Blog no sidebar

Background

Niger Delta

Amaewhule Join 15 Lawmakers Waka Comot From PDP

By: Alice Iduh Speaker of the rivers state house of assembly, Amaewhule Martins don waka comot from PDP join 15 oda members of di House of Assembly on Friday, as di session dey go on. Dem talk say di wahala inside PDP na why dem gatz japa comot from di party. Among di big names wey join di waka na Deputy Speaker Dumle Maol, Major Jack, Linda Stewart, Franklin Nwabochi, […]

todayDecember 5, 2025 4

south west

Supreme Court Don Shut Osun Ag Mouth Over Local Govt Money Wahala

By: Alice Iduh Supreme Court don cancel Osun State Attorney General, Oluwole Jimi-Bada, case, wey him file against  AGF, Lateef Fagbemi, over di local government funds wey dem dey hold. court talk say na only di people wey win election and don take office fit sue or get sued. Justice Mohammed Idris talk say di Federal Government dey wrong to hold di local government money, say e dey breach 1999 […]

todayDecember 5, 2025 8

south west

Oyo Man Fall Inside Well, Fire Service Drag Body Out

By: Alice Iduh Oyo State Fire Service don recover body of one 65-year-old man wey fall inside deep well for Oke-Oga Atipe, Idi-Aga, Ibadan. Di wahala happen Thursday, December 4, 2025, wen one Mr Damola call di fire service at exactly 9:42 a.m. report say man don waka enter di well. Fire officers, wey Assistant Chief Fire Superintendent Bamidele Samsudeen lead, rush go di scene, but sadly, dem only fit […]

todayDecember 5, 2025 5

National

Tinubu 65 Ambassadorial Nominees Brace For Senate Grilling

By: Rilwan Agbomeji Next week, wi Presido Bola Ahmed Tinubu 65 ambassadorial nominees go siddon for front of lawmakers for grilling, to know whether dem dey qualify or not. Three opposition senators wey yarn under cover don drop warning say dis screening no be cruise, na only people wey get brain, backbone and clean name go escape, because foreign mission work no be job for smallie dem. For Thursday main […]

todayDecember 5, 2025 24

Business

FG Go Pay Road Contractors Owed Money Before December 20

By: Esther Ayoola Tori don land, Federal Government don rush cool road contractors wey don dey protest over unpaid money, promise say all outstanding payments go land before December 20, 2025. Minister of Works, David Umahi, yarn dis one during reopening of Keffi Flyover for Nasarawa State, add say President Bola Tinubu don sabi di debt wahala and don approve special committee to check and clear all owed funds. Contractors […]

todayDecember 5, 2025 6

Entertainment

Imisi BBNaija Don Land: Ebute Metta Stand Still for Homecoming Showdown

By: Esther Ayoola Today, Imisi Ayanwale  di winner of tv reality show,   dey return to her Ebute Metta hometown for big  welcome party as fans gather make dem hail her home. She  win full N150 million grand prize back on October 5, 2025, and since then everybody don dey follow her matter with bumper to bumper.! As part of di plan, she don invite big names for entertainment from Bolaji […]

todayDecember 5, 2025 9

Lagos

Lagos Go Buy 100 New Trucks to Keep City Clean

By: Esther Ayoola Lagos State Gorment don yarn say dem go buy 100 new CNG compactor trucks next year as part of 10-year plan to make city clean. LAWMA Managing Director, Muyiwa Gbadegesin, talk say dem go dey add 200–250 new trucks every year until dem reach 2,000 1,000 for daily work, 1,000 for backup. E add say dis long-term plan go join state-wide household billing system, wey go help […]

todayDecember 5, 2025 4

Niger Delta

Edo Governor Don Appoint Dr Ebojele As Chief Press Secretary

By: Alice Iduh Edo State Govo don appoint Dr Patrick Ebojele as new Chief Press Secretary to Govo Monday Okpebholo. Before dis new job, Ebojele dey teach as lecturer for Federal Polytechnic, Auchi. Di appointment, wey Secretary to di State Government, Umar Ikhilor, sign confirm on Thursday, go make Ebojele take over from Fred Itua.

todayDecember 5, 2025 9

Lagos

Lagos Don Start Second Polio Vaccination Round to Protect Children

By: Esther Ayoola Lagos State  gorment  don drop ogbonge update dat, second round of polio vaccination for childrenses go start from Saturday, December 6 to Tuesday, December 9, 2025. Di campaign say na   Lagos State Primary Health Care Board with National Primary Health Care Development Agency, WHO, UNICEF and other partners dey run am to stop polio. Gorment talk say na follow-up after November 8, 2025 first phase, wey dem […]

todayDecember 5, 2025 3

Sports

Troost-Ekong – Wetin Make Me Retire From Super Eagles

By: Rilwan Agbomeji Super Eagles Captain, William Troost-Ekong don explain why e retire ahead of 2025 AFCON. Di 32-year-old defender wey don dey carry Naija flag for almost ten years don officially waka comot on Thursday, draw curtain on im international wahala. Even though Éric Chelle put im name for di provisional AFCON list, Ekong talk say e no go follow because na now im feel say time don reach […]

todayDecember 5, 2025 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app