Blog no sidebar

Background

OBODO NAIJA

PDP Start Fresh Reconciliation To Join Back Factions

Di Peoples Democratic Party don start fresh reconciliation to join back di aggrieved factions wey dey inside di party. Di National Working Committee wey Tanimu Turaki (SAN) dey lead, supported by PDP govos na im dey  yarn dis one for Abuja on Wednesday. Turaki talk say, From last night and to dis morning, di reconciliation don dey get small head. E explain say di move follow one advice from Court […]

todayMarch 25, 2026 7 2

OBODO NAIJA

How Abuja Court Carry $13 Million From Lagos Socialite Aisha Give Federal Gorment

Federal High Court for Abuja don send order say di $13 million wey dey linked to Lagos socialite, Aisha Achimugu, and her company, Oceangate Engineering Oil & Gas Ltd,  say right now, don give   Federal Gornment di money. Justice Emeka Nwite give di judgement on Wednesday say  di EFCC don prove beyond doubt say di money di madam kpake am fraudulently. Di Court  say, di company no fit explain where […]

todayMarch 25, 2026 5

obodo oyinbo

US Send 15-Point Peace Plan To Iran

Iran don receive 15-point peace plan from US, and dat na Pakistan deliver am as intermediary dis week to try settle di nuclear issue. Di plan, wey dem no show to  public, fit help stop some of Iran nuclear facility and US suppose also remove sanctions from Iran. One Israeli minister explain di mat give tori pipo on Tuesday say di plan fine for paper, but e be like say […]

todayMarch 25, 2026 6

OBODO NAIJA

Gunmen Kill 9 Soldiers, 1 Policeman, Burn Military Trucks For Kebbi

Gunmen don launch one deadly ambush for Shanga Local Government Area, Kebbi state  kpaing about nine soldiers and one police officer on Tuesday night. Governor Nasir Idris confirm di attack and condemn di killing. Eyewitnesses share say di security operatives dey go operation for Giro Masa community when di gunmen surprisingly attack dem. Say di incident cause serious panic as dem burn two military trucks, while di community still dey […]

todayMarch 25, 2026 3

obodo oyinbo

US Police Arrest Driver Wey kpai Nigerian Graduate Fadero

Metropolitan Nashville Police for US don arrest one driver wey dey link to fatal hit-and-run wey kpai one Nigerian graduate, Oluwalayomi Fadero. Report from local station WSMV4 say di mata na since on Friday after di suspect, Ray Eugene Padgett, thief one vehicle come dey run. Di owner of di truck trace am reach one area, but when di suspect notice say dem dey follow am, e reverse motor jam […]

todayMarch 25, 2026 6

OBODO NAIJA

Trailer Askident Kpai Two Pipo For Ibadan

Two people don go kpai for one serious askident  wey happen on Wednesday for Beere Roundabout inside Ibadan, Oyo State capital. Police tuk, tuk, Ayanlade Olayinka, na im dey konfamte dis mata give tori pipo, say one man and one woman die immediately when one Mack truck wey belong to oil and gas company lose control as e dey come down from Beere area. According to am, di truck lose […]

todayMarch 25, 2026 11

Lagos

Lagos Govment Plan Relationship Support To Stop Domestic Violence For House

Lagos State Domestic and Sexual Violence Agency (DSVA) don expand dia relationship support services for residents of Lagos to help stop abuse before e start. For statement wey dem share on Tuesday for dia X handle @Lagosdsva, di agency  say di service go give confidential guidance to singles and couples across di state. Dem explain say di programme go cover pipo wey dey date, those wey dey prepare for marriage, […]

todayMarch 25, 2026 6

Sports

Jannik Sinner Break Record, Win 28 Sets Straight For Miami Open

Jannik Sinner don make history, wining again for Miami Open, beating Alex Michelsen 7-5 7-6 (7-4). Di Italian, wey be world number two, like dis now don win 28 sets straight for ATP Masters 1,000 events. For di second set, Sinner nearly loss, im dey 5-2 behind before im comeback win for tie-break. Im sti win di last two Masters 1,000 tournaments, Indian Wells and Paris, not losing any set.

todayMarch 25, 2026 6 2

Sports

15 Super Eagles Players Land For Antalya Camp

Fifteen players don land for Super Eagles camp for Antalya, Turkey, as dem dey prepare for international friendly match wey dem go play against Iran and Jordan dis month. According to Super Eagles tuk, tuk person Promise Efoghe, say na 15 players don report  for camp, but forward Samuel Chukwueze and goalkeeper Maduka Okoye go join later. Coaches and officials don reach camp to arrange everything before players land. Assistant […]

todayMarch 25, 2026 7 3

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app