Blog masonry

Background

obodo oyinbo

US Presido Declare Total Shut Down For Strait of Hormuz

By: Shalom Ovie US. Presido, Donald Trump don send words to IRan say United States go hit Iran “very hard” tonight. Im tuk dis one for truth social, Say, dem go take over Kharg Island plus other oil infrastructure sites. Meanwhile, Iran Foreign Ministry don condemn di US strikes, say e don make di ceasefire almost useless Iran Revolutionary Guards carry out retaliatory attacks on US forces for Kuwait, Bahrain and Jordan, according to Iranian reports.

todayJune 11, 2026 12

OBODO NAIJA

Reps approve State Police Bill, 289 Lawmakers Back Am

By : Shalom Ovie House of Representatives don pass di State Police Bill, wey go allow states get dia own police system for di obodo Naija. About 289 lawmakers support di bill during Thursday plenary wey Speaker Tajudeen Abbas preside over. Di House decide to vote on di bill because of di increase in killings, kidnappings and bandit attacks across di country. However, drama show for di session as Kaduna lawmaker Bashir Zubairu complain say members receive di constitution review […]

todayJune 11, 2026 11

Lagos

Sanwo-Olu Show New Team To Run Lagos Gorment

By : Shalom Ovie Lagos Govo, Babajide Sanwo-Olu don present Deputy Govo, Obafemi Hamzat and senior lady Princess Damilola James as di team wey go carry Lagos gofnorship ticket. Di govo tok for news statement say di pair get di experience, vision and capacity to continue di development wey Lagos don enjoy over di years. According to am, di ticket represent di strength, diversity and bright future of Lagos State. Sanwo-Olu add say good governance na when leaders fit hand […]

todayJune 11, 2026 17

south west

Jaguda Boys Rascality For Ogun State kpai 6 Pipo

By: Shalom Ovie Six pipo naim don kpai after some kidnappers go scata dredging site for Obafemi-Owode LGA, Ogun State. Dem invade di site early Monday morning as dem try abduct one Chinese national, but di operation fail and violence break out. Ogun State Police Command confirm say one soldier, one local hunter and four other persons die for di attack. By Wednesday, residents for Fowowawo, Ajerogun and Magbon-Etido don flee dia homes as shops and activities remain shut over […]

todayJune 11, 2026 10

National

Reps Approve Major Constitution Reform Bills

By: Shalom Ovie House of Representatives don advance Constitution amendment bills wey go bring major reforms for Nigeria governance system. Tuk, tuk person Akintunde Rotimi naim sorosoke di bills, after months of work and input from lawmakers, institutions and citizens across di country. Di process include public hearings and consultations for all six geopolitical zones. Di bills cover areas like elections, judiciary, security, local government and human rights reforms.  

todayJune 11, 2026 11

OBODO NAIJA

DSS, Army Stop Jaguda Boys South East

By : Shalom Ovie DSS and Nigerian Army troops don stop alleged Jaguda boys wey bin dey plan to attack security checkpoints and kidnap people for di South East. Security sources say operatives act on intelligence to prevent di attacks. Dem also arrest two suspected field commanders for Garki, Enugu State on Monday. Authorities say di suspects dey coordinate di planned attacks and kidnappings.  

todayJune 11, 2026 14

OBODO NAIJA

ISWAP Bomb Expert With One Other Leader Don Surrender

Army boys wey dey Operation Hadin Kai don catch two big names for ISWAP group afta di guys surrender give 159 Battalion for Geidam, Yobe State. Security analyst Zagazola Makama tuk dis one on Thursday say di two suspects, Ismail Mohammed and Abu Umar, drop dia weapons on June 8. Di Soldiers tuk say Abu Umar na special engineer wey sabi arrange car bombs and explosives for di terrorist group, and e know all their hidden plans and logistics secrets.

todayJune 11, 2026 8

OBODO NAIJA

Falana, Falz, Other Groups Declare Nationwide Protest

Different group networks, youth associations, and top activists don declare tomorrow Friday, June 12, as day for nationwide protest over hunger and insecurity for country. Di coalition, say di mass action na to show how pipo dey suffer for Nigeria with high cost of living, inflation, and bad economy. Big names like lawyer Femi Falana, musician Falz, Soweto, and others sign di statement, talk say Nigerians no get reason to celebrate Democracy Day as kidnappers and bandits still dey stress […]

todayJune 11, 2026 13

Politics

Ekiti 2026, APC Chairmo rake full newspaper Say Oyebanji Re-election Na Done Deal

By : Jolayemi Olajide APC National Chairmo, Prof. Nentawe Yilwatda, dey rake oh, say the party get full numbers and power to win the Ekiti gofnorship election on June 20, plus the 2027 presidential mata. Yilwatda yarn dis one during di time e hand over di party flag give Gofnor Biodun Oyebanji for Abuja to take run for second term. E praise Oyebanji, say di governor dey work hard to build roads, give scholarships, and support people with better healthcare […]

todayJune 11, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds