Blog masonry

Background

Lagos

Lagos Police Command Mourn Dia Mehn, DCP Khan Salihu

By: Esther Ayoola Lagos State Police Command don announce di death of Deputy Commissioner of Police, Khan Salihu, wey bin dey serve as DCP wey bin dey help dem front mata for di office. For statement wey dem wrap like moimoi, wey di tuk, tuk, Abimbola Adebisi, di police praise di late senior officer say, dis na man wey sabi police work and very loyal and dat im go be a big miss to di police. Di command also salama […]

todayJune 16, 2026 12

National

FG Deny Cyberattack On Education Data Platform

By: Esther Ayoola Federal Ministry of Education don deny reports wey claim say hackers attack di Naija Education Management Information System, NEMIS. For statement wey dem release on Tuesday, Director, wey bi di tuk tuk person, Folasade Boriowo, dey make mouth oh, say, dem nor born any jaguda boy to attack dia platform. According to di ministry, all information for NEMIS, sti safe, secure and fully protected.

todayJune 16, 2026 9

Sports

Kano Pillars Release Eight Players

Kano Pillars Football Club don announce say eight players go leave dia club as dia contracts expire for end of 2025/2026 NPFL season. Di players include Muhammad Galadima, Ugochukwu Gabriel, Zahraddeen Bello, Williams Ayuba, Bernard Ovoke, Christian Izuchukwu, Sudais Ali Baba, and Aliyu Yakubu. For statement, di club thank dem for dia professionalism, commitment and contribution while dem dey play for Kano Pillars. Di club wish dem well for dia next move, talk say dem go always remain part of […]

todayJune 16, 2026 7

OBODO NAIJA

Soldiers Rescue Wife Weh Bandits Shoot

Soldiers of Nigerian Army, with support from Air Force, don rescue di wife of late Major General Rabe Abubakar, Amina Abubakar, wey bandits carry go weeks ago. According to Defence Headquarters, through di Director of Defence Information, Major General Samaila Uba, dem say di rescue hapun under Operation FASAN YAMMA. Troops explain say dem jam di kidnappers for Tunga Village during serious search and attack operation against di criminals. As soldiers dey advance, di bandits shoot di woman before dem […]

todayJune 16, 2026 13

OBODO NAIJA

Okonkwo Drag ADC Over VP Choice

African Democratic Congress chieftain, Kenneth Okonkwo don criticize di party decision to pick Vice Presidential candidate from South-South for 2027 election. Im tuk dis one for TV sit down tuk say, di move fit worsen di political marginalisation wey South-East dey face since 1999, as dem never produce Presido or Vice Presido. Okonkwo also yarn say if ADC really choose candidate from South-South, e no go show fairness to other zones, especially South-East. E remind everybody say ADC na party […]

todayJune 16, 2026 6

Local

Oyo Declare Tuesday Public Holiday

Oyo State government don declare Tuesday, 16th June 2026 as work-free day to mark Islamic New Year, Hijrah 1448AH. Gofnor Seyi Makinde approve di holiday as way to show respect and solidarity with Muslim community for the state. Na oga Commissioner for Information, Prince Dotun Oyelade, sorosoke di mata, say di Hijrah na important event wey mark Prophet Muhammad migration from Mecca to Medina. Gofnment still urge residents make dem use di day pray for peace, unity and beta development […]

todayJune 16, 2026 12

Lagos

Lagos Council Chairmo Appoint Mehn To Rascal Rascality

Chairmo of Igbogbo/Baiyeku Local Council Development Area, Hammed Aroyewun, don vow say dem go continue raid criminal hideouts for di area. E talk dis one on Monday as e dey brief journalists for council secretariat. E also talk say security operatives recently carry out surprise operation for one suspected black spot, wia dem recover hard drugs and other illegal items. According to am, di raid come as result of intelligence reports and complaints wey residents and community groups, including CDA […]

todayJune 16, 2026 7

Sports

Mo’ Salah Celebrate Birthday For World Cup

Unto World cup updates, Belgium and Egypt play 1-1 draw for dia World Cup opener on Monday, as Belgian second-half equaliser spoil Mohamed Salah birthday wey turn 34. Emam Ashour naim score first for Egypt early for first half inside Seattle. Romelu Lukaku enter as substitute, naim con force Egypt player Mohamed Hany to score own goal wey level di match. With di result, Egypt still dey find dia first World Cup win, as dem go face Iran and New […]

todayJune 16, 2026 13

obodo oyinbo

Ebola Spread To New Areas

Ebola cases for Democratic Republic of Congo don rise reach 782, with 178 people don die as di outbreak continue spread. Health authorities yesterday konfam 72 new cases and 29 deaths for Ituri and North Kivu provinces. Di disease don also reach two new health zones, Nia-Nia for Ituri and Mabalako for North Kivu, making di affected areas reach 31. Officials say 359 patients dey isolation or treatment, while 40 people don recover from di virus.

todayJune 16, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds