Blog no sidebar

Background

obodo oyinbo

Court Grant Former Brazil Presido House Arrest 

Former Brazilian Presido, Jair Bolsonaro don get temporary house arrest after im hospital stay for bronchopneumonia. On Tuesday, Alexandre de Moraes tuk say im approve 90 days house arrest for humanitarian reason, an dem fit extend if medical need dey. Bolsonaro, wey dey 71, dey serve 27-year jail sentence wey court give am for 2022 attempted coup. While im dey hospital, im announce say im pick im pikin, Flavio Bolsonaro, […]

todayMarch 25, 2026 7

obodo oyinbo

U.S Presido Trump Again Says U.S Dey Tuk With Iran To End Di War 

US Presido Donald Trump  again say dem still dey try negotiate with Iran, even as Iran yarn say di tuks na fake news. According to report U.S and Israel sti attack Iran yesterday, and for one strike for south Tehran, at least 12 pipo kpai and 28 wunjor. Iran and Hezbollah sti  fire new set of missiles reach Israel, including Tel Aviv and di north, kpaing one person and wunjor […]

todayMarch 25, 2026 8

OBODO NAIJA

FG Apologise For Blackout, Promise Say Dem Go Fix Power Wahala

Federal Gornment say sorry to Nigerians, say dem  fail to meet up for power supply. Oga Minister of Power, Adebayo Adelabu, tuk dis one for press conference wey e hold, take explain im achievements for di past three years for di office. E say wia di gbege take hapun na because of no gas supply based on plenty money wey dem owe di gas suppliers. Adelabu still con go tuk […]

todayMarch 25, 2026 8 1

OBODO NAIJA

How FG Share Beta N32 Billion Funds For Primary Health Centres

Federal Gornment don approve say dem go release N32 billion to health facilities under di Basic Health Care Provision Fund. Coordinating Minister of Health and Social Welfare, Muhammad Ali Pate, tuk dis one for dia  quarterly meeting dem hold to check how health sector dey work under President Bola Tinubu health renewal project. Pate talk say di money wey dem dey release through BHCPF go reach health facilities across di […]

todayMarch 25, 2026 10 1

National

APC Screening Committee Clear Nentawe Yilwatda

Aspirants Screening Committee of All Progressives Congress National Convention 2026 on Tuesday don screen party National Chairmo Nentawe Yilwatda for APC National Convention 2026. Committee wey Biodun Oyebanji lead for Abuja ask Yilwatda make e take bow, as dem praise am for im leadership. Say di screening na for aspirants wey don buy and submit dia Expression of Interest and Nomination Forms, as dem dey prepare to contest for different […]

todayMarch 25, 2026 9 1

OBODO NAIJA

Naija, Switzerland Join Hands For Free Trade To Tighten Dia Relationship

Naija and Switzerland don agree to make dia palship strong for trade, skills, migration, security, and culture matas. To show workings, dat like dis now, Switzerland don promise to return Benin bronzes and artefacts to Nigeria. Vice Presido, Kashim Shettima na dey convasate dis mata when e meet im Swiss counterpart, Ignazio Cassis, for Abuja airport on Tuesday. Dem tuk about possible free trade between Nigeria, AfCFTA, and Switzerland, plus […]

todayMarch 25, 2026 9 1

OBODO NAIJA

VP  Shettima Welcome Dauda Lawal Join All Progressives Congress

Vice Presido, Kashim Shettima on Wednesday for Abuja don go receive Zamfara State Governor Dauda Lawal and im supporters into All Progressives Congress (APC) on behalf of  oga Presido, Bola Tinubu. Oga vice Presido yarn every every for di ceremony, say Tinubu dey work seriously through security agencies to end di insecurity for di obodo naija. Shettima explain say Lawal joining APC, e go hellep beta collabo and support efforts […]

todayMarch 25, 2026 9 1

National

Makinde Clear Air, Konfam Loyalty To PDP

Oyo State Govo, Seyi Makinde, don dismiss report say, im nor dey comot from Peoples Democratic Party (PDP). Di mata of im defection, come out, few days afta Makinde, Peter Obi and Seriake Dickson waka meet Rabiu Kwankwaso for Kano. Im clear dis mata for meeting with PDP people from all di 33 Local Government Areas for Ibadan. Makinde  say, PDP still dey strong, and di party go still take […]

todayMarch 25, 2026 13 1

Lagos

Lagos Gorment Promise To Deliver Ogbonge Security For 2026 Lagos Fanti Carnival

Lagos State Gornment say, like dis now dem dey expect nothing less than 40,000 tourists and pipo wey go participate for di 2026 Lagos Fanti Carnival. Madam Commissioner for Tourism, Arts and Culture, Toke Benson-Awoyinka, na im dey yarn dis one for news tuk on Tuesday. Madam Commissioner say security go mount every wia for di event wey go hold on April 6, 2026, for Tafawa Balewa Square (TBS), Lagos. […]

todayMarch 25, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app