Blog masonry

Background

Lagos

Early Mormor Fire Scarra 48 Shops For Elegushi Market, Lekki

By: Esther Ayoola One early mormor fire don scatter Elegushi Model Market for Lekki area of Lagos State, say e burn wetin nor good from about 48 shops. Permanent Secretary of Lagos State Emergency Management Agency, Olufemi Oke-Osanyintolu, wey jump comot sleep go the area na dey confamate dis tori for statement on Sunday. E talk say dem receive emergency call around 2 a.m., and when dem reach the place, fire don already fence the market. According to Oke, emergency […]

todayDecember 15, 2025 37

National

President Tinubu Wire Call To West African Leaders To Join Bodi Fight Terrorism

By: Esther Ayoola President Bola Tinubu don  recharge 100 naira,  wire wire call  to West African leaders say make dem join hand fight terrorism and military takeovers for di region. As im dey vex, i nor fit tuk so, im carry the phone give im  vice, Kashim Shettima for di 68th ECOWAS summit wey sup for Abuja on Sunday. Tinubu yarn say no single country fit bring stability alone, and Nigeria still dey committed to di ideals of ECOWAS.

todayDecember 15, 2025 29

National

FG Rake Full Newspaper Say Health Sector Standard For Di Obodo Nigeria

By: Esther Ayoola Wi Federal Gorment don bring mata dey rake full newspaper say Nigeria health sector dey stable for di last two and half years, and nothing serious don disturb am. Minister of Health, Ali Pate, yan this one on Sunday for TV sit down tuk, say na because di federal gorment give am beta attention and dem put money for di sector. Pate talk say, “For di last two and half years, we don experience beta care for […]

todayDecember 15, 2025 23

National

PDP Back Governor Diri Say Make Dem Do Autopsy Test For Im Late Deputy

By: Esther Ayoola Bayelsa PDP don support Governor Douye Diri decision to carry out autopsy on him late deputy, Senator Lawrence Ewhrudjakpo, make dem sabi how im die. Governor Diri give the order on Saturday when former President Goodluck Jonathan come condole with am and Ewhrudjakpo family for Government House, Yenagoa. Diri talk say dem do am because social media dey spread fake rumor and talk about wetin kpai the im deputy. Ewhrudjakpo reportedly collapse for him office last Thursday, […]

todayDecember 15, 2025 35

obodo oyinbo

Syria Security Man Go Kpai 3 Americans

By: Esther Ayoola Syria Interior Ministry don comot bodi from US wahala, gbebodia, yarn say, na one of dia security officer go kill two US soldiers and one civilian interpreter for Palmyra on Saturday. Di ministry talk for state TV on Sunday say, normally, dat particular officer get bad character and di man suppose comot from work because e get extremist Islamic belief. Washington sef confamate say, di jaguda boy na Islamic State militant, and e kpai after di attack, […]

todayDecember 15, 2025 28

Sports

NFF Call For Sponsors To Bring Video Assistant Referee To NPFL

By: Esther Ayoola Nigeria Football Federation (NFF) don clear mata say dem nor hapi with how referees dey do their work for Naija football leagues, after Nigerian refs miss chance to officiate 2025 Africa Cup of Nations (AFCON). NFF tuk this one after dem Executive Committee meeting wey hold for Abuja, dey call on senior mhen make dem con sponsor video assistant referee doings for the NPFL. Confederation of African Football (CAF) no select any Nigerian match official for the […]

todayDecember 15, 2025 22

National

Court Clean Room For Wi Former Minister Ngige For Kuje Prison

By: Rilwan Agbomeji Now make we comot body enter court, wia wi Former Labour Minister, Chris Ngige, deny all di 8 charges wey EFCC put for im head, for Abuja High Court and dat im carry ₦2.2 billion contract give family and friends. Di Minister say walahi im nor do anything like dat. Justice Maryam Hassan talk say make Ngige rent one room for Kuje Correctional Centre since im dey deny,  and dat dem go get im time on Monday, […]

todayDecember 12, 2025 41

Sports

Slot Say Im Sti Want Salah For Liverpool

By: Rilwan Agbomeji Liverpool manager, Arne Slot say  liverpool marraigae with Salah never sti finish normal, and that im go sit down Salah tuk mata as e dey be. U sabi say Salah, wey be 33 years old, vex say dem leave am out of di Champions League game against Inter Milan afta Liverpool draw 2-2 for Leeds, and e complain say e dey throw under di bus by di club. Slot talk say na normal tin say player go […]

todayDecember 12, 2025 49

National

Dangote Reduce Fuel Price Again To N699

By: Rilwan Agbomeji E nor possible e nor possible, like dis, like dis, Dangote petroleum refinery don reduce petrol deport price from n828 to n699 per litre, to make life go wiliwere for common Nigerian. Di latest reduction sharply drop (gboza for ground),  afta Chairmo, Aliko Dangote  do two aside with wi Oga Presido Bola Ahmed Tinubu package one or two on  friday, and dat, di reduction go continue go tey better style. Konfam collobi update from refinery official say, […]

todayDecember 12, 2025 34

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds