Blog no sidebar

Background

obodo oyinbo

 Iran Drop Revenge List, Name US, Israel Leaders

Edited by Ebi Oboko One Iran newspaper wey dem dey call,  Hamshahri, don release  list of 13 foreign leaders wey Iran dey plan  revenge for di kpaing of former Supreme Leader Ali Khamenei. Di list include leaders from United States, Israel and some European countries, an dis one comout late  Saturday. Khamenei son and successor, Mojtaba Khamenei, vow say revenge must happen, saying those wey dey on di list no […]

todayJuly 12, 2026 15 12

obodo oyinbo

NATO, EU Leaders Mourn US Senator Lindsey Graham

Edited by Ebi Oboko NATO boss, Mark Rutte and European Union chief Ursula von der Leyen don mourn US Senator Lindsey Graham wey kpai, kpai recently,  age of 71. Graham, wey be close ally of US President Donald Trump, reportedly kpai on Saturday after brief and sudden illness. Rutte describe Graham as strong supporter of America and NATO, wey also work hard to help end Russia war against Ukraine. Von […]

todayJuly 12, 2026 10 12

Sport Yarns

Power Slap Hulk Challenge Anthony Joshua to Fight

Edited by Ebi Oboko Nigerian Power Slap heavyweight, Kabiru Adediran wey people sabi as "Hulk", don challenge British-Nigerian boxing star Anthony Joshua to one fight. Hulk tok say nor be cruise oh dat, im go like  enter ring with Joshua wey e call im role model. According to am, even if Joshua beat am, di fight fit change im life because e go still collect beta money. Di former Davido […]

todayJuly 12, 2026 12 2

Sport Yarns

How Flamingos take  Fly Enter 2026 U-17 Women World Cup

Edited by Ebi Oboko Nigeria U-17 women team, di Flamingos, don qualify for 2026 FIFA U-17 Women's World Cup after dem beat Benin Republic 5-3 for second leg in Lomé, Togo. Di victory give Nigeria 8-5 aggregate win and secure one of Africa qualification tickets for di tournament. Queen Joseph shine well with hat-trick, while Mary Akpan Dunstan and Esther Enne Stephen also score for di Flamingos. Di 2026 FIFA […]

todayJuly 12, 2026 8

National

President Tinubu Give Kudos to Security Agencies Over Oyo School Pikins Rescue

Edited by Ebi Oboko Wi oga Presido, Bola Tinubu don express joy as security agencies rescue di school pikin dem and teachers wey kidnappers hold for 56 days for Oriire community, Oyo State. Baba Seyi  hail di military, DSS and Nigeria Police for di successful operation wey lead to di arrest of eight suspected kidnappers while security operatives neutralise oda gang members. Tinubu also sympathise with di victims and dia […]

todayJuly 11, 2026 17 3

obodo oyinbo

Trump Raise Alarm, Warn Iran Not to Try Nonsense

Edited by Ebi Oboko US Presido,  Donald Trump don warn say America go completely destroy Iran if dem try say naim him Iran dey target for  office to Kpai. Trump write for him Truth Social page say plenty missiles don ready and di US military don receive order to respond if any attack hapun. According to am, di military fit launch massive operation against Iran and continue am for one […]

todayJuly 11, 2026 17 3

National

Tinubu, Shettima to Fly APC Flag for 2027 Election

Edited by Ebi Oboko All Progressives Congress, APC, don officially retain Vice Presido, Kashim Shettima as running mate to wi oga  Presido,  Bola Tinubu for di 2027 presidential election. Di party don submit di names of Tinubu and Shettima as dia presidential candidates for di poll. APC National Publicity Secretary, Felix Morka, tok say di party get confidence say e go win and remain for power after di 2027 general […]

todayJuly 11, 2026 12

Sport Yarns

Spain Knock Belgium Out, Set for France Showdown

Edited by Ebi Oboko Spain don beat Belgium 2-1 to qualify for the World Cup semi-final, where dem go face France. Fabian Ruiz score first for Spain before Charles De Ketelaere equalise for Belgium before halftime. Mikel Merino later score di winning goal after Belgium substitute goalkeeper Senne Lammens fumble the ball. Spain now don set big semi-final clash with France and Kylian Mbappe for Tuesday.  

todayJuly 11, 2026 13 7

OBODO NAIJA

Ajibade, Oshoala Lead Super Falcons Squad for WAFCON

Super Falcons coach, Justine Madugu, don release 25-player squad wey go represent Nigeria for 2026 Women Africa Cup of Nations for Morocco. Captain Rasheedat Ajibade, goalkeeper Chiamaka Nnadozie and striker Asisat Oshoala dey among di players wey go defend Nigeria continental title. One big surprise for di list na say defender Ashley Plumptre no make di final squad despite her strong performance for di team before. Nigeria, wey don win […]

todayJuly 11, 2026 13 3

Sport Yarns

Sinner, Zverev One Match Away from Wimbledon Glory

Jannik Sinner don beat Novak Djokovic straight sets 6-4, 6-4, 6-4 to qualify for di Wimbledon final and stop di Serbian legend from chasing him 25th Grand Slam title. Alexander Zverev too nor waste time as e brush aside British wildcard Arthur Fery 7-6, 6-2, 6-4 to book him own place for di final. Now, Sinner and Zverev go face each other for Sunday to battle for di Wimbledon trophy.

todayJuly 11, 2026 15 3

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds