Blog masonry

Background

Lagos

Lagos Gornment Setup Big ‘Invest Lagos’ Summit To Bring Top Investors

By: Esther Ayoola Lagos State gornment don spread aproko on how dem wan use di third edition of di 'Invest Lagos Summit' to bring big investors and correct business opportunities come Lagos and Naija. Oga Commissioner for Information and Strategy, Gbenga Omotosho, naim tuk dis tuk on Sunday, wey pipo dey church, say di two-day event wey start on Monday, June 8,  and end on Tuesday. Omotosho explain say top gornment leaders, global investors, and big business bosses naim go […]

todayJune 8, 2026 11 1

obodo oyinbo

Iran Threaten To Fire America And Israel

Iran don threat say dem go drop tins for America and Israel sake of bombing wey hapun for Beirut on Sunday, as di Middle East war clock exactly 100 days. Dis new round of wahala dey spoil tins, di hope say, peace go soon come, don jam rock like dis. Tehran clear everybodi, say any peace tuk to end di war permanently must also stop di fight inside Lebanon, wia Israel dey pursue Hezbollah fighters wey Iran dey support.

todayJune 8, 2026 14

OBODO NAIJA

Datti Blast Atiku

Former Labour Party Vice Presidential candidate, Datti Baba-Ahmed don go shake table oh, say Atiku thinkings for politics nor enter sand, nor strong, if to say Atiku Abubakar support Peter Obi for di 2023 election, e for don win presidency for 2027. Im yarn dis one for TV sit down tuk, say, if Atiku show patience like Tinubu and allow Obi contest first, both of dem for support am later. Baba-Ahmed add say many politicians dey always see demsef as […]

todayJune 8, 2026 15

National

Vice Presido Shettima Beg Nigerians

Vice Presido, Kashim Shettima dey shout for one coner, dey pray for Abuja National Mosque on Friday, say make Nigerians drink cold water, chillas, call for peace, to take celebrate dis year Democracy Day on June 12. After di prayer, Shettima assure Nigerians say Presido, Bola Tinubu dey work oh, say dat man work hard pass rock of ages, all na to bring stability to di country. Shettima say, all wetin di presido need, na prayer for unity.

todayJune 8, 2026 10

Lagos

Lagos Gornment Share Bulletproof Vests And Helmets

Lagos State Security Trust Fund (LSSTF) don share bulletproof vests and heavy-duty helmets give all Divisional Police Officers (DPOs), Area Commanders, and tactical squad for di state. Di LSSTF boss, Dr. Ayodele Ogunsan, naim hand over di security gear on Friday base on di order of baba govo, Babajide Sanwo-Olu to take protect di police officers as dem dey fight crime. Ogunsan say dis support na to clear doubt say Lagos gorment serious about securing Lagos security.

todayJune 8, 2026 11

Sport Yarns

Ronaldo And Messi Wan Make History With 6th World Cup

By : Jolayemi Olajide Football legends Cristiano Ronaldo and Lionel Messi na im dey headline di list of global superstars wey go feature for di 2026 FIFA World Cup wey Canada, United States and Mexico go co-host. According to information wey MSN.com publish on Friday, di big tournament go feature 48 national teams and plenty established stars alongside rising football talents from around di world. Ronaldo, wey be Portugal captain and all-time international top scorer, dey prepare for a record […]

todayJune 5, 2026 41

Sport Yarns

 Tottenham Grab Andy Robertson for  Free

By : Jolayemi Olajide Tottenham Hotspur don complete the signing of Scotland captain Andy Robertson for  free transfer. BBC Sport report on Friday say the 32-year-old left-back go join the North London club on July 1 after im contract with Liverpool expire. Robertson don bin  announce say e go leave Liverpool dis summer, and na dia  Tottenham  take collobi im signature.

todayJune 5, 2026 9

obodo oyinbo

Hamas declare Say Dem No Dey Surrender Weapons, but dey ready peace tuk

By : Jolayemi Olajide Hamas political senior man, Husam Badran drop micro soft word, say dem ma ready for peace tuk with  Gaza, as dem still dey negotiate peace plan. Im yarn dis one for TV interview, but dat one nor mean say Hamas go surrender weapons. Acoording to Husam,  Wahala still dey for  di negotiation as different Palestinian groups dey prepare for Cairo meeting,while Isreal sti dey drop tins upon tins.

todayJune 5, 2026 13

OBODO NAIJA

Abuja Police Seize Over 30  Cars say dem get black glass

By : Jolayemi Olajide FCT Police Command don seize more than 30 vehicles with tinted glass, wey be say dem cover plate, say any motor wey nor get correct registration go collect based on di insecurity. According to di  FCT Commissioner of Police, Ahmed Sanusi, say nao ga IGP, Olatunji Disu, give dem dem di go ahead and to tackle rising cases of one-chance robbery, kidnapping and other violent crimes.  

todayJune 5, 2026 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds