Blog masonry

Background

foreign

How Yemen Govment & Houthi Agree To Release Thousands Prisoners

By: Rilwan Agbomeji Yemen govment and Houthi group don agree to free plenty prisoners afta about two weeks of peace talk for Muscat, Oman. Dis na according to statement wey UN special envoy Hans Grundberg release. Houthi official Abdulqader al-Mortada talk for statement wey e post on x say dem agree to exchange 1,700 Houthi prisoners for 1,200 govment side, including Saudi and Sudan people.  

todayDecember 25, 2025 8

National

Suicide Bomber Kill 5, Injure 35 For Ngamboru Market Mosque, Maiduguri

By: Rilwan Agbomeji Five people don kpai and 35 odas don get different kain injury afta one teen suicide bomber blow imself for mosque inside Ngamboru market, Maiduguri, during evening prayers on Wednesday. Eyewitness talk say di blast happen around 6:10pm when plenty traders dey worship before dem go house, and e make fire plus thick smoke burst for mosque ceiling. Di explosion scarra wetin nor good for di crowded market as people begin run for safety. Borno state police […]

todayDecember 25, 2025 10

National

First Lady Remi Tinubu Share Christmas Food For Kaduna

By: Rilwan Agbomeji Nigeria first lady, senator Oluremi Tinubu, don flag off food distribution for Christmas and New year celebration for Kaduna, as she donate ₦100 million to Christian Northern Nigeria political forum. She praise di office of di senior special assistant to di president on political and other matters for arranging di programme, and reveal say Alhaji Ibrahim Masari provide 48,000 bags of 25kg rice plus transport money for beneficiaries. Senator Oluremi talk say she no believe for free […]

todayDecember 25, 2025 8

Lagos

Fire Trap Traders For Balogun Market Plaza

By: Rilwan Agbomeji An unknown number of traders dey trap inside Great Nigeria Insurance house for Balogun market, afta fire burn di upper floors of di plaza on Wednesday. One eyewitness, wey call imself Sola, talk say di fire start around 4:40 to 5 p.m. For di fifth floor, cause stampede and stop some people from coming out, especially those for top floors. Lagos state emergency management agency confirm say di fire start from di fourth floor and later spread […]

todayDecember 25, 2025 7

National

President Tinubu Set Up APC Peace Committee For 2027 Election

By: Rilwan Agbomeji President Bola Ahmed Tinubu on Wednesday for Lagos don set up APC committee wey go handle strategy, conflict resolution and mobilisation as party dey prepare for 2027 general elections. Di committee get APC govos, ministers and oda big party stakeholders, with Yobe state govo, Mai Bala Buni, as Chairman, while Muiz Banire serve as member and secretary. Oda members include Kwara state govo and NGF Chairman Abdulrahman Abdurazak, Imo state govo and PGF Chairman Hope Uzodimma, plus […]

todayDecember 25, 2025 10

foreign

Two People Kpai As Israeli Drone Strike Eastern Lebanon

By: Rilwan Agbomeji Two people kpai on Thursday as Israeli drone strike hit one minibus for eastern Lebanon, even as ceasefire still dey in place. Lebanon State News Agency NNA talk say di drone hit di vehicle for Hosh al-Sayyed Ali road inside Hermel area. Di attack don raise fresh concern about who break di ceasefire and how di strike take happen. Israeli military spokesman, Avichay Adraee, claim for X say di drone target one person wey dem call terrorist […]

todayDecember 25, 2025 9

National

Army Kick Off Operation Ember Guard To Secure South West

By: Rilwan Agbomeji Unto security mata for di Detty December, wi Nigerian Military don ogbonge security, operation ember guard for south west, from December 23, 2025 reach January 15, 2026, to boost security during christmas and post-festive period. Talkin for flag-off ceremony, Theatre Commander, Rear Admiral Abubakar Mustapha, say intelligence report show say criminal activities fit increase, na why soldiers and oda security agencies don deploy to key areas for patrol and quick response. E assure residents say military go […]

todayDecember 24, 2025 10

National

Defence Ministry Arrange Paperless System For Naija Secuirty

By: Rilwan Agbomeji Di Ministry of Defence don officially go paperless as dem launch di Enterprise Content Management System, (ECMS), to boost digital operations for defence administration. Minister of Defence, retired general Christopher Musa, announce di development on Tuesday for Abuja during di formal go-live launch of di system at di ministry headquarters. General Musa say di initiative na major change for how di ministry handle national security marras, as e go improve efficiency, accountability and decision-making.  

todayDecember 24, 2025 9

National

President Tinubu Wire Christmas Message Giv Naija Pipo

By: Rilwan Agbomeji Wi oga Presido Bola Tinubu don promise say im go protect religious freedom for all Nigerians. E yarn dis one for im 2025 Christmas goodwill message wey drop Wednesday. Tinubu talk say im government dey committed to stop violence and discrimination, make everybody enjoy peace.  

todayDecember 24, 2025 10 2

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app