By: Esther Daniel
Osun State Gofnor and Accord gofnorship candidate, Ademola Adeleke, don call on voters for Osun State on Thursday make dem reject APC for di August 15 gofnorship election, say na so dem go protect di progress wey im administration don make.
Adeleke tok say APC make civil servants suffer during dia time for office by paying half salaries, and say many workers no fit feed dia families because of di policy.
Di gofnor also defend im gornment welfare record, say since e become gofnor for Osun State, improv di lives of civil servants and residents don remain one of di biggest priorities of im administration.
Adeleke add say di recent freezing of Osun State Gorment accounts go only make people more determined to vote for Accord Party on August 15 so di state no go return to wetin e describe as days of hardship.