Blog masonry

Background

obodo oyinbo

Iran and US Tuks Fail

Iran and United States no reach deal to stop Middle East war, as US Vice President JD Vance talk after long talks for Islamabad, say e don drop im “final and best offer” give Tehran before e comot. Vance say US want clear promise from Iran say dem no go build nuclear weapon, but dem never see dat commitment. Pakistan wey host di talks urge both sides make dem respect di temporary ceasefire. Iran state broadcaster say talks stall because […]

todayApril 12, 2026 16

Sports

Anthony Joshua No Gree Accept Fury Ring Challenge

Former heavyweight champ Anthony Joshua don snub Tyson Fury fight offer straight after Saturday night bout for Tottenham Hotspur Stadium. Fury breeze pass Arslanbek Makhmudov for one dry, one-sided fight wey no even spark di crowd. As Joshua dey ringside dey watch, na so fury call am out make e enter ring. But Joshua no show face for ring, e ignore di call, and some fans begin boo am. Later, Joshua reply say Tyson dey chase cloutand dat e never […]

todayApril 12, 2026 17

OBODO NAIJA

Police Gbab One Man Wey Cut Small Pikin Head For Oyo

Oyo State Police Command don gbab one 23-year-old guy wey dem catch with pikin head for Ibadan. Police tuk tuk , Ayanlade Olayinka, yarn on Sunday say di matter happen on Saturday, April 11, for Adigun Village, Olorunda Ogunsola area inside Ona-Ara Local Government Area. According to am, police move sharp-sharp after dem receive informate say some pipo kpai one small girl con cut her head. Olayinka talk say dem allegedly see di head for hand of one Sodiq Akorede […]

todayApril 12, 2026 18

obodo oyinbo

US Vice Presido Land Enter Pakistan For Iran Talks

US Vice Presido, JD Vance land for airbase near Islamabad on Saturday, ahead of negotiation with Iran to end Middle East war. Iran delegation wey pass 70 people, wey parliament speaker Mohammad Bagher Ghalibaf lead, reach Islamabad first under tight security. Di Vice presido yarn say US dey ready to open hand if Iran negotiate well, but if dem wan play game, US team no go soft. As for Iran dem dey insist say make ceasefire start for Lebanon, and […]

todayApril 11, 2026 17

Sports

Inter Miami Wan Carry Casemeiro

Manchester United Midfielder, Casemiro don get two-year offer to join Inter Miami. According to transfer expert Nicolo Schira, Inter Miami dey talk with di Brazil international for possible move dis summer. Di MLS side wan bring di 34-year-old go United States as free agent from July. Inter Miami don offer Casemiro contract wey go run till December 2028, but e never tuk anything.

todayApril 11, 2026 12

OBODO NAIJA

Federal Gornment Drop New Tariffs, Cut Import Duty For Rice, Motor, Drugs and Sugar

Federal Gornment don approve new 2026 Fiscal Policy Measures (FPM) wey go change import tariffs to help grow important sectors of di economy. Di approval dey inside document wey carry date April 1, 2026, wey Minister of Finance, Wale Edun sign and di new policy go replace di 2023 own. Gornment don review import duties for 127 items like rice, sugar, vehicles and industrial materials, say di reduction go help businesses grow. Under di new policy, Import Adjustment Tax for […]

todayApril 11, 2026 31

OBODO NAIJA

My Gornment Care For Every Bodi – Presido Tinubu

Wi oga Presido, Bola Tinubu don talk say im gornment still dey serious to tackle main problems like hard economy, light wahala and security issues for di obodo Naija Tinubu yarn dis one for Yenagoa, Bayelsa State, say im gornment still dey focus on policies wey go help poor people and those wey dey vulnerable pass. Oga Tinubu add say e no go stop to dey move forward, and e go continue to find ways to support people wey dey […]

todayApril 11, 2026 13

Sports

Nigeria Football Federation (NFF) don announce 36-player squad for Flamingos ahead of their second-round qualifier for FIFA U-17 Women’s World Cup for Morocco. New head coach Akeem Busari pick five goalkeepers, 10 defenders, 13 midfielders and eight forwards as dem begin preparation for important tie against either Niger Republic or Guinea. Di two countries go first meet for first round, and winner go come face Nigeria. Niger Republic go host first leg of their match dis weekend, while return leg […]

todayApril 11, 2026 18

Sports

Bassey Dey Ready For Liverpool Clash

Fulham don get better boost before dia Premier League trip go Liverpool, as dem don confirm say Calvin Bassey don recover and e fit play. Di Nigeria international bin dey doubtful after e comot from Super Eagles squad for March international friendlies because of back problem, wey make am miss matches against Iran and Jordan for Antalya. Im absence bin raise concern whether e go fit play Fulham important match for Anfield, but now those fear don clear. Manager Marco […]

todayApril 11, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds