Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

Veteran Yoruba Actor Taiwo Hassan ‘Ogogo’ Kpai at 66

By: Mariam Ajayi Veteran Yoruba actor, Taiwo Hassan, wey pipo sabi as Ogogo, kpai at di age of 66. Na im daughter, Kira Taiwo, Konfamate im death for Instagram Live session on Sunday. Ogogo na one of di respected faces for Yoruba movie industry, with many years of acting and contribute to Nigerian entertainment. Im death don make fans and colleagues across di entertainment industry cry wetin no good , as tributes continue to pour in for di late actor.

todayAugust 24, 2026 20

OBODO NAIJA

Must Read: Ogogo Burial Ceremony Go Hold Today

Respected Nollywood actor and filmmaker, Taiwo Hassan, popularly known as Ogogo, don kpai at di age of 66. Ogogo kpai on Sunday, August 23, 2026, around 3 p.m., after e battle stage-four cancer. His death come just few days after im daughters reveal say di actor dey seriously sick and dem appeal to Nigerians for medical assistance. Ogogo na one of di respected faces for Yoruba Nollywood, with career wey span several decades. He become popular through im powerful acting, […]

todayAugust 24, 2026 22

Lagos

Seven Kpai for Lagos-Ibadan Expressway Road Askident

By: Mariam Ajayi Seven persons don kpai while two others sustain wunjury after three motor jam for Kara axis of Lagos-Ibadan Expressway on Monday. Federal Road Safety Corps (FRSC), Ogun State Command, confirm say di crash happen around 12:03am and involve one truck, one trailer and a Mitsubishi Canter. FRSC Ibafo Outpost receive di report around 12:04am and officers reach di scene about five minutes later. All di pipo wey dey involve for di crash na men, Seven out of […]

todayAugust 24, 2026 27

obodo oyinbo

Netanyahu Swear Say Iran No Go Control Any Palestinian State

By:  Mariam Ajayi Israeli Prime Minister, Benjamin Netanyahu don swear say as long as e remain Prime Minister, e no go allow any Palestinian state wey Iran dey control to happun. Netanyahu make di statement for weekend, August 23, 2026, for message wey e post on X, as argument over Palestinian statehood continue to dey hot. E say Gaza and Judea and Samaria, wey Israel dey use refer to di West Bank, no go become Palestinian state under Iran control, […]

todayAugust 24, 2026 16

OBODO NAIJA

Tinubu Renew Tenure of NTA DG Dembos and NAN MD Ali for Three Years

By: Mariam Ajayi Presido Bola Tinubu don renew di tenure of di Director-General of Nigerian Television Authority (NTA), Abdulhamid Salihu Dembos, and di Managing Director of News Agency of Nigeria (NAN), Ali Mohammed Ali, for another three years. Tinubu’s decision come out for statement wey him Special Adviser on Information and Strategy, Bayo Onanuga, release on Sunday. According to di statement, Tinubu first appoint Dembos and Ali on October 20, 2023, and dia second term go begin on October 20, […]

todayAugust 24, 2026 15

OBODO NAIJA

Fire Burn Five Shop For Ilorin.

By: Mariam Ajayi Fire don destroy five shop and damage part of one storey building for Ita-Amodu, Niger Junction, Ilorin, Kwara State. Di incident happen on Sunday around 1:36pm, according to Kwara State Fire Service. Di fire affect one storey building wey get three-bedroom flats and 10 shops. Five of di shops and di building parapet suffer damage. Kwara State Fire Service Public Relations Officer, Hassan Adekunle, explain say materials wey dem dey use produce mattresses and sofas dey among […]

todayAugust 24, 2026 13

OBODO NAIJA

NAF Step Up Air Attacks Against Terrorists, Bandits For North-West

By: Mariam Ajayi Nigerian Air Force don increase air operation against terrorist, bandits, kidnapper and oda criminal across di North-West, especially Sokoto State. NAF tuktuk pesin, Air Commodore Ehimen Ejodame, talk dis on Monday for Abuja, say di stronger air presence na to support joint security operation. Ejodame say di operation go helep security forces use air surveillance to find criminal group wey dey hide for difficult area and stop dem from moving freely. Chief of Air Staff, Air Marshal […]

todayAugust 24, 2026 14

Politics

Ogun APC Say Yayi Still Be Dia 2027 Governorship Candidate

By: Mariam Ajayi Ogun APC don konfam Senator Solomon Adeola, wey dem dey call Yayi, as di party candidate for di 2027 governorship election. Party chairman, Yemi Sanusi, talk dis on Sunday for Ogun, say Abayomi Hunye claim say he be di candidate na lie and make people nor mind am. Former APC lawmaker, Kayode Oladele, also criticise Hunye for still dey fight for di ticket and recently unveil im running mate. Oladele say APC don finish di nomination process […]

todayAugust 24, 2026 12

Sports

Maresca Confess Say  Man City Na  Still  Work In Progress

By: Mariam Ajayi Manchester City coach Enzo Maresca don talk down di team chances of winning di Premier League title dis season, despite dia dramatic 2-1 comeback win against Bournemouth. City struggle for most of di match before late goal from Marc Guéhi and Joško Gvardiol turn di game around and give dem all three point. Maresca say di team still be work in progress, as e dey test different tactic, including playing Guéhi for midfield. E explain say some […]

todayAugust 24, 2026 15

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds