeji Federal Govment don confirm say dem no go reverse di new tax reform laws wey go start on January 1, 2026. Chairman of Presidential Committee on Fiscal Policy and Tax Reforms, Taiwo Oyedele, talk dis one on Friday afta e brief President Bola Tinubu for Lagos. E add say four tax laws don sign into law, and two of dem don already start since June 26, 2025.  

todayDecember 26, 2025 23 61

Sports

FIFA Reject NFF Appeal, End Super Eagles 2026 World Cup Dream

By: Rilwan Agbomeji Nigeria hope to qualify for 2026 FIFA World Cup don end afta FIFA reject di appeal wey NFF submit against DR Congo. Super Eagles bin lose di intercontinental playoff final for Rabat, Morocco on November 16, afta match end 1–1 and DR Congo win penalty 4–3. Nigeria argue say some DR Congo players no suppose play, but FIFA say all di players correct and no rule break happen. Di decision don confirm DR Congo qualification and end […]

todayDecember 26, 2025 22

Lagos

PDP Lagos Set 19-Member Caretaker Committee

By: Rilwan Agbomeji Di People’s Democratic Party, PDP for Lagos, don inaugurate 19 people caretaker committee wey go run di party marras for di state. Di party talk say di Congress for zone, ward, Local and National levels go hold on January 9, 2026. Di inauguration happen dis week under di leadership of PDP National Chairmo, Hon. Abdul-Raman Mohammed, represented by PDP deputy national secretary, Engineer Adedeji Doherty. Doherty tell di new caretaker committee make dem remain united and follow […]

todayDecember 26, 2025 11

National

Vice Presido Shettima Visit Bomb Victims For Gamboru Market Mosque

By: Rilwan Agbomeji Vice President Kashim Shettima don buy waka visit people wey wunjor for di bomb wey happen for Gamboru Market Mosque for Maiduguri, Borno State. Im go see dem wey dey hospital and carry sympathy message from Presido, Bola Tinubu and Federal Government begin share, share give dem. Shettima talk say government go still dey support di victims and dia families. According to security official report say at least five people  die, while 35 others dem injury during […]

todayDecember 26, 2025 17

foreign

US, Israel Clash As White House Push Phase Two Gaza Ceasefire Plan

By: Rilwan Agbomeji Say like dis, like dis, White House wan move pass phase one of Gaza ceasefire for January, but Israeli PM Benjamin Netanyahu dey resist, and im resistance dey cause serious wahala. US dey plan make Palestinian technocratic government run Gaza daily affairs, as part of phase two of peace plan. Dem still dey prepare multinational peace council and international security force to manage Gaza work and security. According to report, Trump fit announce di peace council for […]

todayDecember 26, 2025 10

National

Army Raise Alarm Over Fake DSSC 29 Recruitment Form

By: Rilwan Agbomeji Nigerian Army, through Acting Director of Army Public Relations Anele Appolonia, talk on Friday for dem official X page  don clear di air say nor be dem post  DSSC 29 recruitment advert wey dey circulate online na fake. Anele talk say Nigerian Army never announce or approve any Direct Short Service Commission or Short Service Commission recruitment for anywhere for Nigeria at dis time. Army warn Nigerians make dem no fall victim because scammers dey use di […]

todayDecember 26, 2025 12

Lagos

Just In: LASTMA Bring Out Two Deadi Body From Lagos Fire Scene

By: Rilwan Agbomeji Unto updates for di Lagos fire outbreak, say two men don die as dem rescue dem from di rubble of Great Nigeria Insurance House Plaza wey fire don destroy for Balogun Market, Lagos Island. Recall, di fire start for di fourth floor before e spread reach di sixth floor and later catch di oda floors plus di buildings wey dey around. One part of di plaza collapse during di blaze, wey trap some traders inside. Official from […]

todayDecember 26, 2025 15

National

President Tinubu Mourn Two Kano Lawmakers Wey Die Within One Hour

By: Rilwan Agbomeji Wi Oga Presido Bola Tinubu say, like dis dey cry seriouly over di death of two Kano State House of Assembly members. Di lawmakers, Aminu Ungogo wey represent Ungogo constituency and Aliyu Daneji wey represent Kano Municipal, die for different incidents within about one hour on Wednesday. Inside statement from im media tuk tuk, Bayo Onanuga, Tinubu call di loss sad, tragic and painful. E yarn say dia deaths don create big gap, wey go affect proper […]

todayDecember 26, 2025 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app