Blog sidebar

Background

Sports

Lookman Assist Make Atlético Madrid Beat Spurs 7-5 For UCL

By: Esther Ayoola Ademola Lookman give assist as Atlético Madrid qualify for UEFA Champions League quater finals, even though dem lose 3-2 to Tottenham Hotspur for di second leg. Lookman collect ball for counter, cut small for box corner, then pass am to Julian Alvarez wey score make e 1-1. Tottenham first goal na from Randal Kolo Muani, then Xavi Simons score two, one na penalty. Atlético second goal come […]

todayMarch 19, 2026 15

Sports

NFF Dey Drag FIFA Go Appeal Over DR Congo Player Wahala

Nigeria Football Federation don start process to appeal decision wey FIFA disciplinary committee give about dia protest against DR Congo. Dem bin lose di play-off final 4-3 on penalties for Morocco, but later complain say some DR Congo players no suppose play because of how dem take get passport. FIFA committee don reject di protest after many months, say dem no see enough reason to punish DR Congo. Now NFF […]

todayMarch 18, 2026 17

Sports

D’Tigress Lose Last Game To Germany 81–73 For FIBA Qualifiers

Nigeria women basketball team, D’Tigress, don end dia campaign for 2026 FIBA Women’s World Cup Qualifying Tournament with 73–81 loss to Germany for Villeurbanne, France. Germany control di game from start to finish, lead for every quarter and take charge for more than 33 minutes before dem pull clear for last quarter. Nigeria try fight back for second quarter, turn six-point deficit to 31–27 lead with one 10-0 run, as […]

todayMarch 18, 2026 15

Sports

Arsenal Enter Quarter Final As Chelsea Crash Out For Champions League Battle

By: Esther Ayoola Arsenal show strong hand as dem beat Bayer Leverkusen 2-0 to enter quarter-final of UEFA Champions League. Di North London club carry di tie 3-1 on aggregate afta ogbonge  performance for both legs. Eberechi Eze na im open scoring with Korrect fine goal before halftime. Later, Declan Rice add another goal for second half to seal di win. For Chelsea FC side, dem crash out afta Paris […]

todayMarch 18, 2026 19

Sports

Senegal Lose AFCON 2025 By Forfeiture As CAF Hand Morocco 3–0 Victory

By: Esther Ayoola Di Confederation of African Football Appeal Board don rule say Senegal forfeit di AFCON 2025 final, give Morocco 3–0, wining under competition rules article 84. Dem say Senegal break rules during di match, so Morocco protesting na Korrect and dem award di victory to Fédération Royale Marocaine de Football. For di case of Ismaël Saibari, dem reduce im punishment to two-match ban with one suspended, and cancel […]

todayMarch 18, 2026 16

obodo oyinbo

5.8-Magnitude Quake Hit Off Cuba Coast, No Casualty Report Yet

By: Esther Ayoola Say One 5.8-magnitude earthquake hit near di coast of Cuba early Tuesday, According to United States Geological Survey, e hapun for 11.6 kilometer deep, 49 km south-southwest of Maisi town. Cuba dey try fix electricity afta di whole island blackout. Aftershocks reach 4.7 magnitude, USGS say no danger at all, dat dem dey monitor di situation.

todayMarch 18, 2026 8

obodo oyinbo

President Trump Say France Go Escort Ships For Strait Of Hormuz If Things Cool Down

By: Esther Ayoola President Emmanuel Macron of France tuk on Tuesday say France fit hellep protect ships for Strait of Hormuz, but only if di situation don cool down. E tuk am for France, afta US Presido Donald Trump, beg im  allies to help secure di waterway wey Iran don block because of di US and Israel attack. Macron explain say oil price don jump 40–50% since Iran begin attack […]

todayMarch 18, 2026 13

obodo oyinbo

Trump Top Counterterrorism Oga Joe Kent Resign, Say Make US Stop Di War For Iran

By: Esther Ayoola President Donald Trump top counterterrorism senior man, Joe Kent, don resign over di war wey dey hapun for Iran. For im letter for X, e tuk say Iran no get "imminent threat" for US and so im nor understand di kind of war dem dey fight for Iran Meanwhile, White House say dem get strong proof say Iran bin dey plan attack US first. With im resignation, […]

todayMarch 18, 2026 12

National

IGP Olatunji Disu Visit Blast Victims, Tighten Security For Maiduguri

By: Esther Ayoola Inspector-General of Police, Olatunji Disu, don visit di victims of di recent bomb blast for Maiduguri wey dey hospital, come check di Monday Market bomb site. Im still waka go Borno State Gornment House and Police Command to see how security dey and plan beta joint action. IGP Disu tuk say im dey feel for di victims and dia family, and dat police go do everything to […]

todayMarch 18, 2026 32

National

VP Shettima Condemn Maiduguri Blast Wey Kpai 25, Pray For Di Families

By: Esther Ayoola Vice Presido, Kashim Shettima don mourn di 25 people wey kpai for di explosions wey happen for different areas for Maiduguri, Borno State on Monday. VP Shettima, tuk dis tuk on Tuesday during di closing of di Annual Ramadan for State House Mosque, Abuja, E sha pray make Almighty Allah give di dead pipo peaceful rest for Aljannah firdaus and give dia family strength to survive di […]

todayMarch 18, 2026 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds