Blog no sidebar

Background

obodo oyinbo

Mojtaba Khamenei Fit Take Over As Iran Supreme Leader

Say pikin of late Iranian leader Ali Khamenei, Mojtaba Khamenei, dey among di main people wey fit become new oga for Iran. Ahmad Khatami, one member of di Assembly of Experts, na im dey relate di mata to Iranian state media on Wednesday, say dem hope to vote “at di earliest opportunity” to choose di new leader. Other contenders include Alireza Arafi, Mohsen Araki, and Hassan Khomeini, wey fit also […]

todayMarch 5, 2026 9

Sports

Bayern Munich Eye Victor Osimhen To Replace Harry Kane

Bayern Munich don resume interest for Galatasaray striker Victor Osimhen, say dem need am if Harry Kane waka. Coach Vincent Kompany dey consider am because Kane dey attract Barcelona and other Premier League clubs. Kane don score 130 goals for 133 matches even though im never dey for Bayern for long. Since no offer don land yet, Bayern feel say Osimhen na di best replacement, if Kane move.

todayMarch 4, 2026 9

Sports

Atletico Madrid Stand Gidigba, Knock Barcelona Comot 4-3 For Copa Del Rey

Barcelona try dia best chase Atletico Madrid for Copa del Rey semi-final but God pass dem, losing 4-3 on aggregate. Marc Bernal score two goals and Raphinha score penalty, and still dem nor make am to di finals. Atletico hold strong, and now, go meet Real Sociedad or Athletic Club for di final. First leg, Barcelona don already lose 4-0, so e hard dem to do complete come back.

todayMarch 4, 2026 10

Lagos

Alcohol Companies Nor Gree For Sahcet Alcohol Ban

Workers of alcohol companies say dem go storm di National Agency for Food and Drug Administration and Control office for Lagos today to protest Federal Government ban on sachet alcohol and PET bottles wey small pass 200ml. Di protest, wey di Distillers and Blenders Association of Nigeria  dey organise, go start by 8:30am for Oshodi as dem say dem wan show dia anger over di decision. Dis one na di […]

todayMarch 4, 2026 11

Lagos

FG Declare Serious War Against Small Sachet Alcohol

Say Federal Gornment don start campaign to stop alcohol wey dey for small sachets and bottles wey no reach 200ml. Di ban wey start from January 1, 2026, go stop production, sale, and distribution of sachet and small bottles alcohol. Untop tuk tuk with tori pipo for Abuja, NAFDAC DG, Professor Mojisola Adeyeye, say dem don do plenty consultation and di ban na because many minors dey drink alcohol.

todayMarch 4, 2026 9

Sports

Ronaldo Japa Go Madrid As Middle East Wahala blow Hot

Al-Nassr captain and forward, Cristiano Ronaldo,  comot Saudi Arabia go Madrid, Spain, as tension for Middle East dey rise after US and Israel launch strike for Iran. According to reports on Tuesday, di 41-year-old football star fly comot Riyadh late for night inside im £61 million Bombardier Global Express 6500 private jet. Di move happen after serious attack for di region, as two drones hit US embassy for Riyadh overnight. […]

todayMarch 3, 2026 8

Sports

Scholes Want Ancelotti For Man United

Mancester United Legend, Paul Scholes don identify perfect manager, say im want Manchester United to sign Carlo Ancelotti. Since Michael Carrick take over from Ruben Amorim, e never lose match and don carry di team reach third position for Premier League table, pass Aston Villa, Liverpool and Chelsea. For Tv siddon talk, Scholes say e still wan see how Carrick go handle serious wahala and pressure before e fully support […]

todayMarch 3, 2026 7

OBODO NAIJA

Dangote Raise Petrol Price, Pump Fit Hit N1,000 Per Litre

Dangote Petroleum Refinery don raise dia factory price of petrol from N774 to N874 per litre. National Publicity Secretary of di Independent Petroleum Marketers Association of Nigeria, Chinedu Ukadike, na im share dis update on Monday. Based on dis, Say petrol fit cost between N980 and over N1,000 per litre for motorists depending on wia dem dey across Nigeria. Ukadike explain say di increase na because of di wahala for […]

todayMarch 3, 2026 5

OBODO NAIJA

DSS Arrest Man Wey Get Connect To Di Attack On Peter Obi For Benin City

Di Department of State Services, DSS don arrest one man, Udeme Monday Stephen, wey dem dey suspect say e plan di attack wey hapun for Benin City, Edo State, against 2023 presidential candidate of Labour Party, Peter Obi, on February 24. U sabi say, Jaguda boys attack Obi and some ADC chiefs wey bin dey do meeting to welcome former governorship candidate Olumide Akpata join dia party. According to report, […]

todayMarch 3, 2026 10

obodo oyinbo

Iran Drone Hit UK Base For Cyprus, Germany Warn Say NATO Fit Collect Too

Germany foreign minister Johann Wadephul  say attack fit hit NATO country after Iranian drone go hit British air base for Akrotiri, Cyprus. Im tell tori pipo, say, two oda drones sti try attack but dem  intercept dem. According to report, UK don dey do defensive military work for Middle East against Iran to protect dia forces. Wadephul explain to Deutschlandfunk say Germany soldiers fit defend demself, if dem come under […]

todayMarch 3, 2026 6

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app