Blog masonry

Background

Lagos

Fire Burn Houses For Yaba, No Life Lost

By: Olabisi Olatunji Lagos State Gornment say no life lost after fire destroy cluster of makeshift houses for Abule-Oja, Yaba, on Wednesday. Di fire happen for Abudu Street by UNILAG Road before emergency agencies quickly respond. Firefighters and security operatives work together to stop di fire from spreading to nearby buildings. Lagos State Fire and Rescue Service, Federal Fire Service, UNILAG Fire Service, Police and LNSC join fight di inferno.

todayAugust 5, 2026 12

Lagos

ASUU Say Professors Salary Don Fall Below Secondary School Principals for Lagos

By: Esther Daniel ASUU on Wednesday for Lagos accuse Lagos State Gornment say senior professors for state owned universities dey earn less dan secondary school principals, as di union say dem never implement 2025 FG ASUU agreement wey suppose improve lecturers welfare. Di union branches from LASU, LASUSTECH and LASUED make di allegation during emergency press conference for ASUU Secretariat, LASU Ojo, because lecturers dey face poor salary, high tax deductions and hardship. ASUU Zonal Coordinator, Comrade Oluwaseun Babalola, appeal […]

todayAugust 5, 2026 10

OBODO NAIJA

Sultan Call For Stronger Community Policing To Fight Insecurity

By Olabisi Olatunji Sultan of Sokoto, Muhammad Sa’ad Abubakar, don call for stronger community policing as better way to tackle insecurity across Nigeria. Represented by Alhaji Adamu Lamido Sanusi on Wednesday for Kaduna, di Sultan say security agencies must work closely with local communities to stop crime. According to am, youths, imams and community leaders know dia areas well and fit help provide intelligence to fight banditry and kidnapping. Di Sultan also praise organisers of di Arewa Awareness Summit, say […]

todayAugust 5, 2026 19

Education

BUK Say Private Electric Bike Charging Don Stop As Light Money Too Much

By: Esther Daniel Bayero University Kano, BUK, on Tuesday ban charging of private electric motorcycles and other electric vehicles for all campuses because di practice don increase di school electricity bills, as management announce di decision through statement by Director of Public Affairs, Lamara Garba. Di university say for Kano say dem take di action after noticing say private owners dey use school power to charge dia vehicles, wey put extra financial burden on di institution. BUK explain say di […]

todayAugust 5, 2026 13

OBODO NAIJA

PFN Say Dem Go Continue To Preach For Buses Despite Fine Proposal

By: Olabisi Olatunji Pentecostal Fellowship of Nigeria President, Bishop Wale Oke, don vow say Christians go continue to preach inside commercial buses despite di proposed ₦50,000 fine under di FRSC Amendment Bill 2026. Oke tok dis one on Television Wednesday, say even if authorities arrest or jail dem, dem no go stop evangelism because na dia constitutional and religious right. Meanwhile, di Senate don clarify say di proposal no be new law, saying di provision don dey inside FRSC Act […]

todayAugust 5, 2026 10

Sports

Mohamed Salah Land Turkey Ahead Trabzonspor Move

By: Olabisi Olatunji Former Liverpool star Mohamed Salah don arrive Istanbul as fans give am warm welcome ahead of expected move to Trabzonspor. BBC Sport report on Wednesday say excited supporters receive di Egypt captain for Atatürk Airport. Salah leave Liverpool after nine successful years wey him score 257 goals for di club. Trabzonspor expected to announce di signing soon after agreeing terms with di free agent.

todayAugust 5, 2026 11

Sports

Chelsea Don Lead Premier League Transfer Spending Race With £217m

By: Esther Daniel Chelsea don become di Premier League club wey spend di highest money for dis summer transfer window, as Polymarket Sports report say di Blues don use £217 million sign new players to strengthen dia squad. Di West London club dey ahead of Tottenham Hotspur and Manchester City, as di two clubs spend £154 million and £121 million respectively for new signings during di transfer period. Chelsea don already bring in players like Morgan Rogers, Maxence Lacroix, Jordan […]

todayAugust 5, 2026 10

OBODO NAIJA

Presidency Fire Back As Donald Duke Criticise Lagos-Calabar Highway

By: Olabisi Olatunji Presido don reply Donald Duke after him question di N15 trillion Lagos-Calabar Coastal Highway project. Presidential aide Temitope Ajayi tok on Wednesday say di project remain important despite di criticism. Donald Duke, during Arise TV interview on Tuesday, argue say di money fit solve problems for oda sectors instead. Duke also claim say di highway no go pass Epe and say road already connect Lagos to Calabar.

todayAugust 5, 2026 10

OBODO NAIJA

WAEC Withhold 167,486 WASSCE Results Over Exam Malpractice

By: Olabisi Olatunji WAEC don withhold 167,486 results of candidates wey write di 2026 WASSCE over alleged examination malpractice. WAEC Nigeria Head, Dr Amos Dangut, announce di release of di results on Wednesday for Lagos. According to am, use of mobile phones and organised cheating for some schools cause di affected results. Di withheld results represent 8.59 percent of candidates, lower than di 9.7 percent recorded for 2025.

todayAugust 5, 2026 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds