Blog masonry

Background

National

PDP Back Governor Diri Say Make Dem Do Autopsy Test For Im Late Deputy

By: Esther Ayoola Bayelsa PDP don support Governor Douye Diri decision to carry out autopsy on him late deputy, Senator Lawrence Ewhrudjakpo, make dem sabi how im die. Governor Diri give the order on Saturday when former President Goodluck Jonathan come condole with am and Ewhrudjakpo family for Government House, Yenagoa. Diri talk say dem do am because social media dey spread fake rumor and talk about wetin kpai the im deputy. Ewhrudjakpo reportedly collapse for him office last Thursday, […]

todayDecember 15, 2025 13

obodo oyinbo

Syria Security Man Go Kpai 3 Americans

By: Esther Ayoola Syria Interior Ministry don comot bodi from US wahala, gbebodia, yarn say, na one of dia security officer go kill two US soldiers and one civilian interpreter for Palmyra on Saturday. Di ministry talk for state TV on Sunday say, normally, dat particular officer get bad character and di man suppose comot from work because e get extremist Islamic belief. Washington sef confamate say, di jaguda boy na Islamic State militant, and e kpai after di attack, […]

todayDecember 15, 2025 8

Sports

NFF Call For Sponsors To Bring Video Assistant Referee To NPFL

By: Esther Ayoola Nigeria Football Federation (NFF) don clear mata say dem nor hapi with how referees dey do their work for Naija football leagues, after Nigerian refs miss chance to officiate 2025 Africa Cup of Nations (AFCON). NFF tuk this one after dem Executive Committee meeting wey hold for Abuja, dey call on senior mhen make dem con sponsor video assistant referee doings for the NPFL. Confederation of African Football (CAF) no select any Nigerian match official for the […]

todayDecember 15, 2025 5

National

Court Clean Room For Wi Former Minister Ngige For Kuje Prison

By: Rilwan Agbomeji Now make we comot body enter court, wia wi Former Labour Minister, Chris Ngige, deny all di 8 charges wey EFCC put for im head, for Abuja High Court and dat im carry ₦2.2 billion contract give family and friends. Di Minister say walahi im nor do anything like dat. Justice Maryam Hassan talk say make Ngige rent one room for Kuje Correctional Centre since im dey deny,  and dat dem go get im time on Monday, […]

todayDecember 12, 2025 13

Sports

Slot Say Im Sti Want Salah For Liverpool

By: Rilwan Agbomeji Liverpool manager, Arne Slot say  liverpool marraigae with Salah never sti finish normal, and that im go sit down Salah tuk mata as e dey be. U sabi say Salah, wey be 33 years old, vex say dem leave am out of di Champions League game against Inter Milan afta Liverpool draw 2-2 for Leeds, and e complain say e dey throw under di bus by di club. Slot talk say na normal tin say player go […]

todayDecember 12, 2025 20

National

Dangote Reduce Fuel Price Again To N699

By: Rilwan Agbomeji E nor possible e nor possible, like dis, like dis, Dangote petroleum refinery don reduce petrol deport price from n828 to n699 per litre, to make life go wiliwere for common Nigerian. Di latest reduction sharply drop (gboza for ground),  afta Chairmo, Aliko Dangote  do two aside with wi Oga Presido Bola Ahmed Tinubu package one or two on  friday, and dat, di reduction go continue go tey better style. Konfam collobi update from refinery official say, […]

todayDecember 12, 2025 16

National

APC Officially Arrange Office For Fubara As New Member

By: Rilwan Agbomeji Di All Progressives Congress for Rivers State branch, don officially set table for oga Govo Siminalayi Fubara as di newest member wey Kawasaki from di PDP to APC. Like dis like dis , di state APC Chairmo Tony Okocha carry di mata for head like say na government work dey share share di govo left, right and center on top social media , dis one happen for inside Government House, Port Harcourt, on Friday.

todayDecember 12, 2025 18

National

Maryam Sanda Death Ruling Stay As E Be

By: Rilwan Agbomeji Supreme Court no change mouth, dem uphold di death sentence wey Maryam Sanda collect. Di court, for a 4–1 decision, confirm say nothing dey to change di original judgment. All di grounds wey she take appeal, dem cancel am and call di case empty. Justice Moore Adumein, for di lead verdict, confirm say prosecution show enough evidence to nail di matter.

todayDecember 12, 2025 8

Sports

Udeze Question Super Eagles Final Squad For AFCON 2025

By: Rilwan Agbomeji Former Super Eagles star Ifeanyi Udeze don talk say di final 28-man squad wey Nigeria release for AFCON 2025 get many questions wey never receive answer. Di final list drop on Thursday and e spark plenty debate for football circles. Nigeria pick three goalkeepers, eight defenders, eight midfielders and nine forwards for di tournament. Udeze say di selection still raise eyebrow and Nigerians deserve clearer justification.  

todayDecember 12, 2025 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app