Blog sidebar

Background

obodo oyinbo

US Police Arrest Driver Wey kpai Nigerian Graduate Fadero

Metropolitan Nashville Police for US don arrest one driver wey dey link to fatal hit-and-run wey kpai one Nigerian graduate, Oluwalayomi Fadero. Report from local station WSMV4 say di mata na since on Friday after di suspect, Ray Eugene Padgett, thief one vehicle come dey run. Di owner of di truck trace am reach one area, but when di suspect notice say dem dey follow am, e reverse motor jam […]

todayMarch 25, 2026 15

OBODO NAIJA

Trailer Askident Kpai Two Pipo For Ibadan

Two people don go kpai for one serious askident  wey happen on Wednesday for Beere Roundabout inside Ibadan, Oyo State capital. Police tuk, tuk, Ayanlade Olayinka, na im dey konfamte dis mata give tori pipo, say one man and one woman die immediately when one Mack truck wey belong to oil and gas company lose control as e dey come down from Beere area. According to am, di truck lose […]

todayMarch 25, 2026 19

Lagos

Lagos Govment Plan Relationship Support To Stop Domestic Violence For House

Lagos State Domestic and Sexual Violence Agency (DSVA) don expand dia relationship support services for residents of Lagos to help stop abuse before e start. For statement wey dem share on Tuesday for dia X handle @Lagosdsva, di agency  say di service go give confidential guidance to singles and couples across di state. Dem explain say di programme go cover pipo wey dey date, those wey dey prepare for marriage, […]

todayMarch 25, 2026 15

Sports

Jannik Sinner Break Record, Win 28 Sets Straight For Miami Open

Jannik Sinner don make history, wining again for Miami Open, beating Alex Michelsen 7-5 7-6 (7-4). Di Italian, wey be world number two, like dis now don win 28 sets straight for ATP Masters 1,000 events. For di second set, Sinner nearly loss, im dey 5-2 behind before im comeback win for tie-break. Im sti win di last two Masters 1,000 tournaments, Indian Wells and Paris, not losing any set.

todayMarch 25, 2026 16 2

Sports

15 Super Eagles Players Land For Antalya Camp

Fifteen players don land for Super Eagles camp for Antalya, Turkey, as dem dey prepare for international friendly match wey dem go play against Iran and Jordan dis month. According to Super Eagles tuk, tuk person Promise Efoghe, say na 15 players don report  for camp, but forward Samuel Chukwueze and goalkeeper Maduka Okoye go join later. Coaches and officials don reach camp to arrange everything before players land. Assistant […]

todayMarch 25, 2026 15 3

obodo oyinbo

Court Grant Former Brazil Presido House Arrest 

Former Brazilian Presido, Jair Bolsonaro don get temporary house arrest after im hospital stay for bronchopneumonia. On Tuesday, Alexandre de Moraes tuk say im approve 90 days house arrest for humanitarian reason, an dem fit extend if medical need dey. Bolsonaro, wey dey 71, dey serve 27-year jail sentence wey court give am for 2022 attempted coup. While im dey hospital, im announce say im pick im pikin, Flavio Bolsonaro, […]

todayMarch 25, 2026 13

obodo oyinbo

U.S Presido Trump Again Says U.S Dey Tuk With Iran To End Di War 

US Presido Donald Trump  again say dem still dey try negotiate with Iran, even as Iran yarn say di tuks na fake news. According to report U.S and Israel sti attack Iran yesterday, and for one strike for south Tehran, at least 12 pipo kpai and 28 wunjor. Iran and Hezbollah sti  fire new set of missiles reach Israel, including Tel Aviv and di north, kpaing one person and wunjor […]

todayMarch 25, 2026 14

OBODO NAIJA

FG Apologise For Blackout, Promise Say Dem Go Fix Power Wahala

Federal Gornment say sorry to Nigerians, say dem  fail to meet up for power supply. Oga Minister of Power, Adebayo Adelabu, tuk dis one for press conference wey e hold, take explain im achievements for di past three years for di office. E say wia di gbege take hapun na because of no gas supply based on plenty money wey dem owe di gas suppliers. Adelabu still con go tuk […]

todayMarch 25, 2026 20 1

OBODO NAIJA

How FG Share Beta N32 Billion Funds For Primary Health Centres

Federal Gornment don approve say dem go release N32 billion to health facilities under di Basic Health Care Provision Fund. Coordinating Minister of Health and Social Welfare, Muhammad Ali Pate, tuk dis one for dia  quarterly meeting dem hold to check how health sector dey work under President Bola Tinubu health renewal project. Pate talk say di money wey dem dey release through BHCPF go reach health facilities across di […]

todayMarch 25, 2026 20 1

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds