Blog masonry

Background

obodo oyinbo

Israel Fire Hezbollah, Iran Fire Back; US Sink Iranian Ship

Israel don fire more missile for Lebanon and Iran on Tuesday, di Israeli military talk say dem dey target Hezbollah base for south Beirut. Iran reply with missile strike against Israel and US base for Middle East, officials say na revenge. However, Israel PM Benjamin Netanyahu give update for  X, telling pipo of Iran to remove Ayatollah regime to remove Islam for dia politics to gain freedom, as dem dey protest repression for dia own country. Say dis war na […]

todayMarch 11, 2026 6

obodo oyinbo

Iran Show Report Card say , Israel, US Dey Strike, Civilians

Big kaboom dey hapun for Tehran as Iran show report card, say US and Israeli forces don attack almost 10,000 civilian places, kpai more than 1,300 people since  di war start 11 days ago. US military tuk say dem don destroy 16 old Iranian mine ships after President Donald Trump warn say di worse go hapun if Iran stop  oil flow for Strait of Hormuz. Hezbollah and Israeli soldiers still dey fight as Iranian missiles dey land for Israel, including […]

todayMarch 11, 2026 8 1

OBODO NAIJA

Interior And Information Ministries Join To Promote New Government Reforms.

Federal Ministry of Interior don join hand with Federal Ministry of Information and National Orientation to make sure say Nigerians understand di new gornment reforms on passport service, border security, identity management and national safety. Dis discussion hapun when Minister of Information and National Orientation, Mohammed Idris, carry high-level delegation visit di Ministry of Interior for Abuja, where Minister of Interior, Olubunmi Tunji-Ojo welcome am. Tunji-Ojo  say, strong communication between di ministries dey very important so that Nigerians go understand […]

todayMarch 11, 2026 9

OBODO NAIJA

FG Launch Ogbonge Project To Boost Food Security

Wi Federal Gornment don launch new project wey dem call Sustainable Power and Irrigation for Nigeria, SPIN, to hellep steady farming and food production. Di project get support from World Bank with about $500 million financing to improve farming and boost food security. Minister of Water Resources and Sanitation, Joseph Utsev,  na im carry dis mata dey tuk for di flag of for Abuja, say di project go strengthen food security, support economic growth and build better infrastructure for di […]

todayMarch 11, 2026 7

OBODO NAIJA

INEC, Air Force Join Hands For Safe And Smooth 2027 Election

Chairmo of  di Independent National Electoral Commission, INEC, Professor Joash Amupitan, say di commission go need continue to work together with Nigerian Air Force to make sure say election for 2027 and future ones dey free, safe and well organized. Amupitan tuk dis one when Chief of di Air Staff, Air Marshal Sunday Aneke, visit di commission headquarters for Abuja with im delegation. According to am, di visit na to make di partnership between both institutions stronger as di kontri […]

todayMarch 11, 2026 9

OBODO NAIJA

Makinde Say No Panic As PDP Governors Dey Jump Ship

Oyo State Govo, Seyi Makinde say e no shake am say governors dey leave PDP, even though di party now get only two governors left. Zamfara Govo, Dauda Lawal announce on Monday say e don dump di party, leaving Makinde and Bauchi Governor Bala Mohammed as di only PDP governors. Makinde tuk dis one for PDP Board of Trustees meeting for Abuja, say di period na tough time for di party and for democracy for Nigeria. For di BOT chairmo […]

todayMarch 11, 2026 5

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Order 100,000 CNG Kits To Make Transport Cheap

Wi oga Presido Bola Tinubu don wire message say make dem deploy 100,000 CNG conversion kits for next two to three weeks as option to di hike of petrol price. Dis one dey come after meeting for State House, Abuja with Ismaeel Ahmed, Chairmo of Pi-CNG. Say, Tinubu wan make CNG dey everywia, so dat transport go cheap for Nigerians.  

todayMarch 11, 2026 5

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Send FCT 2026 Budget

Presido Bola Tinubu don send 2026 Federal Capital Territory budget go Senate make dem approve am on Tuesday. Im still ask Senate make dem confirm Taiwo Oyedele as Minister of State for Finance to replace Dr Doris Uzoka-Anite. Baba also want make Senate approve Magnus Abe as chairman of Nigerian Upstream Petroleum Regulatory Commission. Senate Presido Godswill Akpabio na im sha read all di letters for Senate floor during plenary, straight up for everybody to understand di presido moves.

todayMarch 11, 2026 6

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Say Nigeria Don Overcome Economic Wahala

Wi oga Presido, Bola Tinubu  say Nigeria don overcome all di economic wahala under im gornment. Im yan dis one  for Presidential Villa, Abuja, when im  host religious and traditional leaders for interfaith breaking of fast. Say like dis, state govos no dey run go bank again to take loan to pay workers salary, say, indeed all im reforms dey work wella.

todayMarch 11, 2026 3

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app