Blog masonry

Background

National

Tinubu Celebrate Mike Adenuga @73, Praise Am As Naija Business Heavyweight

By: Esther Ayoola President Bola Tinubu don give beta salutate to senior  businessman and philanthropist Dr Mike Adenuga as im  turn 73 years. Tinubu tuk dis tuk inside one seven paragraph statement, say Adenuga na real man wey sabi, wey don put correct mark for Nigerian business world. E tuk say, through Globacom, Conoil, real estate, banking and oil and gas, Adenuga don show excellence for many sectors. Tinubu wish am happy birthday and pray make im success continue to […]

todayApril 29, 2026 11

National

President Tinubu Do Close Door Meeting Plateau Stakeholders For Abuja

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Tinubu on Tuesday don go hold one ogbonge closed-door meeting with Plateau State stakeholders for Presidential Villa, Abuja. Tatafo pipo dey suggest say na security mata dem discuss based on wetin happun for palm Sunday for Plateau state. Dem tuk for several hours, but nobody release wetin dem discuss to di public. However, say, dis meeting na follow-up to Tinubu recent visit to Plateau afta di deadly Palm Sunday attack for Angwan Rukuba, […]

todayApril 29, 2026 21

south west

Makinde Meet Peter Obi For Ibadan To Discuss 2027 Coalition Plan

By: Esther Ayoola Oyo state govo Seyi Makinde and di 2023 labour party presidential candidate don run anoda closed door meeting. Say di Oyo state Govo host Peter Obi with im delegation for im Office for Agodi, Ibadan on Tuesday. Speaking with tori pipo afta di meeting, Obi say di visit na part of ongoing tuks and consultation about coalition wey dem dey plan run for 2027 general elections. Dis meeting sef dey happen few days afta coalition summit for […]

todayApril 29, 2026 14

Lagos

Federal High Court Launch Digital System For Lagos Division

By: Esther Ayoola Federal High Court for Lagos Division don launch e-filing system wey go make court work go digital, instead of using paper. Untop yarnings with tori pipo for court on Tuesday, Chief Judge, John Tsoho explain di new system, say e go improve efficiency, transparency, and make access to justice easier. E also tuk say di change na something wey  pass due process and dat di old manual filing bin  dey slow court process down.  

todayApril 29, 2026 8

Lagos

Lagos Assembly Back Tinubu Second Term, Praise Subsidy Removal

By: Esther Ayoola Members of Lagos State House of Assembly like dis, don join hand dey back oga Presido, Bola Tinubu make he run for second term as Presido. Dem take di decision for Tuesday plenary afta Ladi Ajomale from Oshodi/Isolo Constituency II move di motion. Ajomale spread bodi explain di Tinubu administration important reforms, like student loan scheme, removal of fuel subsidy, and big infrastructure projects like Lagos Coastal Road. Say all dis work need continuity, so dat Naija […]

todayApril 29, 2026 7

Lagos

Lagos APC Big Men Pick Hamzat As Consensus Candidate For 2027 Governorship Race

By: Esther Ayoola One ogbonge group, wey call dem selves, Governance Advisory Council (GAC), wey be top advisory body of All Progressives Congress for Lagos State, like dis don join force endorse Dr. Kadri Obafemi Hamzat as dem consensus candidate for 2027 governorship election. Chairmo of GAC, Oluyole Olusi, naim convasate dis mata to tori pipo on Tuesday as Govo Babajide Sanwo Olu carry Hamzat go see dem Oluyole say, GAC stand gidigba behind Hamzat, say make oga Deputy nor […]

todayApril 29, 2026 13

OBODO NAIJA

FG Push 30-Day Credit, Direct Fuel Sale to Save Airlines

 Federal Gornment through Aviation and Petroleum Ministries and NMDPRA don tuk say airline fuel marketers must give operators 30-day credit and also sell aviation fuel direct to dem. Dem tok dis one for executive summary wey come out Monday for Abuja, after high-level meeting wey involve FAAN, NAMA, NCAA, airline operators and fuel marketers. Di reason why dem take dis decision na to tackle serious jet fuel shortage and price hike wey don dey affect flight operations and cost of […]

todayApril 28, 2026 14

Politics

Peter Obi Pay Visit to Jonathan for Abuja

Di 2023 presidential candidate of labour party and now of di African Democratic Congress (ADC), Peter Obi, don  pay August visit to former Presido, Goodluck Jonathan for Abuja to tuk about how di country dey go and 2027 election. Di meeting hapun behind closed door, as Obi carry some South-East political leaders go meet am. Obi tell journalists say di visit na part of im consultation waka as e dey prepare ahead of di 2027 general elections.

todayApril 28, 2026 14

OBODO NAIJA

Naija New Housing Minister Promise Affordable Houses

Di new Minister of Housing and Urban Development, Muttaqha Darma, don promise say im go use teamwork take solve Nigeria housing shortage and make houses more affordable. E tuk dis one for handover ceremony wey happen for Abuja on Monday evening. Darma say im administration go work closely with all important pipo for di housing sector to fit achieve better results.

todayApril 28, 2026 16

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds