Blog no sidebar

Background

OBODO NAIJA

Wike clear air say im nor Endorse Anybody for Rivers Governor, We Nor Dey with Fubara

By : Jolayemi Olajide FCT Minister Nyesom Wike tuk for Abuja don clear mata  say e never endorse anybody for Rivers 2027 governorship election. Wike yarn dis one for im Wednesday press brief, explaining dat   e no fit support any candidate until di joint coalition of PDP and APC pipo for Rivers meet first. E add say di coalition na political strategy to unite loyalists from both parties because dem […]

todayMay 6, 2026 21

Lagos

Lagos Seal 2 Places Over Dirty Wastewater Waka

By : Jolayemi Olajide Lagos State Wastewater Management Office don seal some business centres for Lekki Phase 1 on Tuesday over illegal wastewater discharge. According to Commissioner for Environment, Tokunbo Wahab, on Wednesday, di way di area take dey smell, naim make dem waka di waka. Di Commissioner for Environment say di places dey release dirty water and oil waste inside public drain, blockage, and if you see di order, […]

todayMay 6, 2026 18

National

Presidency Insist Say Dem Nor Dey Bring Back Fuel Subsidy

By: Esther Ayoola Minister of Finance and Economy, Taiwo Oyedele, don tuk say gornment nor go bring back fuel subsidy despite complaints about high cost of living. (and dat if your eye bin dey enter subsidy return comot am oh) E yarn dis one on Tuesday for Paris as e follow President Bola Tinubu meet global investors. Oyedele say subsidy dey give our economic problem and distort market, so dem […]

todayMay 6, 2026 17

National

2027 Election: Oyo APC Group Reject Consensus Candidate

By: Esther Ayoola Some big men for di All Progressives Congress for Oyo State don oppose di imposition of consensus candidate on dem for 2027 election. Dem yarn dis one for meeting wey happen for University of Ibadan inside Otunba Subomi Balogun Hall on Tuesday, say di move fit scatter party structure if dem try am. One of di stakeholders wey sign the communiqué, Akinleye Olusegun, talk say dem want […]

todayMay 6, 2026 13

Lagos

Lagos Resident Cry Out Say NEPA Wan Wunjur Dem With Blackout

By: Esther Ayoola Residents for Ogunbowale, Taiwo and Adegbola streets for Ilasamaja area of Lagos don lament wetin nor good say dia area don turn to kingdom of darkness, and e don dey like dat for one month. Dia complain be say dis one sef go give criminal opportunate to come rob. According to dia leaders dat, all di times wey dem go Ikeja Electric office for Okota to ask […]

todayMay 6, 2026 15

Sports

Arsenal Knack Atletico, End Lookman Champions League Run

By: Esther Ayoola Arsenal don enter di 2025/2026 champions league final, beating Atletico Madrid 1-0 for dia semi final second leg for Emirates Stadium, carry 2-1 aggregate score. Ademola Lookman play for Atletico but im no really get chance to shine before dem replace am afta about one hour for Johnny Cardoso. Dis champions league final sef go be arsenal first afta 20 years, den, Arsenal play Barcelona for di […]

todayMay 6, 2026 15

Sports

Ikorodu City Burst Wikki Tourists 3-1, Celebrate 100 NPFL Goals

By: Esther Ayoola Ikorodu City don continue dia fine form for 2025/2026 NPFL season, beating Wikki Tourists 3-1 for Mobolaji Johnson Arena, Onikan, Lagos on Tuesday, boosting dia chance to qualify for continental football. Salami Farouk naim start di goal scoring for di 4th minute after e meet Alfred Odinaka header, e just slot am enter net sharp-sharp. Abayomi Ayodeji add another goal for 18th minute to double di lead […]

todayMay 6, 2026 16

obodo oyinbo

How 4 Pro-Palestine Activists Land UK Prison Say Dem Scata Isrealli Company

By: Esther Ayoola UK Court, Woolwich Crown don go convict 4 out of 6 pro-Palestine activists for criminal damage wey dem do during 2024 raid for Israeli defence company Elbit factory for Bristol. Prosecutors tuk say di four persons na members of Palestine Action group wey authorities ban, and na dem go organise di attack for di facility. Court also tuk say one of di accused dey guilty for hitting […]

todayMay 6, 2026 12

obodo oyinbo

Russia Strike Ukraine Hard Just Before Ceasefire Kpaing 26 Pipo

By: Esther Ayoola Say confusion gadinma, as Russia attack Ukraine with drone and missile, kpaing at least 26 persons and wunjur over 80, just few hours before ceasefire suppose start. According to reports from Russia, Di heavy bomb hit cities like Kramatorsk, Zaporizhzhia, Chernihiv and even Dnipro, an e cause serious damage. Zaporizhzhia alone lose at least 12 people, while Kramatorsk and other places also record casualties as attack continue. […]

todayMay 6, 2026 16

National

IGP Disu Launch New Police Unit, Promise Beta Policing

By: Esther Ayoola Oga Inspector General of Police, Olatunji Rilwan Disu don announce new police group, Violent Crime Response Unit (VCRU) to replace di former SWAT team. According to di IGP, di new unit go dey operate with strong intelligence support and dem go train di officers to respect human rights and combat crime. Baba Rilwan tuk dis one for press conference on Tuesday for force headquarters directing commissioners of […]

todayMay 6, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds