Blog no sidebar

Background

Lagos

Train Ram Car For PWD Railway Crossing, Driver Escape Injury

By: Kofoworola Olayinka A 55-year-old driver escape injury after train ran im Honda car for PWD railway crossing for Lagos as di vehicle suffer heavy damage. Di Lagos State Traffic Management Authority, LASTMA, say im officials and security personnel rescue di driver and clear di damaged car from di railway track. Di agency say di train wey dey head towards Agege continue im journey after dem clear di track, but […]

todayOctober 9, 2026 10

Politics

ACF Tell FG Make Dem Set Time To Reduce Naija Suffering

By: Kofoworola Olayinka Di Arewa Consultative Forum don urge Federal Gorment to admit say e miscalculate di impact of economic reforms on Naija pipu and set timeto improve dia living conditions. Di Forum Publicity Secretary, Professor Tukur Mohammed-Baba, tuk dis as e point to rising cost of food, rent, transportation, electricity and insecurity as signs of di hardship wey Naija dey face. Mohammed-Baba say gorment suppose introduce measures within three […]

todayOctober 9, 2026 7

Sports

CAS Table Senegal Appeal Based on AFCON Title Drama

By: Kofoworola Olayinka Court of Arbitration for Sport don start to hear Senegal appeal, dia on side of di story, on how  dem take win  Africa Cup of Nations title, CAF con carry  give Morocco via Gmail. U sabi say dis one  hapun for Lausanne, ten months, after Pape Gueye extra-time goal give Senegal win against di host country. Wetin really play dat, na when di  Teranga Lions players comot […]

todayOctober 9, 2026 8

obodo oyinbo

Trump Promise No Attack For Iran Again Until November 3rd

By: Mariam Ajayi Iran military force don konfamate say dem dey do operation every night inside Strait of Hormuz to catch any ship wey break dia law. Mean wider, President Donald Trump say US for dia on part sef dey tuk with Iran and promise say, dem nor go attack dem before di November 3 midterm election. Already Dis tension don make oil price jump up by four percent, carry […]

todayOctober 9, 2026 10

OBODO NAIJA

Atiku Condem FG 30 days Giveaway Petrol Plan

By: Mariam Ajayi Pepper bodi every wia as wi Federal gorment take announce say dem wan package 30 days give away price for petrol inside NNPC filling stations across di obodo Naija. Latest to fire mouth untop di mata, na di Africa Democratic Congress, ADC, presidential candidate, Atiku Abubakar. Di b4 vice presido say di APC gorment na desperado naim dey do dem and dis wan nor go do anything […]

todayOctober 9, 2026 10

Lagos

Lagos Gorment Beg Youth To Put Bodi For Military Recruitment

By: Mariam Ajayi Lagos State Gornment don begin toast lagos youths wey dey between 18 and 26 years say make dem join  military sake of say di state need meet  dia recruitment quota. Say dis nor be to look and thruway face like say insecurity nor concern youth, dat naija reallyneed beta collabo and energy to battle insecurity. Senior man Seco to di Gornment, Abimbola Salu-Hundeyin, naim drop dis micro […]

todayOctober 9, 2026 8

Entertainment

US Consul General Honours Nollywood Stars For Lagos

U.S. Consul General, Brandon Hudspeth, don host special reception for distinguished Nollywood actors and big names for Naija creative industry. Di private event wey happen for U.S. Consul General residence celebrate dia contributions to Nigerian storytelling and creative industry. Di gathering bring together Nollywood talents, industry leaders and cultural ambassadors wey dey help put Nigerian stories for global stage. Di event also highlight di strong connection between Hollywood and Nollywood, […]

todayOctober 8, 2026 17 1

Lagos

Hit And Run Driver Jam Teenager For Onipanu BRT Lane

By: Mariam Ajayi One teenage boy don land for hospital after hit and run driver jam am as e dey cross Onipanu BRT corridor dey go Fadeyi for Lagos State on Wednesday. Di boy sustain serious head and leg injuries for di accident, according to wetin di Permanent Secretary of LASEMA, Dr. Olufemi Oke-Osanyintolu, talk. LASEMA Cobra Team sharp-sharp run reach di scene within two minutes around 4:32 pm to […]

todayOctober 8, 2026 13

OBODO NAIJA

AAU Lecturer Kpai Inside Hotel Room For Edo State

By: Mariam Ajayi One senior lecturer for Ambrose Alli University, Ekpoma, Dr. Matthew Uwuigbe, don kpai inside one hotel room for Edo State after e reportedly lodge with one 21-year-old woman. Police say di woman comot go buy water for am, but when she come back, she see di lecturer kpai for di room and raise alarm, as police don arrest her, di hotel owner and manager for investigation. AAU […]

todayOctober 8, 2026 13 2

obodo oyinbo

China Don Put Forward Song Li To Head WHO

By: Kofoworola Olayinka China don nominate maternity health expert, Song Li, to become di next Director-General of World Health Organization, WHO. China Foreign Ministry spokesperson, Mao Ning, announce di nomination on Thursday, say e show Beijing strong support for and global health. Song Li, wey dey head Department of Women and Child Health for China National Health Commission, get 21 years experience for women and children health matters. She go […]

todayOctober 8, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds