Blog no sidebar

Background

OBODO NAIJA

Oluremi Tinubu Lunch Food Bank

By: Yusuf Abuh Nigeria First Lady, Senator Oluremi Tinubu, A.k.a Iya kuli kuli, A.k.a Iya Alakara, A.k.a nawa mama be dis don go throw beta salutate give Kogi State Govo, Ahmed Usman Ododo for di beta National Community Food Bank wey im build for Lokoja, to stop kpaturekor doings. Di senior woman first lady, porporly dis mata during, on ogbonge visit to inspect diĀ  project. She talk say di modern […]

todayJuly 13, 2026 7

Lagos

LAWMA Clear Apapa Black Spots

By: Yusuf Abuh Lagos dirty management senor men don begin ogbonge clean-up pikopiko doings clean Apapa area of Lagos to clear illegal waste and improve sanitation. For statement, di agency MD/CEO, Dr Muyiwa Gbadegesin, say many of di dirty spots dey remain because some residents and businesses dey avoid approved waste collection channels to escape payment. Im warn say LAWMA go continue to remove illegal dumps and sanction pipo wey […]

todayJuly 13, 2026 9

Lagos

Lagos Court Sentence Man To Kpai By Hanging

By: Yusuf Abuh Lagos State High Court wey dey sit for Ikeja don sentence Justice Odey to death by hanging after court find am guilty say e kpai 35-year-old woman, Benedict Agara. Court hear say di killing hapun on April 3, 2021, for Jakande Housing Estate, Lagos, during one fight wey involve one woman wey dem identify as Amina. Justice Modupe Nicol-Clay rule say prosecution prove di murder case beyond […]

todayJuly 13, 2026 6

National

INEC Shift Deadline for Presidential, NASS Candidate List

By Ebi Oboko Independent National Electoral Commission (INEC) don extend di deadline for political parties to submit names and credentials of candidates wey go contest 2027 presidential and National Assembly elections. Di electoral body say parties now get until midnight on Tuesday, July 14, instead of di earlier Saturday, July 11 deadline. According to INEC, di extension follow appeals from some political parties wey complain say dem face challenges to […]

todayJuly 12, 2026 14 16

Sport Yarns

Senegal Sack Coach Pape Thiaw After World Cup Crash

Edited By Ebi Oboko Senegal don sack dia head coach, Pape Thiaw, after di team crash comot for Round of 32 for 2026 FIFA World Cup. Senegal Football Federation tok say dem don sack Thiaw and all di coaching crew after executive committee meeting on Sunday. Di federation presido, Abdoulaye Fall, go address journalists on Monday to explain why dem take di decision and wetin dey next for di national […]

todayJuly 12, 2026 11 3

National

NDLEA Gbab South African Woman With Heroin for Abuja Airport

Edited by Ebi Oboko Di National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) don gbab one 38-year-old South African woman, Will Ann, for Nnamdi Azikiwe International Airport, Abuja,say she carry 5.75 kilogrammes of heroin enter Nigeria. NDLEA spokesman, Femi Babafemi, tok say operatives arrest di suspect during inward clearance of Qatar Airways Flight QR1433 from Doha after dem discover 14 big wraps of heroin wey she allegedly hide inside two suitcases. Babafemi […]

todayJuly 12, 2026 14 14

foreign

Russia Rain Missiles, Drones on Ukraine, kpai Ā Four Pipo

Edited by Ebi Oboko Russia launch don go Ā fresh drone and missile attacks on Ukraine overnight, kpaing at least four people. According to Ukrainian officials, Di attacks happen just one day before Ukraine allies go meet for Paris to discuss fresh ways to pressure Russia make di war end. Ukraine air defence system don dey struggle as Russia continue to fire ballistic missiles in recent weeks.

todayJuly 12, 2026 17 19

Sport Yarns

England, Argentina Renew Old World Cup Rivalry

Edited by Ebi Oboko England and Argentina go face each other for one heavyweight World Cup semi final on Wednesday after both teams beat Norway and Switzerland for quarter final. Argentina, with Lionel Messi, dey chase back-to-back World Cup title, while England dey hope to Ā end dia 60-year wait for major trophy. Winner of di match go face either France or Spain for di World Cup final on July 19. […]

todayJuly 12, 2026 8 2

Lagos

How Lagos Flood Carry Six-Year-Old Girl

Edited By Ebi Oboko One Lagos resident , Ademola Oloyede, Ā cry wetin nor gud explain how flood take Ā carry im six-year-old daughter, Asabi, during heavy rainfall for Okeleye, Charity area of Lagos State. According to am, di rain start on June 28 and later turn to serious flood wey break church fence before water rush enter dia compound. Oloyede say im dey work when dem call am, but by di […]

todayJuly 12, 2026 11

Local

Anambra Ban School Graduation, Christmas Party Again

Edited by Ebi Oboko Anambra State Universal Basic Education Board (ASUBEB) don remind all public primary and junior secondary schools for the state say graduation ceremonies, Christmas parties and graduation levies still dey banned. For circular wey Executive Chairman Dr. Justina Anyadiegwu sign on July 10, 2026, ASUBEB say the directive na part of Anambra State Gornment policy for basic education schools. Di Ā board order Local Government Education Area officers […]

todayJuly 12, 2026 22 16

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

Ā 

listen with your app

This will close in 0 seconds