Blog masonry

Background

National

Fubara Explain Why Im Move To Di APC

By: Rilwan Agbomeji Rivers State Govo, Siminalayi Fubara, don explain why im cartapot enter di All Progressives Congress, say, im dey carry plenty personal and political wahala because e refuse tell im own side of di tori wey dey cause gbagan for di state. Di governor yarn dis one as e commission di newly expanded Ahoada–Omoku Road for Rivers West, road wey Julius Berger build and wey be part of im campaign promise. Fubara talk say, up till now, e […]

todayDecember 11, 2025 6

National

Tinubu Open Plan Say Im Wan Use Sea Resources Take Create Jobs

By: Rilwan Agbomeji Wi oga Presido Bola Ahmed Tinubu don drop mata again say contri pipo go join bodi use sea and mami water resources take boost economy, create work, and bring long-term progress. Vice presido Kashim Shettima talk di matt for presidential villa during meeting with senior executive course 47 from national institute for policy and strategic studies. Tinubu direct all ministries and agencies make dem check NIPSS report on blue economy development and start to implement am as […]

todayDecember 11, 2025 6 1

National

President Tinubu Ginger Area Say Make Forest Guards Dey Carry Gun

By: Rilwan Agbomeji To deal with all di jaguda bois for inside di obodo Naija, wi oga Presido Bola Tinubu don vex oh, approve forest bodi guards across Naija say dem dey carry kalachi as part of new plan to fight banditry, kidnapping and illegal mining for rural areas. Di announcement come afta Federal Executive Council meeting for Abuja on Wednesday, where Tinubu talk say security matter don reach level wey require better-equipped local forces. According to di presido, forest […]

todayDecember 11, 2025 12 1

Lagos

Two Pipo Kpai For Cult Wahala For Ajah, Lagos

By: Rilwan Agbomeji Unto wahala report for Lagos, say two people, wey dem never fit get name na kpai for  suspected cult warling warling for Ajah area, Lagos state. Kofam aproko gather say, di incident happen for Tuesday night. Dem talk say di attackers enter one crowded area near Ikota complex, come start to dey shoot anyhow. Di shooting make plenty people for community and market run for safety, cause gbege everywhere. An as at di time wey wi package […]

todayDecember 11, 2025 7

National

Senate Argue About Di Removal Of Police Escort

By: Rilwan Agbomeji Na beta agument shelle for di Nigeria senate on Wednesday,  say  Senator Abdul Ningi cry out as dem collect im escort afta Presido Tinubu order make dem withdraw police from VIPs, while many ministers, big men and entertainers still dey move with police. Ningi ask why di directive no dey affect everybody and say National Assembly no suppose be di only pipo to suffer change. As di argument hitup, na so Deputy Senate Presido Jibrin Barau take […]

todayDecember 10, 2025 10 1

Sports

Heartland Coachie Amuneke Vow To Show Sunshine Stars Peper For Akure

By: Rilwan Agbomeji Di fight for promotion don dey heat up for wi national league, say heartland technical adviser, Emmanuel Amuneke don yarn full ground say im team go put body make dem win against sunshine stars. Di naze millionaires dey ready for Nigeria National League, NNL, matchday five wey go hold for Akure today Wednesday. Last weekend, Heartland beat Inter Lagos 3-2 for dan Anyiam Stadium, Owerri. Amuneke dey confident say dem fit carry all di three points from […]

todayDecember 10, 2025 10

International

Australia Cut Rope For Under-16s Say Make Dem Comot Social Media

By: Rilwan Agbomeji Chai nor be small tin, say Australia gorment don carry beta fight wey get odour enter social media, say dem nor wan see any of dia 16 year old pikins for social media, Facebook, Instagram, Youtube, and X on Wednesday. According to di Australian Gornment say dem wan take back di power from di tech sharks and dem dat, dem dey spoil dia childrensis for dem. Dem say if these apps, no clear under-16 users wey dey […]

todayDecember 10, 2025 16

National

PDP National Chairmo Turaki Confamate 29 Chairmen Across States

By: Rilwan Agbomeji Di Pipos Democratic Parti  National Chairmo,  Tanimu Turaki (SAN)  don wia long nika, with long wire clear di air say, nothing like faction, nor divide for inside di parti,  say PDP still be one house, and dat 29 state chairmen tanda gallant dey await confirmation to work. Turaki dish di tori live for Abuja on Wednesday during PDP state chairmen meeting, where 29 land physically for screening. E remind dem say PDP governors don sign and stamp […]

todayDecember 10, 2025 8

National

Drama As Senate Presido, Akpabio Wish Natasha Akpoti Hapi Birthday

By: Rilwan Agbomeji Small drama happen for senate on Tuesday, e shock  every bodi like konfam shock shock say  Senate President Godswill Akpabio dey celebrate im 63rd birthday con still wish senoir woman Senator Natasha Akpoti-Uduaghan. Say im birthday, na di birthday of Senator Natasha Akpoti-Uduaghan wey represent Kogi-central, wey dey 47. As e dey normal for Senate, Akpabio call all di lawmakers wey dey celebrate am to specially recognise Senator Akpoti-Uduaghan join imself, na so everywia burst.  

todayDecember 10, 2025 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app