Blog no sidebar

Background

OBODO NAIJA

FG Give Committee Free Hand To Torch Light Di Death Of 37 Pipu For Niger

Federal Gornment don give di 10-pipu committee full hand to touchlight how 37 pipu wey Nigerian Security and Civil Defence Corps gbab for Niger State take kpai on Thursday, September 17. Interior Minister, Olubunmi Tunji-Ojo, tok dis one for Abuja on Tuesday, September 22, saying di committee fit bring experts, check documents and facilities, visit places connected to di matter. E say di committee fit also ask members of di […]

todaySeptember 22, 2026 18

Lagos

Lagos Gornment Promise Safer Schools For Childrensis

Lagos State Gornment say e dey renew im commitment to make sure say, schools dey safe for childrensis and protect dem from abuse, fear and other forms of jaguda. Na di Commissioner for Lagos State Ministry of Basic and Secondary Education, Hon. Jamiu Tolani Alli-Balogun, tok dis one on Tuesday, September 22, saying schools suppose be places where childrensis dey feel safe, valued and protected as dem dey learn and […]

todaySeptember 22, 2026 14

Lagos

Police Gbab Suspected Cultist For Ikorodu

Di Lagos State Police command don gbab one suspected cultist, 36-year-old Muyideen Olatunbosun, during anti-crime patrol for Idi-Iroko, Ogolonto and Agric area of Ikorodu. Police gbab am as dem dey do patrol for that side, collobi better informate on top some doings,  kon stop and search di suspect body, na so dem see one rubber-made pistol, one axe, criminal charms and one hard drug wey dem call “Ice”. Di suspect […]

todaySeptember 22, 2026 16

OBODO NAIJA

Anyim Say Tinubu No Need Dey UNGA Every Time

Former Senate Presido, Pius Anyim say Nigerians know say Presido Bola Tinubu dey on short leave, as e defend di Presio absence from di ongoing United Nations General Assembly for New York. Anyim tok dis one on Monday, say Tinubu fit send Vice Presido, Kashim Shettima to represent Nigeria for di UN meeting. E say UNGA no be only di main General Assembly, as e say UNGA no be only […]

todaySeptember 22, 2026 18 32

OBODO NAIJA

Federal Gornment Say NEPA Bill Nor Go Increase

Minister of Power, Joseph Tegbe, tok on Monday for Abuja say Federal Gornment no get plan to increase electricity tariff, as gornment dey focus to improve power supply and fix problems for di electricity sector. Tegbe make dis statement for media meeting for Abuja to mark im first 100 days for office, covering June 8 to September 16, say gofment no wan put extra money on NEPA bill. He say […]

todaySeptember 22, 2026 14

Sports

Peter Fury Warn Say Joshua Fit Knock Out Tyson Fury

Peter Fury, wey be Tyson Fury uncle and former trainer, don warn say Anthony Joshua fit knock out Tyson when dem finally meet for ring. Peter talk dis for interview, say na only two things fit happen, either Tyson go outbox Joshua and beat am, or Joshua go find im target and hand Tyson di first knockout loss of im career. E say di outcome go depend on di game […]

todaySeptember 22, 2026 13

Sports

Awoniyi Don Return Super Eagles, Replace Osimhen For AFCON Qualifiers

By: Ayobami Dada Coventry City striker, Taiwo Awoniyi, don return to Super Eagles squad as e replace Victor Osimhen for di 2027 AFCON qualifiers against Madagascar and Guinea-Bissau. Di Nigeria Football Federation, NFF, announce Awoniyi call-up as di Super Eagles dey prepare for di important qualifying matches. Awoniyi wey don miss recent international games go give coach Eric Chelle another option for attack as e dey fight for place inside […]

todaySeptember 22, 2026 14

obodo oyinbo

Big Forest Fire and Smoke Dey Choke Indonesia, Malaysia And Singapore

By: Ayobami Dada Big forest fire for Indonesia still dey burn evenas plenty aeroplane and thousands of pipo wey dem send go fight am never fit quench di fire, and bad smoke don cover parts of Indonesia, Malaysia and Singapore for weeks. Indonesia Cabinet Secretary Teddy Indra Wijaya say dem dey use aeroplane and workers for ground to fight di fire, push di smoke back and protect people from di […]

todaySeptember 22, 2026 11

National

Wike Say Tinubu Give Makinde N50bn Despite Political Wahala

By: Ayobami Dada FCT Minister, Nyesom Wike, don tok say, Presido Bola Ahmed Tinubu do wetin e fit do to support Oyo State Govo, Seyi Makinde, even after di political wahala wey happen between dem after di 2023 election. Wike tok dis for TV siddon tok on Monday, as e answer question on whether Tinubu treat Makinde well despite di support wey di Govo give am for di 2023 presidential […]

todaySeptember 22, 2026 13

National

Workers Tell Tinubu: “N500 Fuel Or N500,000 Minimum Wage!”

By: Ayobami Dada Civil servants under Joint National Public Service Negotiating Council(JNPSNC), Trade Union Side, don write President Tinubu say hunger and hardship don squeeze workers tire, make government move fast. Dem dey ask government make petrol price drop to N500 per litre, give workers Wage Award, plus add money to dia salary and allowances. Dem also want government set up committee to sit down negotiate new National Minimum Wage […]

todaySeptember 22, 2026 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds