Blog sidebar

Background

OBODO NAIJA

Falana Drag FG To Court Based On Dia House Sharing Format Judges

By: Esther Daniel Human rights lawyer, Femi Falana, don threaten to drag di Federal Government go court over di luxury houses wey dem hand over to judges for Katampe area of Abuja. Inside statement, e explain diĀ  gesture as see finish and e no follow any law because other public servants no benefit from am. Falana talk dis after e watch di handover ceremony for television, saying di action dey […]

todayJuly 17, 2026 21

Sports

FIFA Pick Vinčić to Officiate Spain vs Argentina Final Showdown

By: Esther Daniel Slovenian referee Slavko Vinčić go dey handle di big stage on Sunday as FIFA pick am to officiate di 2026 World Cup final between Spain and Argentina. Di 46-year-old go become di first Slovenian referee wey go take charge of a World Cup final and di 23rd official for history to get di honour. FIFA Chief Refereeing Officer, Pierluigi Collina, give Vinčić di news during an emotional […]

todayJuly 17, 2026 22

south west

Ogun State Extend Work Break And To Pay ₦10,000 Transport TFare For Workers

By: Esther Daniel Ogun State Govo, Dapo Abiodun, don approve make di one-day-off-duty work palliative for eligible public and civil servants continue for di state. Di govnor put dis one or news statement give news tatafos for Ogun state. According to di govo Abiodun, di measures na to reduce di burden of transportation costs on workers and encourage dem to continue providing efficient and quality service to di people of […]

todayJuly 17, 2026 25

OBODO NAIJA

Malami Put Weight Say Im Must Fight Appeal Court Order Wey Seize Im 48 Properties

By: Yusuf Abuh Former Attorney-General of di Federation and Minister of Justice, Abubakar Malami, SAN, don announce say e go challenge di Federal High Court judgment wey order final forfeiture of 48 properties wey authorities link to am. For statement wey im Special Assistant on Media, Mohammed Bello Doka, release, Malami say e respect di court but e no agree with some parts of di judgment.   Di decision come […]

todayJuly 17, 2026 22

south west

How Police Gbab Papa Wey Use Hot Iron Burn Him 10-Year-Old Daughter Private Part

By: Yusuf Abuh Ondo State Police Command don kramp one man wey dem dey call Amos Paul inside Owo on Thursday because he allegedly use hot iron burn him own 10-year-old daughter private part. Di command tuk, tuk, DSP Abayomi Jimoh, naim put dis for statement on Friday say di suspect do dis wickedness to punish di small pikin because she piss for bed. Police detectives naim con go rescue […]

todayJuly 17, 2026 14

Lagos

Lagos Gornment Release General School Calendar For 2026/2027

By: Yusuf Abuh Lagos State Gornment on Thursday don officially release saka school calendar for di 2026/2027 session to make sure say all public and private primary and secondary schools run package wella together. Di Commissioner for Basic and Secondary Education, Jamiu Tolani Alli-Balogun, announce dis one inside Lagos after di Office of Education Quality Assurance (OEQA) hold big meeting with stakeholders to agree on resumption dates, mid-term breaks, and […]

todayJuly 17, 2026 21 2

Local

Delta Police Commissioner Beg Delta Kings And Chiefs For Joinbodi Policing

By: Yusuf Abuh Di Delta State Commissioner of Police, Yemi Oyeniyi, don urge traditional rulers to continue to partner with di police to wipe out kidnapping, cultism, and drug crimes for the state. Oga police tuk, tuk, SP Bright Edafe, make dis one known inside statement on Friday, July 17, 2026, after di CP visit di Ovie of Ozoro, Anthony Ogbogbo, Ibuka I, inside Isoko North Local Government Area on […]

todayJuly 17, 2026 19 2

OBODO NAIJA

Sowore Create New Mobile App For 2027 Election

By: Yusuf Abuh Di African Action Congress (AAC) presidential candidate, Omoyele Sowore, don officially launch one ogbonge mobile application wey dem call "SoworeNow" to gather support. Sowore announce dis technology movement on Thursday, July 16, 2026, through one video post wey he share on top im official Instagram page. With dis new application, supporters across di country fit easily get true update on top di campaign, connect with other members, […]

todayJuly 17, 2026 28

OBODO NAIJA

Federal Gornment Do Naming Ceremony For Lagos-Calabar Highway, Say Na Bola Ahmed Tinubu Coastal Highway

By: Yusuf Abuh Wi Federal Gornment don rename the Lagos-Calabar Coastal Highway as "President Bola Ahmed Tinubu Coastal Highway" to honor di presido for di project. Di Minister of Works, David Umahi, announce dis change on Thursday inside Abuja during media briefing. Umahi explain say di Ministry of Works take dis decision because of di long-standing vision wey oga Presido get to build di massive road project for di country. […]

todayJuly 17, 2026 17

obodo oyinbo

21 Childrensis Kpai As School Bus Crash For Uganda

By: Esther Daniel At least 20 pikin and one adult don kpai after one school bus carry students from excursion lose control and crash for Uganda. Police tok say di bus wey dey return from Sipi Falls comot from road, hit one big stone before e turn upside down. Three adults and several pikin still get wunjury, and dem dey receive treatment for hospital as police continue investigation. Road accidents […]

todayJuly 17, 2026 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

Ā 

listen with your app

This will close in 0 seconds