You sabi dat report wey bin fly up and down yesterday say di federal gorment wan change plans for di Lagos Calabar costal highway, story don change oh, in fact wi Minister of Works, David Umahi, say make Nigerians nor mind bad belle pipu wey dey spread fake news.
Say di plans for di 750-kilometre Lagos-Calabar Coastal Highway project sti dey intact.
Oga Umahi clear di air give Baba Seyi for Aso Rock Villa after e meet Presido Bola Tinubu on Monday, as e call di rumor na bad doings to confuse pipu.
Dis one dey come after many Nigerians and former Vice Presido Atiku Abubakar demand say make gornment open hand tell di truth about di project alignment.