Blog no sidebar

Background

National

NLC Reject Governors New Minimum Wage Offer

By: Esther Ayoola Naija Labour Congress (NLC) don reject di N100,000 minimum wage proposal wey di Nigeria Governors’ Forum (NGF) carry come. NLC tuk, tuk, Benson Upah, naim go tok for interview on Sunday say with di way country hard now, workers need up to N1 million as realistic living wage. Dis one dey hapun afta di NGF Chairmo and Governor of Kwara State, AbdulRahman AbdulRazaq, disclose say governors dey […]

todayJune 1, 2026 6

National

Obasanjo Praise Lagos Family Wey Turn Cancer Loss To Campaign To Save Pipo Life

By: Esther Ayoola Former Presido, Olusegun Obasanjo don praise one new campaign wey dey fight cancer through awareness and early detection. Baba Obasanjo yarn dis one on Sunday for inside im Presidential Library for Abeokuta, during one event wey 'Lagos to the World Initiative' organise. Di event na for remembrance of di founders wey be mama and sister wey  cancer show shege. Obasanjo tell di family say wetin dem do […]

todayJune 1, 2026 5

National

Atiku, Hayatu-Deen Meet For Lagos, Try Settle ADC Primary Wahala

By: Esther Ayoola Former Vice Presido and ADC presidential candidate, Atiku Abubakar, on Sunday don go meet behind closed doors with im former rival, Mohammed Hayatu-Deen, for im Lagos house as part of move to settle differences afta di party primary. Di meeting dey hapun few days afta Atiku win di ADC presidential ticket and collect di party flag afta dem declare am winner of di primary election. Some party […]

todayJune 1, 2026 5

south west

Tinubu OK 1,000 Forest Guards With Special Rescue Team For Oyo Kidnap Victims

By: Esther Ayoola Wi Oga Presido Bola Tinubu don approve make dem recruit 1,000 forest guards and arrange special rescue team afta gunmen kidnap teachers and students for Oyo State. Na baba tuk, tuk, person, Bayo Onanuga, naim reveal dis one on Sunday afta one Federal Gornment delegation visit Esiele and Yawota communities wia dis badness sup  on May 15, 2026. Apart from di forest guards, baba Seyi also direct […]

todayJune 1, 2026

south west

Gbajabiamila And Security Chiefs Meet Families Of Kidnapped Students, Share Tinubu Message

By: Esther Ayoola One heavy Federal Gornment team on Sunday don go visit Ogbomosho area for Oyo State to meet with community leaders and families of di teachers and students wey gunmen kidnap on May 15, 2026. Di big-wigs inside di delegation join include di Chief of Staff to di Presido, Femi Gbajabiamila, National Security Adviser Nuhu Ribadu, Minister of Defence Christopher Musa, and di Inspector General of Police, Olatunji […]

todayJune 1, 2026

Lagos

How LSSTF And Police Use Helicopter Take Fly Check Area For Jaguda Boys Inside Lagos

By: Esther Ayoola Di Lagos State Security Trust Fund (LSSTF) don join hand with Lagos State Police Command and the Naija Police Air Wing touch light Lagos from air, patrols across di state to make sure say everywhere secure. Di Executive Secretary of LSSTF, Ayodele Ogunsan, naim yarn dis one put for dis one inside statement wey im release on Sunday. Ogunsan tuk say di waka wey dem do across […]

todayJune 1, 2026 2

Sport Yarns

Nadal Explain How Wunjury Take Spoil Im Career For Tennis 

By : Jolayemi Olajide Former world number one, Rafael Nadal don open secret yarn of how im take carry  plenty wunjury  throughout im tennis career. Im yarn dis one ontop im  new Netflix documentary wey BBC Sport report on Friday. di 22-time Grand Slam champion tuk say e make hard decisions about im health just to continue winning. According to Nadal, if  to say wunjure nor worry am, e for […]

todayMay 29, 2026 21 2

obodo oyinbo

Russian Drone Crash Enter Romania Apartment, Wunjure Two Pipo

By : Jolayemi Olajide Romania and dia NATO frens  don  cut chain after Russian drone go  jam  Romanian airspace and crash for apartment building for eastern town Galati, wunjure two pipo. Na Romanian Foreign Ministry tuk dis tuk,  say di incident wey hapun during overnight attack on  Ukraine,  say e spoil international law. According to Authorities say dem track the drone before e finally crash ontop  per house, cause fire.

todayMay 29, 2026 6

OBODO NAIJA

Defence Minister Score Tinubu Gorment 70% For Security

By : Jolayemi Olajide Defence Minister,  Christopher Musa, don  drop micro soft word say wi oga Presido, Bola Tinubu  na senior man im be for security. Dat if im na teacher im go score baba seyi administration between 65 to 70 per cent on top security mata. Musa yarn dis one for  live TV on Friday  as Wi oga presido dey mark three years for office, say regular terrorism don […]

todayMay 29, 2026 12

OBODO NAIJA

NANS Plan protest on Monday for Oyo state  Students, Teachers wey jaguda kidnap

By : Jolayemi Olajide Meanwhile,  Presido of National Association of Nigerian Students, Akinteye Babatunde, don announce give student across obodo naija say on Monday, all of dem go come out do we nor go gree, we no go gree protest for di release of  Oyo State students wey Jaguda boys  over di kidnap. For one invitation wey im release on Friday, Akinteye talk say di steady maltreatment wey dey jaguda […]

todayMay 29, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds