Blog masonry

Background

Lagos

LASUTH Doctors Strike, NMA Warn Say Healthcare System Dey Near Collapse

By : Jolayemi Olajide Di Lagos State house of bodi mata association,LASUTH, wey dey under di Nigerian Medical Association (NMA), don open mouth wa for ground, e get di wey e dey do dem oh, dat hunger wan finish dem. And dat, if care is not taking ehn, dem go -start a three-day warning strike to protest. Di NMA Chairmo, Dr. Ewonowo Sunday, naim dey throw lamentation untop dis mata, blaming di Lagos State Gornment for dragging back for dia […]

todayJune 18, 2026 9

obodo oyinbo

Iran Say Dia Missile Programme No Dey On Top Table

Gbege don finally drink water keep cup for inside di middle east as US Presido, Donald Trump and Iran Presido Masoud Pezeshkian sign one peace deal wey dem dey call Memorandum of Understanding, for early mormor on Thursday. Dis deal go open door for fresh talks on top Iran nuclear programme and possible removal of sanctions wey dey affect Tehran. But one major issue wey di deal no touch be say, dem no talk anything about Iran missile programme, wey […]

todayJune 18, 2026 10

Local

Ogun Police Burst Suspected Cult Doings

Ogun State Police don burst one suspected cult initiation for Isara-Remo and carry away 30 young men. According to reports, di suspects gather for one uncompleted building, dey drink alcohol, dey do initiation rites before police burst di place and scatter di whole show. Police tuk tuk pesin, DSP Oluseyi Babaseyi, konfamate di operation on Thursday, say officers from di Violent Crime Response Unit (VCRU), together with Isara Area Command and Isara Division, carry out di operation on Tuesday and […]

todayJune 18, 2026 9

Sports

England Open World Cup With 4-2

England don begin dia World Cup journey, with dramatic 4-2 win over Croatia for one very entertaining match. Harry Kane score two goals, including penalty and header, to help England take early lead before Croatia equalise twice for first half. Jude Bellingham later score just after halftime to put England ahead again. England con hold dia ground well for defence and add more pressure to seal di victory in di exciting encounter.  

todayJune 18, 2026 10

obodo oyinbo

WHO Release New Treatment Guideline

World Health Organization don release im first complete clinical guidelines for filovirus diseases as Democratic Republic of di Congo dey battle new Ebola outbreak wey come from Bundibugyo virus. WHO talk say di new guideline cover both Ebola and Marburg virus diseases for one document and e give 16 evidence-based recommendations to improve treatment and patient survival. Dem stress say early supportive care and standard treatment methods get serious role to play, especially as death rate fit range from 25 […]

todayJune 18, 2026 9

OBODO NAIJA

UK Court Clear Diezani Of Six Bribery Charges

Former Nigeria oil minister and first woman president of OPEC, Diezani Alison-Madueke, don win her case for UK court as dem clear am of six bribery charges on Wednesday, June 17, 2026. Dis na according to statement from Her lawyer, Jonathan Laidlaw, dat Southwark Crown Court discharge all di allegations after five months of trial. UK National Crime Agency bin accuse am of collecting benefits from people wey get link to two energy companies wey secure contracts from Nigeria national […]

todayJune 18, 2026 9

Local

Iyabo Obasanjo Return to PDP, Get Ticket For 2027 Election

Iyabo Obasanjo-Bello, daughter of former President Olusegun Obasanjo, don return back to Peoples Democratic Party after she resign from All Progressives Congress last week. Di party receive her formally for big event wey happen for Abeokuta PDP secretariat, where dem also present her as senatorial candidate for Ogun Central ahead 2027 election. PDP leaders, including state chairman Dr Abayomi Tella, hand over party flag to her and declare her candidature official. Obasanjo-Bello promise loyalty to di party constitution, manifesto and […]

todayJune 18, 2026 13

Lagos

Lagos Police Touch Light Campus Security

Lagos State Police Command don review security arrangement for Pan-Atlantic University, Lekki, after one video wey go viral show two masked people coming out from bush near di school. Commissioner of Police, Fatai Tijani, lead security assessment visit to di university on Wednesday. During di visit, e inspect di security measures wey dey ground alongside senior police officers. Police spokesperson, SP Abimbola Adebisi, tuk say di visit na to address security concerns wey di viral video raise.

todayJune 18, 2026 10

Sport Yarns

England  set eye for dia long-awaited glory as World Cups

By : Jolayemi Olajide Unto di world cup update, England don dey fire body to begin dia mission to end 60 years trophy without winning any trophy. Today dem go face Croatia for dia World Cup opener. Meanwhile, Cristiano Ronaldo, wey be 41 years, go feature for record-equalling sixth World Cup as e dey prepare to lead Portugal against DR Congo for Houston.  

todayJune 17, 2026 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds