Blog masonry

Background

Sports

Rivers United Players Get Askident As Dem Dey Travel For President’s Cup Match

By: Esther Ayoola Wahala hapun on Thursday say NPFL side, Rivers United, get road aakident as dem dey travel go Awka for Anambra State for dia President’s Cup match against Nasarawa United. The club konfam inside one statement say the accident hapun for Obiri-Ikwerre Airport Road outskirt of Port Harcourt, just after di team leave dia camp. Naso some players and officials get small-small wounds for body, but thank God say nobody kpai and nobody get any serious injury wey […]

todayJune 5, 2026 12

National

Army Distroy Terrorists For North-East, Rescue 20-Year-Old Mama And Her Baby

By: Esther Ayoola Di Joint Task Force troops for North-East do small jacki chan gbab some terrorists and rescue some pipo under di operation wey dem call 'Operation Desert Sanity V'. Media Information Officer for Operation Hadin Kai, Lieutenant Colonel Sani Uba, naim clear face on Thursday dey explain how dem carry high spirit enter di terrorists. Among di pipo wey get freedom na one 20-year-old woman, Maryam Muhammad, and her one-year-old baby boy, Bello, wey di terrorists carry go […]

todayJune 5, 2026 9

National

Falana Give FG 14 Days To Collect $120.5B Wey NNPCL And Oil Companies Owe Naija

By: Esther Ayoola Human rights lawyer, Femi Falana (SAN), don give di Attorney General of di Federation, Lateef Fagbemi (SAN), 14 days to go drag $120.5 billion and N66.4 billion wey NNPCL, international oil companies, and others allegedly owe di Naija. Inside letter wey im write on June 2, 2026 for di group ASCAB, Falana say dis money na normal royaltu, crude oil theft, profit, taxes, and money wey dem spend to repair refineries wey nor work later. He con […]

todayJune 5, 2026 9

south west

FG Vow To Rescue Kidnapped Oyo, Borno Pupils, Say Terrorism No Go Win

By: Esther Ayoola Di Federal Gornment don assure Nigerians say dem dey do everything possible to rescue di 82 pupils and teachers wey kidnappers carry for Oyo and Borno States. Di Minister of Information and National Orientation, Mohammed Idris, tuk dis one on Thursday for Radio House, Abuja, during one special national security tuk tuk wey dem do for Abuja According to Idris, baba seyi don direct security agencies to move fast with dia operation and rescue di childrensis.

todayJune 5, 2026 15 1

Lagos

Lagos Gorment Tighten Grip For Illegal Dredging, Say Communities Must Join Fight

By: Esther Ayoola Lagos State Government don promise to tighten monitoring and enforcement to stop illegal dredging and coastal degradation across di state 187-kilometre coastline. Di Commissioner for Waterfront Infrastructure Development, Ekundayo Bush-Alebiosu, naim sorosoke dis mata on Thursday news waka waka dem for im office. Bush-Alebiosu tuk say di ministry dey work with relevant agencies, stakeholders and communities to protect Lagos waterfronts and ensure sustainable development. According to am, illegal dredging dey threaten coastal communities, fisheries and important infrastructure, […]

todayJune 5, 2026 9

Sports

Liverpool Sign Andoni Iraola

Liverpool done officially appoint former Bournemouth coach, Andoni Iraola, as dia new manager on Thursday. Dis one dey hapun after dem sack Arne Slot last Saturday bicoz di poor team performance. Di 43-year-old Spanish coach tuk for interview say he dey over jolly to join di club, as everybody know say Liverpool na one of di biggest teams for di whole world.

todayJune 5, 2026 11

obodo oyinbo

Israel-Lebanon Ceasefire Bombing Continue

Israeli Army still dey carry out heavy strikes for Lebanon even after US try broker new ceasefire agreement wey suppose calm tension between Israel and Lebanon. So like dis now, Hezbollah leader, Naim Qassem don reject di ceasefire, call am fake, and say dem go still target northern Israel if Israel no stop di attacks. Lebanon Health Ministry say since March 2, over 3,526 people don kpai and 10,733 pipo don wound because of di strikes. Even wit di announcement […]

todayJune 5, 2026 6

OBODO NAIJA

State Police: Presidency Set To Sign Am!

Naija don dey move closer to start state police and dat, like dis di Presidency dey move very fast to change di law book wey go make am hapun. Oga Chief of Staff to the President, Femi Gbajabiamila, naim break dis news on Thursday after one major meeting inside State House for Abuja. According to Femi, dis mata don start many months ago after President Bola Tinubu give the order.

todayJune 5, 2026 8

OBODO NAIJA

We Go Rescue Kidnapped Oyo, Borno Pupils – FG

Di Federal Gornment don assure Nigerians say dem dey do everything possible to rescue di 82 pupils and teachers wey kidnappers dem carry for Oyo and Borno States. Di Minister of Information and National Orientation, Mohammed Idris, tuk dis one on Thursday for Radio House, Abuja, during one special national security tuk tuk wey dem do for Abuja. According to Idris, Baba Seyi don direct security agencies to move fast with dia operation and rescue di children.

todayJune 5, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds