Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

NYSC DG Warns Corps Members Against Fake News As 2027 Election Near

By: Mariam Ajayi NYSC Director-General, Brigadier-Genera Olakunle Nafiu, don warn corp member against blindly sharing information for social media, as he urge dem to verify any content before dem repost am, especially as Nigeria dey approach di 2027 general election.   Nafiu give di warning on Wednesday during an inspection visit to di NYSC permanent orientation camp for Katsina State, where he tell corp member say dem need to develop critical thinking skill before dem share or comment on information […]

todayAugust 20, 2026 15

OBODO NAIJA

Oyedele Blasts Nigerians Wey Abuse World Bank Over Nigeria Loan

By: Mariam Ajayi Minister of Finance and Coordinating Minister of di Economy, Taiwo Oyedele, don fault Nigerians wey attack di World Bank for social media over loans to Nigeria, saying dia actions show say dem no understand how di lending system dey work.   Oyedele speak on Wednesday for Abuja during media briefing on di Federal Government economic reform scorecard, where he explain say some Nigerians go World Bank social media accounts to abuse di institution over its decision to […]

todayAugust 20, 2026 19

Lagos

EFCC Gbab Two Men Over Bank Access Details

EFCC on Wednesday, August 19, arrest Gideon Aghogho and Oscar Chukwuebuka for Federal High Court, Ikoyi, Lagos, over alleged illegal supply of bank access details. EFCC accuse dem and one suspect wey dey run, Scott, say dem supply details wey fit give access to one bank database between July 24 and 26, 2026. Aghogho plead not guilty, while Chukwuebuka plead guilty as court order say dem remain for correctional centre pending further proceedings. Justice F.N. Ogazi adjourn di case till […]

todayAugust 20, 2026 12

Lagos

Truck Kill Man For Lagos-Ibadan Expressway, Driver Run

One yet-to-be-identified young man die for Lagos-Ibadan Expressway near OPIC bus stop, Ogun State, on Wednesday after speeding truck hit am as e dey cross road. Witness Nojeem say di truck run over di man and di driver run away, while di crash scatter parts of im body for di road and affect traffic. Media toktok person Babatunde Akinbiyi confirm di incident and say some officials and Amotekun Corps move to di scene to control traffic and clear di road. […]

todayAugust 20, 2026 15

Lagos

Sanwo-Olu Give LASU Best Graduates N20m Each

Lagos Govo Babajide Sanwo-Olu on Wednesday give N20 million each to LASU overall best graduating students for 2024/2025 and 2025/2026 sessions. Sanwo-Olu announce di awards during LASU combined convocation for Ojo, where Ayilara Olawale and Adebanjo Samuel emerge best graduates with CGPA of 4.96 and 4.97. Di govo congratulate 20,604 graduates and say di number na di biggest for LASU history. Im add say 494 graduates make First Class, while 3,383 others bag postgraduate degrees, including PhDs.

todayAugust 20, 2026 19

OBODO NAIJA

Tinubu Order Recovered EFCC Money Make E Go NELFUND

Presido, Bola Tinubu on Wednesday order say all liquid funds wey EFCC recover, plus unclaimed dividends, make dem divert go NELFUND to strengthen di student loan scheme. Minister for education, Tunji Alausa naim disclose dis after Federal Executive Council meeting for Presidential Villa, Abuja, on Wednesday. Alausa say Tinubu give di order to make sure NELFUND get enough money to continue funding students for long term. Di council meeting na dia first sitting since June 29, after di Presido direct […]

todayAugust 20, 2026 16

OBODO NAIJA

Some Students Fit Collect NELFUND Money Without Parents Knowing

Finance Minister Taiwo Oyedele say for Abuja on Wednesday say some students fit don collect NELFUND money without dia parents knowing. Oyedele talk dis one after one audience member say im three children never receive NELFUND support and dem no know anybody wey collect am. Di minister tell di journalist make e ask im children whether dem apply and demand proof of dia applications. Oyedele say e possible say di students don collect di money secretly while dem still dey […]

todayAugust 20, 2026 12

obodo oyinbo

Trump Declare Total Economic Short Down For Iran As Dem Nor Gree Hear Word

US Presido, Donald Trump don announce say like dis now im belle black wetin nor gud and dat as Iran nor wan gree year word to sign peace deal say im go scata Iran economy. Trump fire dis warning untop im truth social, say di kind of hunger wey go do Tehran, dem nor go believe am. Trump also say Washington fit return to tuks with Iran at some point, if dem ready to change dia bad character, but insist […]

todayAugust 20, 2026 14

OBODO NAIJA

Adeleke Announce N500m Fund For Election Violence Victims

Osun State Govo, Ademola Adeleke, don make everywia stew say na automatic scholarship to university level for children and dependants of pipo wey lose dia lives during violence before di August 15 gornorship election. Adeleke make di announcement on Wednesday for Labour movement celebration rally, shortly after he collect certificate of return from INEC. He also promise say Osun State Gornment go establish N500 million Election Violence Victims Endowment Fund to give relief and support to verified victims

todayAugust 20, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds